João 15
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 “Na mi bi di korrect vine and na my Papa bi di gardina.
1 Eu sou a videira verdadeira, e meu Pai é o agricultor. Todo ramo que não der fruto em mim, ele o cortará;
2 E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit.
2 e podará todo o que der fruto, para que produza mais fruto.
3 Una dey klean already, bikos of di word wey I tell una.
3 Vós já estais puros pela palavra que vos tenho anunciado.
4 Make una dey inside mi, so dat I go dey inside una too. As di branches nor fit bear fruit with en own pawa unless e dey inside di vine, na so una nor go fit bear fruit, unless una dey inside mi.
4 Permanecei em mim e eu permanecerei em vós. O ramo não pode dar fruto por si mesmo, se não permanecer na videira. Assim também vós: não podeis tampouco dar fruto, se não permanecerdes em mim.
5 “Na mi bi di vine and na una bi di branches dem. Di pesin wey stay inside mi and I stay inside am, go bear plenty fruit, bikos without mi, una nor go fit do anytin.
5 Eu sou a videira; vós, os ramos. Quem permanecer em mim e eu nele, esse dá muito fruto; porque sem mim nada podeis fazer.
6 Anybody wey nor stay inside mi, go dry and pipol go gada en branches dem, trow and burn dem inside fire.
6 Se alguém não permanecer em mim será lançado fora, como o ramo. Ele secará e hão de ajuntá-lo e lançá-lo ao fogo, e queimar-se-á.
7 If una stay inside mi and my word dey inside una, anytin wey una ask, I go do am for una.
7 Se permanecerdes em mim, e as minhas palavras permanecerem em vós, pedireis tudo o que quiserdes e vos será feito.
8 My Papa go get big honor if una bear plenty fruit, wey go show sey una bi my disciples.
8 Nisto é glorificado meu Pai, para que deis muito fruto e vos torneis meus discípulos.
9 “As my Papa love mi, na so I love una too, so make una live di kind life wey go let mi fit love una more-more.
9 Como o Pai me ama, assim também eu vos amo. Perseverai no meu amor.
10 If una do wetin I tok, I go love una, just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi.
10 Se guardardes os meus mandamentos, sereis constantes no meu amor, como também eu guardei os mandamentos de meu Pai e persisto no seu amor.
11 I don tell una all dis tins, so dat my joy go dey inside una and una joy go full well-well.
11 Disse-vos essas coisas para que a minha alegria esteja em vós, e a vossa alegria seja completa.
12 Dis na di kommand wey I give una sey, ‘Make una love each oda di way I love una.’
12 Este é o meu mandamento: amai-vos uns aos outros, como eu vos amo.
13 E nor get love wey big rish di one wey make pesin die for en friend.
13 Ninguém tem maior amor do que aquele que dá a sua vida por seus amigos.
14 Una go bi my friend if una do wetin I tok.
14 Vós sois meus amigos, se fazeis o que vos mando.
15 I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.
15 Já não vos chamo servos, porque o servo não sabe o que faz seu senhor. Mas chamei-vos amigos, pois vos dei a conhecer tudo quanto ouvi de meu Pai.
16 Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
16 Não fostes vós que me escolhestes, mas eu vos escolhi e vos constituí para que vades e produzais fruto, e o vosso fruto permaneça. Eu assim vos constituí, a fim de que tudo quanto pedirdes ao Pai em meu nome, ele vos conceda.
17 Wetin I dey tell una bi sey, ‘Make una love each oda.’ ”
17 O que vos mando é que vos ameis uns aos outros.
18 “If pipol for dis world hate una, make una remember sey na mi dem first hate.
18 Se o mundo vos odeia, sabei que me odiou a mim antes que a vós.
19 If una bi friend with di pipol for dis world, dem go love una as dia own pipol. But una nor bi dia friend, bikos I don choose una from di world, naim make dem nor like una.
19 Se fôsseis do mundo, o mundo vos amaria como sendo seus. Como, porém, não sois do mundo, mas do mundo vos escolhi, por isso o mundo vos odeia.
20 Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too.
20 Lembrai-vos da palavra que vos disse: O servo não é maior do que o seu senhor. Se me perseguiram, também vos hão de perseguir. Se guardaram a minha palavra, hão de guardar também a vossa.
21 Since dem nor know di Pesin wey send mi kom, dem go do all dis tins to una bikos of my name.
21 Mas vos farão tudo isso por causa do meu nome, porque não conhecem aquele que me enviou.
22 If to sey I nor kom tok to dem, dem for nor dey guilty for dia sin. But naw, dem nor get any eskuse for dia sin.
22 Se eu não viesse e não lhes tivesse falado, não teriam pecado; mas agora não há desculpa para o seu pecado.
23 Di pesin wey hate mi, hate my Papa too.
23 Aquele que me odeia, odeia também a meu Pai.
24 If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.
24 Se eu não tivesse feito entre eles obras, como nenhum outro fez, não teriam pecado; mas agora as viram e odiaram a mim e a meu Pai.
25 All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’
25 Mas foi para que se cumpra a palavra que está escrita na sua lei: Odiaram-me sem motivo {Sl 34,19; 68,5}.
26 “But wen di true Spirit wey I go send from my Papa to help una don kom, e go tok about mi.
26 Quando vier o Paráclito, que vos enviarei da parte do Pai, o Espírito da Verdade, que procede do Pai, ele dará testemunho de mim.
27 And unasef go tok about mi, bikos una dey with mi from di biginnin.”
27 Também vós dareis testemunho, porque estais comigo desde o princípio
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.