Efésios 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Mi wey bi prisona, bikos I dey serve di Oga God; I dey beg una make una dey live una life as God wont.
1 Rogo-vos, pois, eu, o prisioneiro no Senhor, que andeis de modo digno da vocação a que fostes chamados,
2 Make una dey get pity for one anoda with kwayetnes, gentolness and patient, bikos of di love wey una get.
2 com toda a humildade e mansidão, com longanimidade, suportando-vos uns aos outros em amor,
3 Make una dey do evritin wey una fit do to keep di unity wey di Spirit dey give, as una dey live togeda for peace.
3 esforçando-vos diligentemente por preservar a unidade do Espírito no vínculo da paz;
4 Na one body and Spirit dey, bikos just as all of una get one hope from God wen E koll una,
4 há somente um corpo e um Espírito, como também fostes chamados numa só esperança da vossa vocação;
5 na so too una get one Oga God, one faith, one baptizim,
5 há um só Senhor, uma só fé, um só batismo;
6 one God and Papa wey dey above evribody; dey use evribody and dey inside evribody.
6 um só Deus e Pai de todos, o qual é sobre todos, age por meio de todos e está em todos.
7 But God don give grace to all of us akordin to how Christ gift plenty rish.
7 E a graça foi concedida a cada um de nós segundo a proporção do dom de Cristo.
8 Na dis make dem sey, “Wen e raiz-up go heaven, E karry many prisonas wey E free follow body and E give plenty gift to pipol.”
8 Por isso, diz: Quando ele subiu às alturas, levou cativo o cativeiro e concedeu dons aos homens.
9 Na wetin dis word, “E raiz-up,” mean? E mean sey Christ first die and dem beri am for di eart.
9 Ora, que quer dizer subiu, senão que também havia descido até às regiões inferiores da terra?
10 En wey dem beri, naim still bi di pesin wey raiz-up pass di heavens, so dat e go komplete evritin.
10 Aquele que desceu é também o mesmo que subiu acima de todos os céus, para encher todas as coisas.
11 Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas.
11 E ele mesmo concedeu uns para apóstolos, outros para profetas, outros para evangelistas e outros para pastores e mestres,
12 Christ do like dis to prepare us for di ministry work, wey go make God church grow,
12 com vistas ao aperfeiçoamento dos santos para o desempenho do seu serviço, para a edificação do corpo de Cristo,
13 so dat wi go bi one for di tins wey wi bilive and wey go make us really know God Pikin. Den, wi go dey tink like Christ.
13 até que todos cheguemos à unidade da fé e do pleno conhecimento do Filho de Deus, à perfeita varonilidade, à medida da estatura da plenitude de Cristo,
14 So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
14 para que não mais sejamos como meninos, agitados de um lado para outro e levados ao redor por todo vento de doutrina, pela artimanha dos homens, pela astúcia com que induzem ao erro.
15 But, as wi dey do wetin dey good and korrect with love, wi go dey grow for evry side kon meet Christ wey bi di head.
15 Mas, seguindo a verdade em amor, cresçamos em tudo naquele que é a cabeça, Cristo,
16 Na from Christ di whole body dey grow well and join togeda thru di pawa wey dey support am. As each part dey do en work, na so di body go dey grow inside God love.
16 de quem todo o corpo, bem-ajustado e consolidado pelo auxílio de toda junta, segundo a justa cooperação de cada parte, efetua o seu próprio aumento para a edificação de si mesmo em amor.
17 So, I dey use Christ pawa take tell una dis tins sey, make una nor live una life like Gentile pipol wey dey tink only bad and tins wey nor get sense.
17 Isto, portanto, digo e no Senhor testifico que não mais andeis como também andam os gentios, na vaidade dos seus próprios pensamentos,
18 Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand.
18 obscurecidos de entendimento, alheios à vida de Deus por causa da ignorância em que vivem, pela dureza do seu coração,
19 Dem dey do wayo, dey give dia body to yeye tins; tins wey nor dey pure and dey wiked.
19 os quais, tendo-se tornado insensíveis, se entregaram à dissolução para, com avidez, cometerem toda sorte de impureza.
20 But wi nor tish una like dat about Christ.
20 Mas não foi assim que aprendestes a Cristo,
21 If na thru, den una don hear and learn di trut about am, just as di trut dey inside Christ.
21 se é que, de fato, o tendes ouvido e nele fostes instruídos, segundo é a verdade em Jesus,
22 Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins
22 no sentido de que, quanto ao trato passado, vos despojeis do velho homem, que se corrompe segundo as concupiscências do engano,
23 and make una dey tink betta tins for una mind.
23 e vos renoveis no espírito do vosso entendimento,
24 Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.
24 e vos revistais do novo homem, criado segundo Deus, em justiça e retidão procedentes da verdade.
25 Since una don stop to lie, make una start to tok trut give una neighbour, bikos all of us na membas for Christ body.
25 Por isso, deixando a mentira, fale cada um a verdade com o seu próximo, porque somos membros uns dos outros.
26 If una dey vex, make una nor sin and make day nor dark still meet una dey vex.
26 Irai-vos e não pequeis; não se ponha o sol sobre a vossa ira,
27 Make una nor give di devil any shance.
27 nem deis lugar ao diabo.
28 Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.
28 Aquele que furtava não furte mais; antes, trabalhe, fazendo com as próprias mãos o que é bom, para que tenha com que acudir ao necessitado.
29 Make una nor allow any bad word kom out from una mout, but make una word dey give poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am.
29 Não saia da vossa boca nenhuma palavra torpe, e sim unicamente a que for boa para edificação, conforme a necessidade, e, assim, transmita graça aos que ouvem.
30 Make una nor do wetin go make di Holy Spirit vex. Bikos na di Holy Spirit bi di mark wey God put for una body, so dat for judgement day, E go know doz wey E go save.
30 E não entristeçais o Espírito de Deus, no qual fostes selados para o dia da redenção.
31 Una must stop to get bad belle; to dey vex; kworel and to dey tok bad-bad word.
31 Longe de vós, toda amargura, e cólera, e ira, e gritaria, e blasfêmias, e bem assim toda malícia.
32 Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.
32 Antes, sede uns para com os outros benignos, compassivos, perdoando-vos uns aos outros, como também Deus, em Cristo, vos perdoou.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Efésios 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.