Deuteronômio 27

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Den Moses and di eldas for Israel kommand di pipol sey: “Make una obey all di kommand wey I dey give una today.
1 Moisés e as autoridades de Israel ordenaram ao povo: "Obedeçam à toda esta lei que hoje lhes dou.
2 Wen una cross Jordan River kon enter di land wey di Oga una God dey give una, make una gada some big stones kon pash dem.
2 Quando vocês atravessarem o Jordão, e entrarem na terra que o Senhor, o seu Deus, lhes dá, levantem algumas pedras grandes e pintem-nas com cal.
3 Wen una don cross di river won kon enter di land wey milk and honey full, wey di Oga dey give una, just as una grand-grand papa God promise una, make una rite all dis kommand put for di stones.
3 Escrevam nelas todas as palavras desta lei, assim que tiverem atravessado para entrar na terra que o Senhor, o seu Deus, lhes dá, terra onde manam leite e mel, como o Senhor, o Deus dos seus antepassados, lhes prometeu.
4 Wen una don cross Jordan River, make una gada di stones for Mount Ebal kon pash dem, just as I dey kommand una today.
4 E, quando tiverem atravessado o Jordão, levantem essas pedras no monte Ebal, como hoje lhes ordeno, e pintem-nas com cal.
5 Den for der, make una build altar for di Oga una God and make una nor use anytin take kut dem at-all.
5 Construam ali um altar ao Senhor, ao seu Deus, um altar de pedras. Não utilizem ferramenta de ferro nas pedras.
6 Una go build di Oga una God altar with betta stones; nor bi with ones wey dem kut, den una go offa burnt ofrin for der give di Oga una God.
6 Façam o altar do Senhor, do seu Deus, com pedras brutas, e sobre ele ofereçam holocaustos ao Senhor, ao seu Deus.
7 Una go still offa fellowship ofrin kon chop dem for der as una dey happy for di Oga una God present.
7 Ofereçam também sacrifícios de comunhão, e comam e alegrem-se na presença do Senhor, do seu Deus.
8 Una must rite all dis kommand for di stone and una go rite am as evribody go fit take si am.”
8 E nessas pedras que levantarem, vocês escreverão com bastante clareza todas as palavras desta lei".
9 Den Moses and Levi priests kon tok to Israel pipol: “Israel pipol, make una kwayet and listin! Today, una don bi di Oga una God pipol.
9 Então Moisés e os sacerdotes levitas disseram a todo Israel: "Faça silêncio e escute, ó Israel! Agora você se tornou o povo do Senhor, o seu Deus.
10 So una must obey di Oga una God as una dey keep all dis kommand and laws wey I dey give una today.”
10 Obedeça ao Senhor, ao seu Deus, e siga os seus mandamentos e decretos que hoje lhe dou".
11 Dat day, Moses still tell dem:
11 No mesmo dia Moisés ordenou ao povo:
12 “Wen una cross Jordan River, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Josef and Benjamin tribe must stand on-top Mount Gerizim kon bless di pipol.
12 Quando vocês tiverem atravessado o Jordão, as tribos que estarão no monte Gerizim para abençoar o povo serão: Simeão, Levi, Judá, Issacar, José e Benjamim.
13 And Reuben, Gad, Asher, Zebulun, Dan and Naftali tribe go stand on-top Mount Ebal kon curse any tribe wey nor follow God kommand.
13 E as tribos que estarão no monte Ebal para declararem maldições serão: Rúben, Gade, Aser, Zebulom, Dã e Naftali.
14 “Den Levi tribe go shaut give Israel pipol sey:
14 E os levitas recitarão a todo o povo de Israel em alta voz:
15 ‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God.
15 "Maldito quem esculpir uma imagem ou fizer um ídolo fundido, obra de artesãos, detestável ao Senhor, e levantá-lo secretamente". Todo o povo dirá: "Amém! "
16 Anybody wey nor respet en papa and mama, na curse go follow am.
16 "Maldito quem desonrar o seu pai ou a sua mãe". Todo o povo dirá: "Amém! "
17 Anybody wey tif en neighbour propaty or kut en neighbour land join e own, na curse go follow am.
17 "Maldito quem mudar o marco de divisa da propriedade do seu próximo". Todo o povo dirá: "Amém! "
18 Anybody wey go show blind man wrong road, na curse go follow am.
18 "Maldito quem fizer o cego errar o caminho". Todo o povo dirá: "Amém! "
19 Strenjas, pesin wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die, if anybody nor judge dia kase well, na curse go follow am.
19 "Maldito quem negar justiça ao estrangeiro, ao órfão ou à viúva". Todo o povo dirá: "Amém! "
20 Anybody wey sleep with en papa wife, na curse go follow am, bikos e nor gri honor en papa.
20 "Maldito quem se deitar com a mulher do seu pai, desonrando a cama do seu pai". Todo o povo dirá: "Amém! "
21 Anybody wey go sleep with animal, na curse go follow am.
21 "Maldito quem tiver relações sexuais com algum animal". Todo o povo dirá: "Amém! "
22 Anybody wey sleep with en sista, weda na en papa or mama pikin, na curse go follow am.
22 "Maldito quem se deitar com a sua irmã, filha do seu pai ou da sua mãe". Todo o povo dirá: "Amém! "
23 Anybody wey sleep with en wife mama, na curse go follow am.
23 "Maldito quem se deitar com a sua sogra". Todo o povo dirá: "Amém! "
24 Anybody wey hide go kill en neighbour, na curse go follow am.
24 "Maldito quem matar secretamente o seu próximo". Todo o povo dirá: "Amém! "
25 Anybody wey kollect money to kill pesin wey nor do anytin, na curse go follow am.
25 "Maldito quem aceitar pagamento para matar um inocente". Todo o povo dirá: "Amém! "
26 Anybody wey nor gri obey or keep dis law and kommand, na curse go follow am.
26 "Maldito quem não puser em prática as palavras desta lei". Todo o povo dirá: "Amém! "

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 27, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.