Gênesis 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.
1 No princípio, criou Deus os céus e a terra.
2 Di eart nor get shape at-all. E dey empty and darkness kover di wota, but God Spirit dey waka on-top di wota.
2 E a terra era sem forma e vazia; e havia trevas sobre a face do abismo; e o Espírito de Deus se movia sobre a face das águas.
3 So God kon sey, “Make lite kom.” And lite kon kom!
3 E disse Deus: Haja luz. E houve luz.
4 God si sey di lite dey good, so E kon separate di lite from di darkness.
4 E viu Deus que era boa a luz; e fez Deus separação entre a luz e as trevas.
5 God koll di lite, “Day” and di darkness, E koll am, “Nite.” And dat evening and morning kon make am di first day.
5 E Deus chamou à luz Dia; e às trevas chamou Noite. E foi a tarde e a manhã: o dia primeiro.
6 God sey, “Make di wota divide into two, so dat space go dey di middle.”
6 E disse Deus: Haja uma expansão no meio das águas, e haja separação entre águas e águas.
7 So God separate di wota wey dey under di space from di wota wey dey on-top di space. And na so e kon bi.
7 E fez Deus a expansão e fez separação entre as águas que estavam debaixo da expansão e as águas que estavam sobre a expansão. E assim foi.
8 God koll di space, “Sky.” And dat evening and morning kon make am di sekond day.
8 E chamou Deus à expansão Céus; e foi a tarde e a manhã: o dia segundo.
9 God sey, “Make di wota wey dey under di sky gada for one place and make dry groun kom out.” And na so e kon bi.
9 E disse Deus: Ajuntem-se as águas debaixo dos céus num lugar; e apareça a porção seca. E assim foi.
10 God kon koll di dry groun, “Land” and di wota wey gada, E koll am, “Sea.” God si sey e dey good.
10 E chamou Deus à porção seca Terra; e ao ajuntamento das águas chamou Mares. E viu Deus que era bom.
11 God kon sey, “Make di land produce difren plants: plants wey go bear seeds akordin to how dem bi and trees wey go bear fruit akordin to how dem bi.” And na so e kon bi.
11 E disse Deus: Produza a terra erva verde, erva que dê semente, árvore frutífera que dê fruto segundo a sua espécie, cuja semente esteja nela sobre a terra. E assim foi.
12 Di land produce difren plants; di ones wey dey bear seeds and fruits, akordin to dia kind. God kon si sey e dey good.
12 E a terra produziu erva, erva dando semente conforme a sua espécie e árvore frutífera, cuja semente está nela conforme a sua espécie. E viu Deus que era bom.
13 So dat evening and morning kon make am di third day.
13 E foi a tarde e a manhã: o dia terceiro.
14 God sey, “Make lite dey for di sky wey go separate di day from di nite and make sign dey wey go show sizin, days, years
14 E disse Deus: Haja luminares na expansão dos céus, para haver separação entre o dia e a noite; e sejam eles para sinais e para tempos determinados e para dias e anos.
15 and make dem bi lite for di sky wey go give lite to di eart.” And na so e kon bi.
15 E sejam para luminares na expansão dos céus, para alumiar a terra. E assim foi.
16 God make two big lite: di one wey big pass go shine for day time and di small one go shine for nite. God make di stars too.
16 E fez Deus os dois grandes luminares: o luminar maior para governar o dia, e o luminar menor para governar a noite; e fez as estrelas.
17 God put di lite for di sky, so dat e go dey shine for di eart
17 E Deus os pôs na expansão dos céus para alumiar a terra,
18 and dem go dey rule both for day and nite. Dem go separate lite from darkness. So God si sey evritin dey good.
18 e para governar o dia e a noite, e para fazer separação entre a luz e as trevas. E viu Deus que era bom.
19 And dat evening and morning kon make am di fourt day.
19 E foi a tarde e a manhã: o dia quarto.
20 Den God kon sey, “Make difren animals wey get life full di wota and make birds full di sky.”
20 E disse Deus: Produzam as águas abundantemente répteis de alma vivente; e voem as aves sobre a face da expansão dos céus.
21 God kreate di big-big fish for sea and evry oda tin wey dey stay inside wota and difren-difren birds. God si sey dem dey good.
21 E Deus criou as grandes baleias, e todo réptil de alma vivente que as águas abundantemente produziram conforme as suas espécies, e toda ave de asas conforme a sua espécie. E viu Deus que era bom.
22 God bless dem kon sey, “Make una stay di wota kon born many shidren and make di birds born many pikin full di sky.”
22 E Deus os abençoou, dizendo: Frutificai, e multiplicai-vos, e enchei as águas nos mares; e as aves se multipliquem na terra.
23 So dat evening and morning kon make am di fift day.
23 E foi a tarde e a manhã: o dia quinto.
24 Den God sey, “Make di land produce difren animals akordin to dia kind: kattle, tins wey dey creep for groun and wild animals akordin to dia kind.” And na so e kon bi.
24 E disse Deus: Produza a terra alma vivente conforme a sua espécie; gado, e répteis, e bestas-feras da terra conforme a sua espécie. E assim foi.
25 God make wild animals, kattle and evritin wey dey creep for groun akordin to dia kind. God kon si sey dem dey good.
25 E fez Deus as bestas-feras da terra conforme a sua espécie, e o gado conforme a sua espécie, e todo o réptil da terra conforme a sua espécie. E viu Deus que era bom.
26 Den God sey, “Make wi kreate human being like Awasef, just as wi bi, so dat dem go bi oga ova di fish dem for sea and di birds for di sky, plus di kattles and ova di whole eart plus evritin wey dey inside.”
26 E disse Deus: Façamos o homem à nossa imagem, conforme a nossa semelhança; e domine sobre os peixes do mar, e sobre as aves dos céus, e sobre o gado, e sobre toda a terra, e sobre todo réptil que se move sobre a terra.
27 So God kon kreate human being like ensef;
27 E criou Deus o homem à sua imagem; à imagem de Deus o criou; macho e fêmea os criou.
28 God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”
28 E Deus os abençoou e Deus lhes disse: Frutificai, e multiplicai-vos, e enchei a terra, e sujeitai-a; e dominai sobre os peixes do mar, e sobre as aves dos céus, e sobre todo o animal que se move sobre a terra.
29 Den God sey, “Evry plant wey dey bear seed and tree wey dey bear fruit, I give dem to una as food.
29 E disse Deus: Eis que vos tenho dado toda erva que dá semente e que está sobre a face de toda a terra e toda árvore em que há fruto de árvore que dá semente; ser-vos-ão para mantimento.
30 Plus all di animals for di eart; birds for di sky and evritin wey dey waka for groun. Evritin wey dey alive and evry green plant, I gi-am to una as food.” And na so e kon bi.
30 E a todo animal da terra, e a toda ave dos céus, e a todo réptil da terra, em que há alma vivente, toda a erva verde lhes será para mantimento. E assim foi.
31 So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.
31 E viu Deus tudo quanto tinha feito, e eis que era muito bom; e foi a tarde e a manhã: o dia sexto.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.