Lucas 19
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Jesus enter Jeriko kon waka go inside di town.
1 Jesus entrou em Jericó e ia atravessando a cidade.
2 For der, e get one man wey en name bi Zakius. E get money well-well, bikos e bi tax kollectors oga. E don tey wey e
2 Havia aí um homem muito rico chamado Zaqueu, chefe dos recebedores de impostos.
3 dey won si Jesus, but e nor fit si am, bikos e bi short man and pipol too plenty.
3 Ele procurava ver quem era Jesus, mas não o conseguia por causa da multidão, porque era de baixa estatura.
4 So e run go klimb one sikamore tree make e for fit si am, bikos Jesus go pass dat road.
4 Ele correu adiande, subiu a um sicômoro para o ver, quando ele passasse por ali.
5 Wen Jesus rish dat place, e look up kon sey, “Zakius, kom down kwik-kwik, bikos I must stay for yor house today.”
5 Chegando Jesus àquele lugar e levantando os olhos, viu-o e disse-lhe: Zaqueu, desce depressa, porque é preciso que eu fique hoje em tua casa.
6 So Zakius kom down kon welkom Jesus with happiness.
6 Ele desceu a toda a pressa e recebeu-o alegremente.
7 Wen di pipol si wetin happen, dem kon dey komplain dey sey, “Jesus don go visit dat man wey bi sina.”
7 Vendo isto, todos murmuravam e diziam: Ele vai hospedar-se em casa de um pecador...
8 But Zakius stop kon tell Jesus, “Oga God si, I go give half of wetin I get to poor pipol and evribody wey I don shit before, I go pay am back four times!”
8 Zaqueu, entretanto, de pé diante do Senhor, disse-lhe: Senhor, vou dar a metade dos meus bens aos pobres e, se tiver defraudado alguém, restituirei o quádruplo.
9 Den Jesus sey, “Salvashon don kom dis house today, bikos dis man na Abraham pikin too.
9 Disse-lhe Jesus: Hoje entrou a salvação nesta casa, porquanto também este é filho de Abraão.
10 Man Pikin kom find and save pipol wey lost before.”
10 Pois o Filho do Homem veio procurar e salvar o que estava perdido.
11 As Jesus dey waka near Jerusalem, e kon tell di pipol one parabol to show sey God Kingdom nor go just kom like dat.
11 Ouviam-no falar. E como estava perto de Jerusalém, alguns se persuadiam de que o Reino de Deus se havia de manifestar brevemente; ele acrescentou esta parábola:
12 Jesus kon sey, “One big man travel go one far kountry where dem for won make am king and afta, e kom back.
12 Um homem ilustre foi para um país distante, a fim de ser investido da realeza e depois regressar.
13 Before e go, e koll ten of en savant kon give each one money sey, ‘Make una take dis money trade and make profit till I kom back.’
13 Chamou dez dos seus servos e deu-lhes dez minas, dizendo-lhes: Negociai até eu voltar.
14 “But e own pipol nor like am, so dem kon send message follow am sey, ‘Wi nor wont dis man to bi awa king!’
14 Mas os homens daquela região odiavam-no e enviaram atrás dele embaixadores, para protestarem: Não queremos que ele reine sobre nós.
15 “Wen e kom back afta e don get di kingdom, e kon koll en savants wey e give money make e for know how mush dem don gain.
15 Quando, investido da dignidade real, voltou, mandou chamar os servos a quem confiara o dinheiro, a fim de saber quanto cada um tinha lucrado.
16 “So di first one stand for en front sey, ‘Oga God, I don gain ten koins join di ones wey yu give mi.’
16 Veio o primeiro: Senhor, a tua mina rendeu dez outras minas.
17 “Di oga kon tell am, ‘Yu do well, yu bi good savant! Bikos yu dey faithful with small tin, I go make yu oga ova ten towns.’
17 Ele lhe disse: Muito bem, servo bom; porque foste fiel nas coisas pequenas, receberás o governo de dez cidades.
18 “Den di sekond one sey, ‘Oga God, I don gain five koins join di ones wey yu give mi.’
18 Veio o segundo: Senhor, a tua mina rendeu cinco outras minas.
19 “So di oga tell am, ‘Yu go bi oga for five towns.’
19 Disse a este: Sê também tu governador de cinco cidades.
20 “Den anoda savant kon sey, ‘Oga God, si di money wey yu give mi. I keep am inside klot.
20 Veio também o outro: Senhor, aqui tens a tua mina, que guardei embrulhada num lenço;
21 Bikos I dey fear and know sey yu hash well-well. Yu dey chop food wey nor bi yor own and yu dey plok fruit wey yu nor plant!’
21 pois tive medo de ti, por seres homem rigoroso, que tiras o que não puseste e ceifas o que não semeaste.
22 “Di oga kon tell am, ‘Na yor word I go take judge yu, yu wiked savant! So yu know sey, I bi hash man; dey chop food wey nor bi my own and I dey plok fruit wey I nor plant?
22 Replicou-lhe ele: Servo mau, pelas tuas palavras te julgo. Sabias que sou rigoroso, que tiro o que não depositei e ceifo o que não semeei...
23 Den why yu nor put my money for bank, so dat wen I kom, I go kollect am with intrest wey go dey on-top?’
23 Por que, pois, não puseste o meu dinheiro num banco? Na minha volta, eu o teria retirado com juros.
24 “Den di oga tell di oda savants, ‘Make una take di money from am, gi-am to di savant wey get ten.’
24 E disse aos que estavam presentes: Tirai-lhe a mina, e dai-a ao que tem dez minas.
25 “Dem ansa, ‘Oga God, di man don already get ten!’
25 Replicaram-lhe: Senhor, este já tem dez minas!...
26 “Di oga kon sey, ‘I tell una, anybody wey get, God go gi-am more, but di pesin wey nor get, even di small one wey e get, God go take am from am.
26 Eu vos declaro: a todo aquele que tiver, dar-se-lhe-á; mas, ao que não tiver, ser-lhe-á tirado até o que tem.
27 But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”
27 Quanto aos que me odeiam, e que não me quiseram por rei, trazei-os e massacrai-os na minha presença.
28 Afta Jesus tok dis word, e kon go Jerusalem.
28 Depois destas palavras, Jesus os foi precedendo no caminho que sobe a Jerusalém.
29 Wen e rish Betpage and Betany, for di place wey dem dey koll Mount Olives, e kon send two of en disciples sey,
29 Chegando perto de Betfagé e de Betânia, junto do monte chamado das Oliveiras, Jesus enviou dois dos seus discípulos e disse-lhes:
30 “Make una go di village wey dey front. Wen una enter, una go si one small donkey wey nobody don sidan put before, wey dem tie for der. Make una luz am kom give mi.
30 Ide a essa aldeia que está defronte de vós. Entrando nela, achareis um jumentinho atado, em que nunca montou pessoa alguma; desprendei-o e trazei-mo.
31 If anybody ask una, ‘Why una dey luz am?’ Make una ansa, ‘Di oga nid am.’ ”
31 Se alguém vos perguntar por que o soltais, responder-lhe-eis assim: O Senhor precisa dele.
32 So di pipol wey dem send go, kon rish di place wey Jesus tell dem.
32 Partiram os dois discípulos e acharam tudo como Jesus tinha dito.
33 As dem dey luz di donkey, di owner kon ask dem, “Why una dey luz am?”
33 Quando desprendiam o jumentinho, perguntaram-lhes seus donos: Por que fazeis isto?
34 Dem ansa, “Di oga nid am.”
34 Eles responderam: O Senhor precisa dele.
35 Dem take di donkey kon put dia klot on-top am, den Jesus sidan put.
35 E trouxeram a Jesus o jumentinho, sobre o qual deitaram seus mantos e fizeram Jesus montar.
36 As Jesus dey ride dey go, pipol kon spread dia klot for road.
36 À sua passagem, muitas pessoas estendiam seus mantos no caminho.
37 As e dey enter di road wey go Mount Olives, all di disciples kon dey happy, dey praiz God with loud vois for all di mirakles wey dem si.
37 Quando já se ia aproximando da descida do monte das Oliveiras, toda a multidão dos discípulos, tomada de alegria, começou a louvar a Deus em altas vozes, por todas as maravilhas que tinha visto.
38 “God don bless di king wey dey kom with en name!
38 E dizia: Bendito o rei que vem em nome do Senhor! Paz no céu e glória no mais alto dos céus!
39 But some Farisee pipol wey dey among di pipol kon tell Jesus, “Tisha, make yu tell yor disciples make dem kwayet.”
39 Neste momento, alguns fariseus interpelaram a Jesus no meio da multidão: Mestre, repreende os teus discípulos.
40 Jesus ansa, “I tell una true word, if dem kwayet, even stones go start to dey shaut!”
40 Ele respondeu: Digo-vos: se estes se calarem, clamarão as pedras!
41 Wen Jesus near Jerusalem, e look di town kon dey kry,
41 Aproximando-se ainda mais, Jesus contemplou Jerusalém e chorou sobre ela, dizendo:
42 den e sey, “I wish sey una know wetin go give una peace today! But naw, God don hide am from una.
42 Oh! Se também tu, ao menos neste dia que te é dado, conhecesses o que te pode trazer a paz!... Mas não, isso está oculto aos teus olhos.
43 Time go kom wen una enemies go surround una for evry korna kon block una road.
43 Virão sobre ti dias em que os teus inimigos te cercarão de trincheiras, te sitiarão e te apertarão de todos os lados;
44 Dem go distroy una and una shidren and dem nor go leave one block on-top anoda, bikos di time wen God kom visit una, una nor know.”
44 destruir-te-ão a ti e a teus filhos que estiverem dentro de ti, e não deixarão em ti pedra sobre pedra, porque não conheceste o tempo em que foste visitada.
45 Jesus enter di temple kon drive all di pipol wey dey sell tins for der,
45 Em seguida, entrou no templo e começou a expulsar os mercadores.
46 e kon sey, “God word sey, ‘My house na prayer house’, but una don turn am to house where tif dey hide put!”
46 Disse ele: Está escrito: A minha casa é casa de oração! Mas vós a fizestes um covil de ladrões {Is 56,7; Jr 7,11}.
47 Jesus kon dey tish evriday for di temple. Di priest oga dem, di law tishas with di big leaders among di pipol kon dey find how dem go take kill Jesus.
47 Todos os dias ensinava no templo. Os príncipes dos sacerdotes, porém, os escribas e os chefes do povo procuravam tirar-lhe a vida.
48 But dem nor get any shance, bikos pipol dey listin to wetin Jesus dey tish.
48 Mas não sabiam como realizá-lo, porque todo o povo ficava suspenso de admiração, quando o ouvia falar.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.