Lucas 22

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Time kon rish for Bread (wey nor get yist) Feast, wey dem dey koll Passova.
1 Estava próxima a Festa dos Pães sem Fermento, chamada Páscoa.
2 Di priest oga dem and di law tishas dey fine how dem go take kill Jesus, but dem dey fear di pipol.
2 Os principais sacerdotes e os escribas procuravam uma forma de matar Jesus; porque temiam o povo.
3 So, Satan enter inside Judas Iskariot, one of Jesus twelf disciples.
3 Ora, Satanás entrou em Judas, chamado Iscariotes, que era um dos doze.
4 E kon go tell di offisa wey dey guide di temple sey e go sell Jesus give dem.
4 Judas foi entender-se com os principais sacerdotes e os capitães sobre como lhes entregaria Jesus.
5 Dem happy well-well kon promise am sey dem go gi-am money.
5 Eles se alegraram e combinaram em lhe dar dinheiro.
6 Judas gri and e kon bigin find sekret way to sell Jesus give dem, so dat pipol nor go know.
6 Judas concordou e buscava uma boa ocasião para lhes entregar Jesus, longe da multidão.
7 Di day for di Bread (wey nor get yist) Feast, wen dem dey kill sheep for sakrifice, kon rish.
7 Chegou o dia da Festa dos Pães sem Fermento, em que era necessário fazer o sacrifício do cordeiro pascal.
8 Jesus tell Pita and John, “Make una go prepare di Passova food wey wi go chop.”
8 Então Jesus enviou Pedro e João, dizendo:
9 Dem kon ask, “Na for where yu wont make wi prepare am?”
9 Eles lhe perguntaram: — Onde o senhor quer que a preparemos?
10 Jesus ansa dem, “Listin, wen una enter di town, una go meet one man wey karry wota pot, make una follow am enter di house wey e go enter,
10 Jesus lhes explicou:
11 make una tell di pesin wey get di house sey, Di Tisha sey make wi ask yu, ‘Where di room wey mi and my disciples go for chop di Passova food?’
11 e digam ao dono da casa: “O Mestre pergunta: ‘Onde fica o aposento no qual comerei a Páscoa com os meus discípulos?’”
12 E go show una one big room where tabol and chair dey for upstair. Make una prepare evritin for der.”
12 Ele lhes mostrará um espaçoso cenáculo mobiliado; ali façam os preparativos.
13 Wen dem go, dem kon si evritin as Jesus tell dem sey e go bi, so dem prepare di Passova food for der.
13 E, indo, acharam tudo como Jesus lhes tinha dito e prepararam a Páscoa.
14 Wen di time rish, Jesus sidan for where dem dey chop and en disciples kon join am.
14 Chegada a hora, Jesus se pôs à mesa, e os apóstolos estavam com ele.
15 Jesus tell dem, “I really won chop dis Passova food with una before I go sofa.
15 Então Jesus lhes disse:
16 Bikos I tell una, I nor go chop am again, until evritin don komplete for God Kingdom.”
16 Pois eu lhes digo que nunca mais a comerei, até que ela se cumpra no Reino de Deus.
17 Den Jesus take one cup wey get wine, afta e tank God, e kon sey, “Make una take dis cup and divide am among unasef.
17 E, pegando um cálice, depois de ter dado graças, disse:
18 Bikos I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine again, until God Kingdom go kom.”
18 Pois eu digo a vocês que, de agora em diante, não mais beberei do fruto da videira, até que venha o Reino de Deus.
19 Den Jesus take bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, “Na my body bi dis, wey God don give una. Make una dey always do dis tin to take remember mi.”
19 E, pegando um pão, tendo dado graças, o partiu e lhes deu, dizendo:
20 Like dat, Jesus still take di cup afta dem don chop finish kon sey, “Dis cup wey God give una, na di new agriment with my blood.”
20 Do mesmo modo, depois da ceia, pegou o cálice, dizendo:
21 “I wont make una know sey, di pesin wey go sell mi give my enemy dey chop with mi for dis tabol.
21 — Mas eis que a mão do traidor está comigo à mesa.
22 Bikos Man Pikin go die as God plan am, but curse dey for di pesin head wey go sell am!”
22 Pois o Filho do Homem vai segundo o que está determinado, mas ai daquele por quem ele está sendo traído!
23 So di disciples kon bigin ask each oda wish of dem go sell Jesus.
23 Então começaram a perguntar entre si qual deles seria o que estava para fazer isso.
24 Dem kon dey kworel among diasef sey wish of dem big pass.
24 Houve também entre eles uma discussão sobre qual deles parecia ser o maior.
25 So Jesus tell dem, “Gentile kings dey give dia pipol orda, yet di pipol still dey koll dem, ‘Pipol Friends.’
25 Mas Jesus lhes disse:
26 But una nor suppose to bi like dat; di pesin wey big among una, must do like sey naim small pass and di leader, go bi like savant.
26 Mas vocês não são assim; pelo contrário, o maior entre vocês seja como o menor; e aquele que dirige seja como o que serve.
27 Na who big pass? Na di pesin wey sidan for tabol dey chop or di pesin wey dey serve am? Nor bi di one wey sidan for tabol? But I dey do like savant among una.
27 Pois qual é maior: aquele que está à mesa ou aquele que serve? Não é verdade que é aquele que está à mesa? Pois, no meio de vocês, eu sou como quem serve.
28 Na una stay with mi wen I dey pass thru wahala.
28 Vocês são os que têm permanecido comigo nas minhas tentações.
29 So, I give una pawa to rule, just as my Papa don give mi.
29 E eu confio a vocês um reino, assim como o meu Pai confiou a mim,
30 For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.
30 para que comam e bebam à minha mesa no meu Reino; e vocês se assentarão em tronos para julgar as doze tribos de Israel.
31 “Simon! Simon! Make yu listin! God don allow Satan make e test all of una, so dat God go fit separate bad pipol from di good ones.
31 — Simão, Simão, eis que Satanás pediu para peneirar vocês como trigo!
32 But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”
32 Eu, porém, orei por você, para que a sua fé não desfaleça. E você, quando voltar para mim, fortaleça os seus irmãos.
33 Pita tell am, “Oga God, I dey ready to follow yu go prison and even die with yu.”
33 Porém Pedro respondeu: — Estou pronto para ir com o Senhor, tanto para a prisão como para a morte.
34 But Jesus sey, “Pita, make I tell yu di trut, fawol nor go do ‘Kukuruku’ dis nite until yu don tok three times sey yu nor know mi.”
34 Mas Jesus lhe disse:
35 Den Jesus tell dem, “Wen I send una go out, without money, bag or sandals, e get anytin wey una nid wey una nor get?”
35 A seguir, Jesus perguntou aos discípulos: Eles responderam: — Não faltou nada!
36 E kon tell dem, “But naw, pesin wey get money or traveling bag must karry am. And pesin wey nor get swod must sell en klot kon use di money by one.
36 Então Jesus lhes disse:
37 Bikos I tell una, wetin dem rite for God word about mi must happen sey, ‘Dem kount am join criminals.’ Bikos wetin God rite about mi dey happen naw.”
37 Pois eu lhes digo que é preciso que se cumpra em mim o que está escrito: “Ele foi contado com os malfeitores.” Pois o que a mim se refere está sendo cumprido.
38 Di disciples kon sey, “Oga God, si two swod for here.”
38 Então lhe disseram: — Senhor, aqui estão duas espadas! Jesus lhes respondeu:
39 Den Jesus komot, kon waka as e dey always do, go Mount Olives and en disciples follow am.
39 E, saindo, Jesus foi, como de costume, para o monte das Oliveiras; e os discípulos o acompanharam.
40 Wen dem rish der, Jesus kon tell dem, “Make una pray so dat una nor go fall enter temptashon.”
40 Chegando ao lugar escolhido, Jesus lhes disse:
41 Den e leave dem, waka go far small, kon knee down dey pray,
41 Ele, por sua vez, se afastou um pouco, e, de joelhos, orava,
42 “Papa, if yu like to do am, make yu let dis sofa cup pass mi. But make e bi as yu wont, nor bi as I wont am.”
42 dizendo:
43 One angel appear from heaven kon give Jesus pawa.
43 Então lhe apareceu um anjo do céu que o confortava.
44 Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
44 E, estando em agonia, orava mais intensamente. E aconteceu que o suor dele se tornou como gotas de sangue caindo sobre a terra.
45 Wen e pray finish, e go meet en disciples kon si sey dem dey sleep, bikos dem don taya well-well.
45 Levantando-se da oração, Jesus foi até onde os discípulos estavam, e os encontrou dormindo de tristeza.
46 So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”Jesus dey pray for Getsemani gardin|alt="Jesus praying at the garden of Getsemani" src="CN01808B.TIF" size="col" loc="LOOK 22:39-48" copy="Cook" ref="22:46"
46 E disse:
47 As Jesus still dey tok, at wons, some pipol waka kom and na Judas lead dem. E waka go meet Jesus kon kiss am for face.
47 Enquanto Jesus ainda falava, eis que chegou uma multidão. E um dos doze, que se chamava Judas, vinha à frente deles e se aproximou de Jesus para o beijar.
48 So Jesus ask am, “Judas, na kiss yu take sell Man Pikin?”
48 Jesus, porém, lhe disse:
49 Wen doz wey dey near Jesus si wetin won happen, dem ask am, “Oga God, make wi use awa swod?”
49 Os que estavam ao redor de Jesus, vendo o que estava por acontecer, perguntaram: — Senhor, devemos atacar com as espadas?
50 Den one among dem attack di priest savant kon kut en rite ear komot.
50 Um deles golpeou o servo do sumo sacerdote e cortou-lhe a orelha direita.
51 But Jesus shaut for am make e stop, den tosh di man ear kon heal am.
51 Mas Jesus interveio, dizendo: E, tocando na orelha do homem, o curou.
52 Den Jesus ask di priest oga dem, di ofisas wey dey guide di temple and di eldas wey kom meet am sey, “Una karry swod and wood like sey una dey kom arrest tif?
52 Então Jesus disse aos principais sacerdotes, capitães do templo e anciãos que vieram prendê-lo:
53 Since wen I dey with una for di temple una nor arrest mi. But na una time bi dis, di time wey darkness pawa go rule.”
53 Todos os dias, estando eu com vocês no templo, vocês não tentaram me prender. Esta, porém, é a hora de vocês e a hora do poder das trevas.
54 Den dem arrest Jesus, karry am go di High Priest house. But Pita dey follow dem for back-back.
54 Então, prendendo Jesus, levaram-no e o introduziram na casa do sumo sacerdote. Pedro seguia de longe.
55 Wen dem don make fire for di kompond centre kon sidan togeda, Pita sidan with di pipol too.
55 Quando acenderam um fogo no meio do pátio e se assentaram juntos, Pedro tomou lugar entre eles.
56 One savant girl si Pita sidan near di fire, e look am for eye kon sey, “Dis man bin dey with Jesus too o-o.”
56 Uma empregada, vendo-o sentado perto do fogo, fixou os olhos nele e disse: — Este também estava com ele.
57 But Pita sey, “Woman! Nor bi mi, I nor know am.”
57 Mas Pedro negou, dizendo: — Mulher, não o conheço.
58 Afta sometaim, anoda pesin si am kon sey, “Yu dey with dem, nor bi so?”
58 Pouco depois, outro homem, ao ver Pedro, disse: — Você também é um deles. Mas Pedro disse: — Homem, eu não sou um deles.
59 Wen one hour don pass, anoda pesin kon sey, “I sey dis man dey with dem, bikos en too kom from Galilee.”
59 E, tendo passado cerca de uma hora, outro afirmou, dizendo: — Com certeza este também estava com ele, porque também é galileu.
60 But Pita sey, “Oga God! I nor know wetin yu dey tok.” At wons, as e still dey tok, naim one fawol do, “Kukuruku!”
60 Mas Pedro insistiu: — Homem, não sei do que você está falando. E logo, enquanto Pedro ainda falava, o galo cantou.
61 Den Jesus turn look Pita for eye and Pita kon remember di word wey Jesus tell am, “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ dis nite, yu go don tok three times sey yu nor know mi.”
61 Então, o Senhor voltou-se e fixou os olhos em Pedro. E Pedro se lembrou da palavra do Senhor, como lhe tinha dito: “Hoje, antes que o galo cante, você me negará três vezes.”
62 Den Pita go outside, bigin kry.
62 E Pedro, saindo dali, chorou amargamente.
63 Di guards bigin laf Jesus kon dey beat am anyhow.
63 Os homens que detinham Jesus zombavam dele, davam-lhe pancadas e,
64 Dem tie en eye kon dey ask am, “Oya profesai! Na who nak yu so?”
64 colocando uma venda sobre os olhos dele, diziam: — Profetize! Quem foi que bateu em você?
65 Dem still curse am with difren words.
65 E muitas outras coisas diziam contra ele, blasfemando.
66 Wen morning rish, di eldas with di priest oga dem and di law tishas kon gada. Den dem take Jesus go dia kansol
66 Logo que amanheceu, reuniu-se a assembleia dos anciãos do povo, tanto os principais sacerdotes como os escribas, e o conduziram ao Sinédrio, onde lhe disseram:
67 kon tell am sey, “If yu know sey na yu bi Christ, make yu tell us.”
67 — Se você é o Cristo, diga-nos. Então Jesus lhes respondeu:
68 and if I ask una kweshon, una nor go gri ansa.
68 E, se eu perguntar, vocês não me darão resposta.
69 But from naw go, Man Pikin go sidan for God rite hand where pawa dey.”
69 Desde agora, o Filho do Homem estará sentado à direita do Deus Todo-Poderoso.
70 All of dem kon ask, “So, yu bi God Pikin?”
70 Todos perguntaram: — Então você é o Filho de Deus? Jesus respondeu:
71 Den dem kon sey, “Why wi nid anoda witness? E don tok evritin by ensef!”
71 Eles disseram: — Que necessidade ainda temos de testemunho? Porque nós mesmos ouvimos o que ele falou.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 22, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.