Deuteronômio 25

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 If two pipol kworel kon go kourt and di judge sey one dey rite and di oda one dey wrong.
1 Se houver contenda entre alguns, e vierem a juízo para serem julgados, justificar-se-á ao inocente, e ao culpado condenar-se-á.
2 If di judge sey make dem flog di one wey dey wrong, di judge go kommand am make e liedan for en front make dem flog am.
2 E se o culpado merecer açoites, o juiz fará que ele se deite e seja açoitado na sua presença, de acordo com a gravidade da sua culpa.
3 But make una nor flog pesin pass forty times, bikos if una flog am pass forty times, den una don disgrace am bi dat.
3 Até quarenta açoites lhe poderá dar, não mais; para que, porventura, se lhe der mais açoites do que estes, teu irmão não fique envilecido aos teus olhos.
4 Make una nor stop una melu make e nor chop wen e dey harvest for una.
4 Não atarás a boca ao boi quando estiver debulhando.
5 If two brodas dey stay togeda and one die and e nor get boy pikin, di wife wey en husband don die must nor marry anoda man wey nor dey dat family. Instead, di woman husband broda go marry am kon kare for am.
5 Se irmãos morarem juntos, e um deles morrer sem deixar filho, a mulher do falecido não se casará com homem estranho, de fora; seu cunhado estará com ela, e a tomará por mulher, fazendo a obrigação de cunhado para com ela.
6 Den di first boy wey di woman go born, go ansa dat one wey don die name, so dat dem nor go forget di broda name for Israel.
6 E o primogênito que ela lhe der sucederá ao nome do irmão falecido, para que o nome deste não se apague de Israel.
7 But if di broda sey e nor go fit marry en dead broda wife, den make di woman go ripot to di eldas for di town gate sey, “My husband broda sey e nor fit keep en broda name for Israel; so e nor gri marry mi!”
7 Mas, se o homem não quiser tomar sua cunhada, esta subirá à porta, aos anciãos, e dirá: Meu cunhado recusa suscitar a seu irmão nome em Israel; não quer cumprir para comigo o dever de cunhado.
8 Den di eldas for di town go koll and tok to am. If e still sey, “I nor won marry am,”
8 Então os anciãos da sua cidade o chamarão, e falarão com ele. Se ele persistir, e disser: Não quero tomá-la;
9 den di woman go waka go meet am for di eldas front kon remove en sandal from e leg den spit for en face. Den di woman go sey, “Make dis kind tin happen to any man wey nor gri keep en broda name for Israel!”
9 sua cunhada se chegará a ele, na presença dos anciãos, e lhe descalçará o sapato do pé, e lhe cuspirá ao rosto, e dirá: Assim se fará ao homem que não edificar a casa de seu irmão.
10 Den dem go dey koll en family, “Family wey dem pul di man sandal komot en leg.”
10 E sua casa será chamada em Israel a casa do descalçado.
11 If two men dey fight with hand and one wife kon join help en husband attack di oda, den di woman use en hand take hold di oda man private part,
11 Quando pelejarem dois homens, um contra o outro, e a mulher de um chegar para livrar a seu marido da mão daquele que o fere, e ela, estendendo a mão, lhe pegar pelas suas vergonhas,
12 una go kut di woman hand komot and make una nor sorry for am.
12 decepar-lhe-á a mão; o teu olho não terá piedade dela.
13 Wen una dey measure tins, una must measure well
13 Não terás na tua bolsa pesos diferentes, um grande e um pequeno.
14 and make una get only one kontaina for una house to take measure.
14 Não terás na tua casa duas efas, uma grande e uma pequena.
15 Make una always dey use di rite skale take measure, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una.
15 Terás peso inteiro e justo; terás efa inteira e justa; para que se prolonguem os teus dias na terra que o Senhor teu Deus te dá.
16 Doz wey dey measure with fake skale, dey sin against di Oga una God.
16 Porque é abominável ao Senhor teu Deus todo aquele que faz tais coisas, todo aquele que pratica a injustiça.
17 Make una nor ever forget wetin Amalek pipol do una wen una just dey kom out from Egypt.
17 Lembra-te do que te fez Amaleque no caminho, quando saías do Egito;
18 Dat time, as una taya and dey hongry, bikos dem nor dey fear God, dem attack una kon kill doz wey dey stagga dey kom for back.
18 como te saiu ao encontro no caminho e feriu na tua retaguarda todos os fracos que iam após ti, estando tu cansado e afadigado; e não temeu a Deus.
19 So wen di Oga una God don give una rest from all una enemies for di land wey E promise una, una must distroy Amalek pipol finish for dis world and nor of dem go remain.
19 Quando, pois, o Senhor teu Deus te houver dado repouso de todos os teus inimigos em redor, na terra que o Senhor teu Deus te dá por herança para a possuíres, apagarás a memória de Amaleque de debaixo do céu; não te esquecerás.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 25, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.