Êxodo 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Dis na Jakob shidren wey follow am go Egypt and each one karry en family follow body:
1 Eis os nomes dos filhos de Israel que vieram para o Egito com Jacó, cada um com sua família:
2 Reuben, Simeon, Levi, Judah,
2 Rubem, Simeão, Levi, Judá,
3 Issakar, Zebulun, Benjamin,
3 Issacar, Zabulon, Benjamim,
4 Dan, Naftali Gad and Asher.
4 Dã, Neftali, Gad e Aser.
5 Jakob family for Egypt, na seventy (Josef don already dey Egypt before dem kom).
5 Todas as pessoas saídas de Jacó eram em número de setenta. José estava já no Egito.
6 Afta sometaim, Josef, en brodas and doz wey bi dia age mate kon die.
6 E, morto José, assim como todos os seus irmãos e toda aquela geração,
7 So Israel pipol kon plenty and dey strong for di land.
7 os israelitas foram fecundos e multiplicaram-se; tornaram-se tão numerosos e tão fortes, que a terra ficou cheia deles.
8 Den one new king wey nor know Josef kon dey rule Egypt.
8 Entretanto, subiu ao trono do Egito um novo rei, que não tinha conhecido José.
9 So di king kon tell en pipol, “Make una si, Israel pipol dey plenty and dem strong pass us!
9 Ele disse ao seu povo: Vede: os israelitas tornaram-se numerosos e fortes demais para nós.
10 Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.”
10 Vamos! É preciso tomar precaução contra eles e impedir que se multipliquem, para não acontecer que, sobrevindo uma guerra, se unam com os nossos inimigos e combatam contra nós, e se retirem do país.
11 So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put.
11 Estabeleceu, pois, sobre eles, feitores para acabrunhá-los com trabalhos penosos: eles construíram para o faraó as cidades de Pitom e Ramsés, que deviam servir de entreposto.
12 But even as Egypt pipol dey opress Israel pipol, dem still dey plenty more-more for di land and Egypt pipol kon dey fear dem well-well,
12 Quanto mais os acabrunhavam, porém, tanto mais eles se multiplicavam e se espalhavam, a ponto de os egípcios os aborrecerem.
13 so dem kon dey ponish Israel pipol anyhow.
13 Impunham-lhes a mais dura servidão,
14 Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.
14 e amarguravam-lhes a vida com duros trabalhos na argamassa e na fabricação de tijolos, bem como com toda sorte de trabalhos nos campos e todas as tarefas que se lhes impunham tiranicamente.
15 Di king wey dey rule Egypt kon tell Shifrah and Puah wey bi di Hibru nurse sey;
15 O rei do Egito dirigiu-se, igualmente, às parteiras dos hebreus (uma se chamava Séfora e a outra, Fua),
16 “Anytime wen una dey help di Hibru wimen wey won born, if una si sey di pikin na boy, make una kill-am, but if na girl, make una nor kill-am.”
16 e disse-lhes: Quando assistirdes às mulheres dos hebreus, e as virdes sobre o leito, se for um filho, atá-lo-eis; mas se for uma filha, deixá-la-eis viver.
17 But di nurse dem dey fear God and dem nor gri do wetin di king tell dem, so dem nor kill di boys.
17 Mas as parteiras temiam a Deus, e não executaram as ordens do rei do Egito, deixando viver os meninos.
18 Den di king koll di nurse kon ask, “Why una do dis kind tin? Why una nor kill di boys?”
18 O rei mandou-as chamar então e disse-lhes: Por que agistes assim, e deixastes viver os meninos?
19 Di nurse ansa Fero, “Hibru wimen nor bi like Egypt wimen; dem strong well-well and before wi go even rish der, dem don born!”
19 Porque, responderam elas ao faraó, as mulheres dos hebreus não são como as dos egípcios: elas são vigorosas, e já dão à luz antes que chegue a parteira.
20 So God favor di nurse dem and Israel pipol kon dey plenty and strong.
20 Deus beneficiou as parteiras: o povo continuou a multiplicar-se e a espalhar-se.
21 Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.
21 Porque elas haviam temido a Deus, ele fez prosperar suas famílias.
22 So Fero kommand en pipol, “Make una go kill any boy wey dem just born kon trow dem inside River Nile, but make una leave all di girls.”
22 Então o faraó deu esta ordem a todo o seu povo: Todo menino que nascer, atirá-lo-eis ao Nilo. Deixareis, porém, viver todas as meninas.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.