João 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Six days before Passova Feast rish, Jesus go Betany, where Lazarus, di pesin wey e wake-up from deat, dey stay.
1 Seis dias antes da Páscoa , Jesus foi ao povoado de Betânia, onde morava Lázaro, a quem ele tinha ressuscitado.
2 So dem kon do party for Jesus dat evening. Marta kon dey serve dem food and Lazarus dey among di pipol wey sidan for tabol with Jesus.
2 Prepararam ali um jantar para Jesus. Marta ajudava a servir, e Lázaro era um dos que estavam à mesa com ele.
3 Mary take perfume wey dear well-well, wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg. Den e use en hair take klean dem. (Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).
3 Então Maria pegou um frasco cheio de um perfume muito caro, feito de nardo puro. Ela derramou o perfume nos pés de Jesus e os enxugou com os seus cabelos; e toda a casa ficou perfumada.
4 But Judas Iskariot, one among Jesus disciple (di pesin wey go sell am give en enemies) kon sey,
4 Mas Judas Iscariotes, o discípulo que ia trair Jesus, disse:
5 “Why wi nor sell dis perfume for three hundred koins (money wey pass wetin workers go get for one year) kon give di money to poor pipol?”
5 — Este perfume vale mais de trezentas moedas de prata . Por que não foi vendido, e o dinheiro, dado aos pobres?
6 (Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)
6 Judas disse isso, não porque tivesse pena dos pobres, mas porque era ladrão. Ele tomava conta da bolsa de dinheiro e costumava tirar do que punham nela.
7 Den Jesus ansa, “Make yu nor trobol di woman, e do dis tin dey wait di day wen dem go beri mi.
7 Então Jesus respondeu:
8 Poor pipol go always dey with una, but I nor go dey with una all di time.”
8 Os pobres estarão sempre com vocês, mas eu não estarei sempre com vocês.
9 For dis time, plenty pipol wey dey Judea hear sey Jesus dey for dia town, so dem kon gada, nor bi bikos of Jesus alone, but dem won si Lazarus too, di pesin wey die before, wey Jesus wake-up.
9 Muitas pessoas ficaram sabendo que Jesus estava em Betânia. Então foram até lá não só por causa dele, mas também para ver Lázaro, o homem que Jesus tinha ressuscitado.
10 Di priest oga dem kon plan to kill Lazarus too,
10 Então os chefes dos sacerdotes resolveram matar Lázaro também;
11 bikos naim make plenty Jew pipol for Jerusalem, bilive Jesus.
11 pois, por causa dele, muitos judeus estavam abandonando os seus líderes e crendo em Jesus.
12 Wen day break, plenty pipol wey kom di Feast kon hear sey Jesus dey kom Jerusalem.
12 No dia seguinte, a grande multidão que tinha ido à Festa da Páscoa ouviu dizer que Jesus estava chegando a Jerusalém.
13 Di pipol take palm tree leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut,
13 Então eles pegaram ramos de palmeiras e saíram para se encontrar com ele, gritando: — Que Deus abençoe aquele que vem em nome do Senhor! Que Deus abençoe o Rei de Israel!
14 Jesus si one small donkey and e kon sidan put, just as God word sey,
14 Jesus procurou um jumentinho e o montou, como dizem as Escrituras Sagradas :
15 “Pipol wey dey Zion,
15 “Povo de Jerusalém, não tenha medo! Veja! Aí vem o seu Rei, montado num jumentinho!”
16 (En disciples nor undastand dis tins wey dey happen, until wen Jesus don wake-up from grave, naim dem kon remember wetin God word sey go happen.)
16 Naquela ocasião os discípulos não entenderam isso. Mas, depois de Jesus ter voltado para a presença gloriosa de Deus, eles lembraram que isso estava escrito a respeito dele e também que era isso o que tinha acontecido.
17 So di pipol wey dey with am wen e wake Lazarus from grave kon tell odas about am.
17 A multidão que estava com Jesus quando ele havia chamado Lázaro para fora do túmulo e o tinha ressuscitado espalhou a notícia do que tinha acontecido.
18 And dem gada go meet Jesus, bikos dem hear sey na-im wake Lazarus from grave.
18 E o povo foi encontrar-se com Jesus, pois ficou sabendo que ele tinha feito esse milagre.
19 Den di Farisee pipol kon tell each oda, “Una dey si sey wetin wi dey do so nor get head! Si o-o, evribody don bigin follow am.”
19 Então os fariseus disseram uns aos outros: — Não estamos conseguindo nada! Vejam! Todos estão indo com ele!
20 Some Greek pipol go woship God for di feast for Jerusalem.
20 Entre o povo que tinha ido a Jerusalém para tomar parte na festa, estavam alguns não judeus.
21 Dem meet Filip wey kom from Betsaida for Galilee kon tell am, “Oga God, wi go like to si Jesus.”
21 Eles foram falar com Filipe, que era da cidade de Betsaida, na Galileia, e pediram: — Senhor, queremos ver Jesus.
22 Filip tell Andru, den dem kon go tell Jesus.
22 Filipe foi dizer isso a André, e os dois foram falar com Jesus.
23 Jesus tell dem, “Di time don kom wen God go honor en own pikin.
23 Então ele respondeu:
24 I tell una true word, if one korn seed fall for groun and e nor die, e nor go grow, but if e die, e go grow kon bear plenty seed.
24 Eu afirmo a vocês que isto é verdade: se um grão de trigo não for jogado na terra e não morrer, ele continuará a ser apenas um grão. Mas, se morrer, dará muito trigo.
25 Anybody wey love en life for dis world, go luz am, but di pesin wey nor love en life for dis world, go get life wey nor dey end.
25 Quem ama a sua vida não terá a vida verdadeira; mas quem não se apega à sua vida, neste mundo, ganhará para sempre a vida verdadeira.
26 Anybody wey ready to serve mi, go must follow mi and where I dey, na der my savant go dey too. Anybody wey serve mi, my Papa go honor am.
26 Quem quiser me servir siga-me; e, onde eu estiver, ali também estará esse meu
27 “My heart heavy well-well. Wetin I go tok? ‘Papa, make yu save mi from dis tin wey won happen’? No! Na dis tin make mi kom dis world.
27 Jesus continuou:
28 Papa, make yu honor yor name.”
28 Pai, revela a tua presença Então do céu veio uma voz, que dizia: — Eu já a revelei e a revelarei de novo.
29 Wen di pipol wey dey di place hear di vois, some kon sey, “Di vois sound like tonda”, but odas sey, “Na angel dey tok to am.”
29 A multidão que estava ali ouviu a voz e dizia que era um trovão. Outros afirmavam que um anjo tinha falado com Jesus.
30 Jesus kon sey, “Dis vois nor tok bikos of mi, but na bikos of una.
30 Mas ele disse:
31 Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan, wey dey kontrol dis world komot.
31 Chegou a hora de este mundo ser julgado, e aquele que manda nele será expulso.
32 But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.”
32 E, quando eu for levantado da terra, atrairei todas as pessoas para mim.
33 (E tok like dis, make pipol for know di way e go take die).
33 Ele dizia isso para indicar de que maneira ia morrer.
34 Den di pipol ask, “Wi know sey God law sey, ‘Christ go live forever.’ Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross? Na who bi dis Man Pikin sef?”
34 A multidão perguntou: — A nossa
35 Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.
35 Jesus respondeu:
36 As una get di lite naw, make una bilive am, so dat una go bi lite shidren.” Wen Jesus don tok dis tin finish, e kon komot der go hide.
36 Enquanto vocês têm a luz, creiam na luz para que possam viver na luz. Depois que Jesus disse isso, foi embora e se escondeu do povo.
37 Aldo Jesus don do many mirakle for dia front, dem nor still bilive am.
37 Eles tinham visto Jesus fazer todos esses milagres, mas não criam nele,
38 Dis make wetin Profet Isaya tok happen, wen e sey,
38 para que se cumprisse o que disse o profeta Isaías: “Senhor, quem creu na nossa mensagem? E quem viu que era o Senhor que estava agindo?”
39 As di pipol nor fit bilive, naim make Profet Isaya tok anoda word sey,
39 Não podiam crer porque, como disse Isaías:
40 “God don blind dia eye
40 “Deus cegou os olhos deles e fechou a mente deles, para que não vejam, e não entendam, e não se voltem para ele, e sejam curados por ele.”
41 Profet Isaya tok dis tins, bikos e si how God honor and tok about Christ.
41 Isaías disse isso porque viu a revelação da natureza divina de Jesus e falou a respeito dele.
42 Many pipol and many Jew oga kon bilive Jesus, but bikos of di Farisee pipol, doz wey bilive nor fit tok for publik about Jesus Christ, so dat dem nor go drive dem komot for di sinagog.
42 No entanto, muitos líderes judeus creram em Jesus, mas não falavam publicamente a favor dele para que os fariseus não os expulsassem da sinagoga .
43 Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.
43 Eles gostavam mais de ser elogiados pelas pessoas do que de ser elogiados por Deus.
44 Jesus kon shaut sey, “Di pesin wey bilive mi, nor bi mi e bilive, but na my Papa wey send mi.
44 Jesus disse bem alto:
45 And di pesin wey si mi, don si God wey send mi.
45 Quem me vê vê também aquele que me enviou.
46 I kom as lite for dis world, so dat anybody wey go bilive mi nor go waka inside darkness.
46 Eu vim ao mundo como luz para que quem crê em mim não fique na escuridão.
47 “Anybody wey hear wetin I tok and nor obey am, nor bi mi go judge am, bikos I nor kom judge di world, but I kom save pipol for di world.
47 Se alguém ouvir a minha mensagem e não a praticar, eu não o julgo. Pois eu vim para salvar o mundo e não para julgá-lo.
48 Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day.
48 Quem me rejeita e não aceita a minha mensagem já tem quem vai julgá-lo. As palavras que eu tenho dito serão o juiz dessa pessoa no último dia.
49 Bikos nor bi my pawa I take dey tok, but na my Papa wey send mi dey tell mi wetin I dey tok.
49 — Eu não tenho falado em meu próprio nome, mas o Pai, que me enviou, é quem me ordena o que devo dizer e anunciar.
50 I know sey anytin wey God kommand, dey give life wey nor dey end, so I dey tok wetin E send mi.”
50 E eu sei que o seu mandamento dá a vida eterna. O que eu digo é justamente aquilo que o Pai me mandou dizer.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.