João 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 E get one man, en name na Lazarus and e nor well. En with Mary and Marta, en sistas kom from Betany.
1 Um homem chamado Lázaro estava doente. Ele era de Betânia, da aldeia de Maria e de sua irmã Marta.
2 Na dis Mary pour perfume for Jesus leg, kon klean dem with en hair.
2 Esta Maria, cujo irmão Lázaro estava doente, era a mesma que ungiu o Senhor com perfume e lhe enxugou os pés com os seus cabelos.
3 So di sistas kon send message go meet Jesus sey, Oga God, yor friend wey yu love well-well nor well.
3 Por isso, as irmãs de Lázaro mandaram dizer a Jesus: — Aquele que o Senhor ama está doente.
4 Wen Jesus hear di message, e kon sey, “Dis sickness nor go kill Lazarus. E go make God and en pikin get honor.”
4 Ao receber a notícia, Jesus disse:
5 (E klear sey Jesus love Marta, Mary and Lazarus well-well.)
5 Ora, Jesus amava Marta e a irmã dela, e também Lázaro.
6 Afta e hear sey Lazarus nor well, e stay where e dey for anoda two days.
6 Quando soube que Lázaro estava doente, ainda se demorou dois dias no lugar onde estava.
7 Den e kon tell en disciples, “Make wi go back to Judea.”
7 Depois, disse aos seus discípulos:
8 But en disciples ask am, “Tisha, nor bi di place where di Jew pipol won for kill us yu sey make wi go again so?”
8 Os discípulos disseram: — Mestre, ainda há pouco os judeus queriam apedrejá-lo! E o senhor quer voltar para lá?
9 Jesus ansa, “Evriday get twelf hours wey lite dey take shine, so pipol nor dey fear to waka, bikos dem dey si well-well, as e bi sey lite dey.
9 Jesus respondeu:
10 But pesin wey waka for nite, go fit fall, bikos e nor get lite to si road.”
10 Mas, se andar de noite, tropeça, porque nele não há luz.
11 Den Jesus tell dem, “Awa friend Lazarus dey sleep, but I won go wake am up.”
11 Tendo dito isso, acrescentou:
12 Di disciples sey, “Oga God, if e just dey sleep, den e go wake-up.”
12 Então os discípulos disseram: — Senhor, se dorme, estará salvo.
13 (Dem tink sey, wetin Jesus mean bi sey, Lazarus just dey sleep, but wetin e mean bi sey, Lazarus don die.)
13 Jesus falava da morte de Lázaro, mas eles pensavam que tivesse falado do repouso do sono.
14 So e tell dem sey, “Lazarus don die.
14 Então Jesus lhes disse claramente:
15 I happy sey I nor dey der, so dat una go get anoda shance to bilive mi. Make una kom make wi go si am.”
15 Por causa de vocês me alegro de que não estivesse lá, para que vocês possam crer. Mas vamos até ele.
16 So Tomas, (wey bi Twins) kon tell di oda disciple, “Make wi follow am go, so dat wi go die with am.”
16 Então Tomé, chamado Dídimo, disse aos outros discípulos: — Vamos também nós para morrer com o Mestre!
17 Wen Jesus rish Betany, dem kon tell am sey e don rish for days wey dem beri Lazarus.
17 Quando Jesus chegou, encontrou Lázaro já sepultado havia quatro dias.
18 (Betany na about two mile from Jerusalem,
18 Ora, Betânia ficava a mais ou menos três quilômetros de Jerusalém.
19 and from der, many Jew pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.)
19 Muitos dos judeus vieram visitar Marta e Maria, a fim de consolá-las por causa do irmão.
20 So wen Marta hear sey Jesus dey kom, e kon waka go meet am, but Mary sidan for house.
20 Marta, quando soube que Jesus estava chegando, foi encontrar-se com ele; Maria, porém, ficou sentada em casa.
21 Marta tell Jesus, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.
21 Então Marta disse a Jesus: — Se o Senhor estivesse aqui, o meu irmão não teria morrido.
22 But I know sey, God go give yu anytin wey yu ask am.”
22 Mas também sei que, mesmo agora, tudo o que o senhor pedir a Deus, ele concederá.
23 So Jesus tell am, “Yor broda go wake-up again.”
23 Jesus disse a ela:
24 Den Marta sey, “I know sey e go wake-up again for di resureshon day.”
24 Ao que Marta respondeu: — Eu sei que ele há de ressurgir na ressurreição, no último dia.
25 Jesus ansa am, “Na mi bi di resureshon and na mi dey give life. Anybody wey bilive mi go get life even if e don die
25 Então Jesus declarou:
26 and di pesin wey bilive mi for dis life, nor go ever die. Marta, yu bilive wetin I tok so?”
26 E todo o que vive e crê em mim não morrerá eternamente. Você crê nisto?
27 Marta kon ansa, “Yes! Oga God, I bilive sey yu bi Christ, God Pikin, wey kom dis world.”
27 Marta respondeu: — Sim, Senhor! Eu creio que o senhor é o Cristo, o Filho de Deus que devia vir ao mundo.
28 Den Marta go meet Mary, en sista kon tok for en ear sey, “Di tisha dey here and e won si yu.”
28 Depois de dizer isto, Marta foi chamar Maria, a sua irmã, e lhe disse em particular: — O Mestre chegou e está chamando você.
29 Wen Mary hear wetin e tok, e kon get up go meet Jesus.
29 Quando Maria ouviu isso, levantou-se depressa e foi até ele,
30 Jesus still dey outside di village wen Marta go meet am.
30 pois Jesus ainda não tinha entrado na aldeia, mas permanecia onde Marta o havia encontrado.
31 Wen di pipol wey kom salot Mary si as e waka komot kwik-kwik, dem kon tink sey na Lazarus grave e for dey go kry, so dem follow am.
31 Os judeus que estavam com Maria em casa e a consolavam, vendo-a levantar-se depressa e sair, seguiram-na, pensando que ela ia ao túmulo para chorar.
32 Wen Mary si Jesus, e fall for en front kon sey, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.”
32 Quando Maria chegou ao lugar onde Jesus estava, ao vê-lo, lançou-se aos seus pés, dizendo: — Se o Senhor estivesse aqui, o meu irmão não teria morrido.
33 Jesus kon si as Mary and di oda pipol dey kry. So e sorry for dem and di tin pain am well-well.
33 Quando Jesus viu que ela chorava, e que os judeus que a acompanhavam também choravam, agitou-se no espírito e se comoveu.
34 E kon ask dem, “Where una beri am put?”
34 E perguntou: Eles responderam: — Senhor, venha ver!
35 Jesus kon kry.
35 Jesus chorou.
36 Di pipol wey kom salot dem kon sey, “Jesus love dis man well-well o-o.”
36 Então os judeus disseram: — Vejam o quanto ele o amava.
37 But some among dem sey, “Dis man wey make blind man si, e nor fit do make Lazarus nor die?”
37 Mas alguns disseram: — Será que ele, que abriu os olhos ao cego, não podia fazer com que Lázaro não morresse?
38 Jesus sorry for dem again, den e waka go di grave. (Dis grave na big whole inside rock wey dem take big stone kover).
38 Jesus, agitando-se novamente em si mesmo, foi até o túmulo, que era uma gruta em cuja entrada tinham colocado uma pedra.
39 Jesus kon sey, “Make una remove di stone.”
39 Então Jesus ordenou: Marta, irmã do falecido, disse a Jesus: — Senhor, já cheira mal, porque está morto há quatro dias.
40 Jesus tell am, “I nor tell yu before sey, ‘Yu go si God pawa, if yu bilive mi?’ ”
40 Jesus respondeu:
41 So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu.
41 Então tiraram a pedra. E Jesus, levantando os olhos para o céu, disse:
42 I know sey Yu dey always hear mi, but I dey tok like dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go bilive sey na Yu send mi.”
42 Eu sei que sempre me ouves, mas falei isso por causa da multidão presente, para que creiam que tu me enviaste.
43 Wen e don tok dis finish, e kon shaut, “Lazarus, kom out!”
43 E, depois de dizer isso, clamou em alta voz:
44 Den Lazarus kom out, but di klot wey dem take beri am still kover en body.
44 Aquele que tinha morrido saiu, tendo os pés e as mãos amarrados com ataduras e o rosto envolto num lenço. Então Jesus lhes ordenou:
45 Den many pipol among di Jew pipol wey follow Mary go di grave bilive Jesus, wen dem si wetin happen.
45 Muitos dos judeus que tinham vindo visitar Maria, vendo o que Jesus havia feito, creram nele.
46 But some among dem go meet di Farisee pipol kon tell dem wetin Jesus do.
46 Outros, porém, foram até os fariseus e lhes contaram o que Jesus havia feito.
47 Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles?
47 Então os principais sacerdotes e os fariseus convocaram o Sinédrio e disseram: — O que estamos fazendo, uma vez que este homem opera muitos sinais?
48 If wi let am kontinue like dis, evribody go bilive am and di Roman govnor go kom take di place wey wi dey woship and awa kountry.”
48 Se o deixarmos assim, todos crerão nele; depois, virão os romanos e tomarão não só o nosso lugar, mas a própria nação.
49 Den won among dem wey en name bi Kaiafas, wey bi di High Priest dat year kon sey, “Una bi fool wey nor undastand wetin dey happen.
49 Mas um deles, Caifás, que era sumo sacerdote naquele ano, advertiu-os, dizendo: — Vocês não sabem nada,
50 Una nor know sey e betta make one man die for evribody, dan sey make evribody for dis kountry die?”
50 nem entendem que é melhor para vocês que morra um só homem pelo povo e que não venha a perecer toda a nação.
51 (Dis man tok like dis, bikos naim bi di High Priest dat year. E tok true sey, Jesus go die for di whole Jew pipol, but e nor know wetin e tok,
51 Ora, Caifás não disse isto por conta própria, mas, sendo sumo sacerdote naquele ano, profetizou que Jesus estava para morrer pela nação.
52 and nor bi for only di Jew pipol, but make all God shidren, wey dey di world for gada togeda.)
52 E não somente pela nação, mas também para reunir em um só corpo os filhos de Deus, que andam dispersos.
53 So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus.
53 Desde aquele dia, resolveram matar Jesus.
54 Bikos of dis, Jesus nor kon dey waka for Judea as e dey do before, but en and en disciples kon go stay for di town wey dem dey koll Efraim, wey near wildaness.
54 Assim sendo, Jesus já não andava publicamente entre os judeus, mas retirou-se para uma região vizinha ao deserto, para uma cidade chamada Efraim, onde permaneceu com os discípulos.
55 Wen Passova Feast don near, many pipol for di kountry go Jerusalem, kon dey make demsef klean for di feast, as dia tradishon tok.
55 Estava próxima a Páscoa dos judeus, e muitos daquela região foram a Jerusalém antes da Páscoa para se purificar.
56 Dem bigin dey look for Jesus kon dey ask each oda inside di temple yard, “Wetin yu tink, e go kom for di feast?” Abi yu nor tink so?
56 Lá, procuravam Jesus e, estando eles no templo, diziam uns aos outros: — O que vocês acham? Ele não virá à festa?
57 (By dis time, di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey, anybody wey know where Jesus dey, make e kon tok, so dat dem go-go katch am).
57 Ora, os principais sacerdotes e os fariseus haviam ordenado que, se alguém soubesse onde ele estava, o denunciasse, para que pudessem prendê-lo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.