Gálatas 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.
1 Irmãos, se alguém for surpreendido em algum pecado, vocês, que são espirituais deverão restaurá-lo com mansidão. Cuide-se, porém, cada um para que também não seja tentado.
2 Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.
2 Levem os fardos pesados uns dos outros e, assim, cumpram a lei de Cristo.
3 Bikos if anybody tink sey, en too big wen e nor bi anytin, e dey deceive ensef.
3 Se alguém se considera alguma coisa, não sendo nada, engana-se a si mesmo.
4 Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef.
4 Cada um examine os próprios atos, e então poderá orgulhar-se de si mesmo, sem se comparar com ninguém,
5 Bikos each pesin go karry en own load by ensef.
5 pois cada um deverá levar a própria carga.
6 Di pesin wey dem dey tish God word, must share di good tins wey e get with di pesin wey dey tish am.
6 O que está sendo instruído na palavra partilhe todas as coisas boas com quem o instrui.
7 Make una nor let anybody deceive una. Nobody go fit deceive God. Anytin wey pesin plant, naim e go reap,
7 Não se deixem enganar: de Deus não se zomba. Pois o que o homem semear, isso também colherá.
8 bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.
8 Quem semeia para a sua carne, da carne colherá destruição; mas quem semeia para o Espírito, do Espírito colherá a vida eterna.
9 So make to do good, nor taya us, bikos wen time rish, wi go gain am.
9 E não nos cansemos de fazer o bem, pois no tempo próprio colheremos, se não desanimarmos.
10 So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.
10 Portanto, enquanto temos oportunidade, façamos o bem a todos, especialmente aos da família da fé.
11 Make una si as di word wey I take my hand rite give una, big rish!
11 Vejam com que letras grandes estou lhes escrevendo de próprio punho!
12 Pipol wey won show sey dem good, dey try to force una to sekonsaiz. Dem dey do so, so dat dem nor go sofa, bikos of Christ cross.
12 Os que desejam causar boa impressão exteriormente, tentando obrigá-los a se circuncidarem, agem desse modo apenas para não serem perseguidos por causa da cruz de Cristo.
13 Pipol wey sekonsaiz nor dey obey di law, but dem wont make una sekonsaiz, so dat dem go fit use una take boast.
13 Nem mesmo os que são circuncidados cumprem a lei; querem, no entanto, que vocês sejam circuncidados a fim de se gloriarem no corpo de vocês.
14 I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.
14 Quanto a mim, que eu jamais me glorie, a não ser na cruz de nosso Senhor Jesus Cristo, por meio da qual o mundo foi crucificado para mim, e eu para o mundo.
15 Weda pesin sekonsaiz or not, e nor mean anytin, di only tin wey matter bi sey, una don turn to new pesin.
15 De nada vale ser circuncidado ou não. O que importa é ser uma nova criação.
16 Una wey dey obey dis rule wey I dey give so, make peace and mesi dey with una and all God pipol.
16 Paz e misericórdia estejam sobre todos os que andam conforme essa regra, e também sobre o Israel de Deus.
17 From naw go, make nobody worry mi, bikos I get Jesus Christ mark for my body.
17 Sem mais, que ninguém me perturbe, pois trago em meu corpo as marcas de Jesus.
18 My brodas and sistas, make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una spirit. Amen!
18 Irmãos, que a graça de nosso Senhor Jesus Cristo seja com o espírito de vocês. Amém.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gálatas 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.