Filipenses 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Dis leta na from Paul and Timoti, wey bi Jesus Christ savant. To all God pipol for Filippi, with dia bishops and leaders.
1 Paulo e Timóteo, servos de Jesus Cristo, a todos os santos em Jesus Cristo, que se acham em Filipos, juntamente com os bispos e diáconos:
2 Make God awa papa and Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
2 a vós, graça e paz da parte de Deus, nosso Pai, e da parte do Senhor Jesus Cristo!
3 I dey tank my God evritime I remember una.
3 Dou graças a meu Deus, cada vez que de vós me lembro.
4 Evritime wen I dey pray for una, I dey do am with happiness,
4 Em todas as minhas orações, rezo sempre com alegria por todos vós,
5 bikos of how una dey help mi prish di gospel from di first day wey una hear am kon rish today.
5 recordando-me da cooperação que haveis dado na difusão do Evangelho, desde o primeiro dia até agora.
6 I dey sure sey, di Pesin wey start dis good work for una life, go make am pafet until di day wen Christ go kom.
6 Estou persuadido de que aquele que iniciou em vós esta obra excelente lhe dará o acabamento até o dia de Jesus Cristo.
7 So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.
7 É justo que eu tenha bom conceito de todos vós, porque vos trago no coração, por terdes tomado parte na graça que me foi dada, tanto na minha prisão como na defesa e na confirmação do Evangelho.
8 God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.
8 Deus me é testemunha da ternura que vos consagro a todos, pelo entranhado amor de Jesus Cristo!
9 I pray make una love dey strong more-more for God tins wey una learn and make E help una undastand,
9 Peço, na minha oração, que a vossa caridade se enriqueça cada vez mais de compreensão e critério,
10 so dat una go fit choose wetin betta pass and as una dey do so, una go dey ready for di day wen Christ go kom.
10 com que possais discernir o que é mais perfeito e vos torneis puros e irrepreensíveis para o dia de Cristo,
11 Make di work wey Christ do for us and how to please God, full una mind. Den all di glory and praiz go bi God own.
11 cheios de frutos da justiça, que provêm de Jesus Cristo, para a glória e louvor de Deus.
12 My brodas and sistas, I wont make una know sey my sofa na to make di gospel stand.
12 Meus irmãos, quero fazer-vos saber que os acontecimentos que me envolvem estão redundando em maior proveito do Evangelho.
13 Di sojas wey dey guide di prison and all di oda pipol don know sey, na bikos of Christ, I dey prison
13 Em todo o pretório e por toda parte tornou-se conhecido que é por causa de Cristo que estou preso.
14 and bikos of di prison wey dem put mi so, almost all di brodas and sistas faith for Christ, don strong well-well. And naw, dem don dey prish God word without fear.
14 A maior parte dos irmãos, ante a notícia das minhas cadeias, cobrou nova confiança no Senhor e maior entusiasmo em anunciar sem temor a palavra de Deus.
15 True-true, na jealousy and kworel make some dey prish about Christ, but odas dey do am with betta mind.
15 É verdade que alguns pregam Cristo por inveja a mim e por discórdia, mas outros o fazem com a melhor boa vontade.
16 I know sey dis ones na love make dem dey do am, bikos dem know sey I dey here to defend wetin dem dey prish.
16 Estes, por caridade, sabendo que tenho por missão a defesa do Evangelho;
17 Doz oda ones wey dey prish about Christ dey do so, bikos dem dey tink about diasef and wetin dem go gain. Dem nor dey do tins with klean mind and dem tink sey dem fit kause more trobol for mi, bikos I dey prison.
17 aqueles, ao contrário, pregam Cristo por espírito de intriga, e não com reta intenção, no intuito de agravar meu sofrimento nesta prisão.
18 But dat one nor matter to mi. So, weda dem dey pritend or do am with klean mind, di message about Christ dey kontinue and na dat one dey make mi happy.
18 Mas não faz mal! Contanto que de todas as maneiras, por pretexto ou por verdade, Cristo seja anunciado, nisto não só me alegro, mas sempre me alegrarei.
19 bikos I know sey na una prayer and di help wey Christ Spirit dey give, dey save mi.
19 Pois sei que isto me resultará em salvação, graças às vossas orações e ao socorro do Espírito de Jesus Cristo.
20 Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.
20 Meu ardente desejo e minha esperança são que em nada serei confundido, mas que, hoje como sempre, Cristo será glorificado no meu corpo {tenho toda a certeza disto}, quer pela minha vida quer pela minha morte.
21 Bikos to mi, to dey dis life, na to live for Christ and to die inside Christ, na dat one betta pass.
21 Porque para mim o viver é Cristo e o morrer é lucro.
22 If I kontinue to dey live inside dis body, e mean sey I go do betta work, but I nor know wish one I go like pass.
22 Mas, se o viver no corpo é útil para o meu trabalho, não sei então o que devo preferir.
23 Naw, I know wish one I go choose, bikos I won go dey with Christ and na dat one betta pass.
23 Sinto-me pressionado dos dois lados: por uma parte, desejaria desprender-me para estar com Cristo - o que seria imensamente melhor;
24 But e go good for una as I still dey for dis body.
24 mas, de outra parte, continuar a viver é mais necessário, por causa de vós...
25 I dey sure of dis tins: I know sey I nor go die naw, so dat I go kontinue with una and as una dey inside di faith, una life go dey betta more-more.
25 Persuadido disto, sei que ficarei e continuarei com todos vós, para proveito vosso e consolação da vossa fé.
26 So wen I kom meet una again as una dey serve Christ, una go get more rizin to dey happy bikos of mi.
26 Assim, minha volta para junto de vós vos dará um novo motivo de alegria em Cristo Jesus.
27 Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand.
27 Cumpre, somente, que vos mostreis em vosso proceder dignos do Evangelho de Cristo. Quer eu vá ter convosco quer permaneça ausente, desejo ouvir que estais firmes em um só espírito, lutando unanimemente pela fé do Evangelho,
28 Make una nor fear una enemies, bikos dem go soon skata and dat na sign to show sey God go save una.
28 sem vos deixardes intimidar em nada pelos vossos adversários. Isto para eles é motivo de perdição; para vós outros, de salvação. E é a vontade de Deus,
29 God don give una dis sign, nor bi only make una for bilive Christ, but make una for still sofa for am,
29 porque a vós vos é dado não somente crer em Cristo, mas ainda por ele sofrer.
30 bikos una dey face di same sofa wey una si mi dey face. And I wont make una know sey, even naw, I still dey sofa di same tin.
30 Sustentais o mesmo combate que me tendes visto travar e no qual sabeis que eu continuo agora.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Filipenses 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.