Efésios 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Shidren, as una know God, make una dey hear una papa and mama word, bikos na wetin una suppose do bi dat.
1 Filhos, obedecei a vossos pais segundo o Senhor; porque isto é justo.
2 Make una respet una papa and mama, bikos na dis bi di first kommandment from God wey get promise.
2 O primeiro mandamento acompanhado de uma promessa é: Honra teu pai e tua mãe,
3 So dat e go betta for una and una go get long life.
3 para que sejas feliz e tenhas longa vida sobre a terra {Dt 5,16}.
4 Una wey bi papa, make una nor make una shidren vex, but make una raiz dem to follow Christ tishing.
4 Pais, não exaspereis vossos filhos. Pelo contrário, criai-os na educação e doutrina do Senhor.
5 Una wey bi savant, make una dey obey una masta with fear, respet and with klean mind like sey, na Christ una dey obey.
5 Servos, obedecei aos vossos senhores temporais, com temor e solicitude, de coração sincero, como a Cristo,
6 Make una nor bi like pipol wey dey do dia work wen dem si sey, pesin dey look dem; bikos dem dey fine good face. Instead, as una bi Christ savant, make una dey do wetin God like from una heart.
6 não por mera ostentação, só para agradar aos homens, mas como servos de Cristo, que fazem de bom grado a vontade de Deus.
7 Make una dey do una work with betta mind like sey, na Christ una dey do am for and nor bi human being,
7 Servi com dedicação, como servos do Senhor e não dos homens.
8 bikos una know sey, each pesin; weda e bi slave or e dey free, if e do wetin dey good, Christ go reward am.
8 E estai certos de que cada um receberá do Senhor a recompensa do bem que tiver feito, quer seja escravo quer livre.
9 And una wey bi masta, make una dey trit una savant well. Make una nor make dem fear, bikos both yu and dem get di same masta for heaven and E nor dey favor pesin anyhow.
9 Senhores, procedei também assim com os servos. Deixai as ameaças. E tende em conta que o Senhor está no céu, Senhor tanto deles como vosso, que não faz distinção de pessoas.
10 Finally, make una dey strong with Christ mighty pawa.
10 Finalmente, irmãos, fortalecei-vos no Senhor, pelo seu soberano poder.
11 Make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand fight di wayo wey devil dey use.
11 Revesti-vos da armadura de Deus, para que possais resistir às ciladas do demônio.
12 Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.
12 Pois não é contra homens de carne e sangue que temos de lutar, mas contra os principados e potestades, contra os príncipes deste mundo tenebroso, contra as forças espirituais do mal {espalhadas} nos ares.
13 Na dis make mi sey, make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand for groun wen trobol and wahala go kom and wen una don win, una go still stand well.
13 Tomai, por tanto, a armadura de Deus, para que possais resistir nos dias maus e manter-vos inabaláveis no cumprimento do vosso dever.
14 So, make una stand well-well kon tie trut like belt round una waist, den wear bullet proof koat as raitiousness for una body.
14 Ficai alerta, à cintura cingidos com a verdade, o corpo vestido com a couraça da justiça,
15 Make una wear shoe for leg wey go show sey, una dey ready to prish di Good News wey dey give pipol peace
15 e os pés calçados de prontidão para anunciar o Evangelho da paz.
16 and with all dis, make una karry faith wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow.
16 Sobretudo, embraçai o escudo da fé, com que possais apagar todos os dardos inflamados do Maligno.
17 Make una wear salvashon like priest kap for head kon whole di Spirit swod wey bi God word.
17 Tomai, enfim, o capacete da salvação e a espada do Espírito, isto é, a palavra de Deus.
18 With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.
18 Intensificai as vossas invocações e súplicas. Orai em toda circunstância, pelo Espírito, no qual perseverai em intensa vigília de súplica por todos os cristãos.
19 Make una pray for mi too sey, make God give mi betta word anytime wen I open my mout to tok and make I fit esplain di sekret wey dey di gospel.
19 E orai também por mim, para que me seja dado anunciar corajosamente o mistério do Evangelho,
20 I bi God messenja, even doh I dey for prison naw. But make una pray sey, I go dey tok with boldness as I suppose to tok.
20 do qual eu sou embaixador, prisioneiro. E que eu saiba apregoá-lo publicamente, e com desassombro, como é meu dever!
21 Tikikus wey bi my special broda and faithful savant for God work, go tell una evritin, so dat una go know wetin dey happen to mi for here.
21 E para que também vós estejais a par da minha situação e do que faço aqui, Tíquico, o irmão muito amado e fiel ministro no Senhor, vos informará de tudo.
22 Na bikos of dis I send am kom meet una, make una for know how tins dey with us for here and make e for fit enkourage una heart.
22 Eu vo-lo envio precisamente para isto: para que sejais informados do que se passa conosco e para que ele conforte os vossos corações.
23 I pray sey make God, awa Papa and Oga God Jesus Christ give all my fellow Christian brodas and sistas peace, love and faith.
23 Paz aos irmãos, amor e fé, da parte de Deus Pai e do Senhor Jesus Cristo.
24 Make God grace dey with evribody wey love awa Oga God Jesus Christ with di love wey nor dey die.
24 A graça esteja com todos os que amam nosso Senhor Jesus Cristo com amor inalterável e eterno.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Efésios 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.