Deuteronômio 11
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Una must love di Oga wey bi una God kon obey evritin wey E tok. Dat is, en law, rules and kommand wey E give una.
1 Amarás, pois, o Senhor, teu Deus, e observarás sempre o que ele te ordena, suas leis, seus preceitos e seus mandamentos.
2 Make una know for una mind sey, I nor dey tok to una shidren wey neva si as di Oga una God judgement bi or si as E big and strong rish.
2 Quanto a vós pois não se trata de vossos filhos, que não conheceram e não foram testemunhas oculares das lições que o Senhor nos deu , {reconhecei} a grandeza de vosso Deus, o poder de sua mão, e o vigor de seu braço,
3 Dem nor si all di wonderful signs wey E do for una wen una dey serve King Fero and en pipol for Egypt.
3 os prodígios e as obras que fez no Egito contra o faraó, rei do Egito, e contra toda a sua terra;
4 Dem nor si wetin God do to Egypt sojas and dia shariot. How E take kill dem for di Red Sea wen dem dey porshu una. E distroy dem finish and dem neva fit balance kon rish today!
4 o que fez ao exército egípcio, aos seus cavalos e aos seus carros, como os envolveu nas águas do mar Vermelho, quando vos perseguiam, aniquilando-os para sempre.
5 Una shidren nor si wetin God do for una wen una dey di wildaness before una rish here.
5 {Lembra-te} do que fez por vós no deserto até a vossa chegada a este lugar;
6 Dem nor si wetin E do to Datan and Abiram (wey Eliab wey kom from Reuben tribe, bi dia papa) wen groun open for Israel kamp kon swallow dem with dia family, dia house and evritin wey dem get.
6 do castigo que infligiu a Datã e Abiron, filhos de Eliab, filho de Rubem, quando a terra, abrindo sua boca, engoliu-os no meio de todo o Israel, com suas famílias, suas tendas e todos os seres vivos que os seguiam.
7 But I dey tok to una bikos na una si all di wonderful tins wey God do!
7 Os vossos filhos viram todas as obras que o Senhor fez.
8 Naw, make una listin to all en kommand wey I dey give una today, so dat una go strong rish to kollect and enter di land wey una dey go so.
8 Observareis, pois, as ordens que hoje vos dou, para que sejais fortes e entreis na posse da terra que ides ocupar,
9 If una obey di kommand, una go get long life for di land wey God promise sey, E go give una grand-grand papa and una wey bi dia shidren; land wey milk and honey full!
9 e prolongueis os vossos dias na terra que o Senhor jurou dar a vossos pais e à sua posteridade, terra que mana leite e mel.
10 Bikos di land wey una go soon enter go stay, nor bi like Egypt where una from dey kom and where una nid to work with una hand and leg to take plant vegitabol.
10 Com efeito, a terra em que vais entrar para possuí-la, não é como o Egito de onde saíste, onde, depois de lançada a semente, devias regar a terra com a força de teus pés, como se rega uma horta.
11 But di land wey go soon bi una own, na land wey get hills and valleys with plenty rain,
11 A terra que ides ocupar é uma terra de montes e vales, que bebe as chuvas do céu.
12 di kind land wey di Oga una God like well-well. From one year to anoda, God dey wosh ova di land!
12 É uma terra de que o Senhor, teu Deus, toma cuidado, e para a qual os seus olhos estão continuamente voltados do começo ao fim do ano.
13 Naw, if una listin well-well to my kommand, wey I dey tell una today kon love di Oga una God and serve am with all una heart and mind,
13 Se obedecerdes aos mandamentos que hoje vos prescrevo, se amardes o Senhor, servindo-o de todo o vosso coração e de toda a vossa alma,
14 E go send rain for una land for di rite time, both di early and late rain, so dat una go harvest una food, new wine and oil.
14 derramarei sobre a vossa terra a chuva em seu tempo, a chuva do outono e a da primavera, e recolherás o teu trigo, o teu vinho e o teu óleo;
15 E go give una animals plenty grass for di land and una go chop beleful.
15 darei erva aos teus campos para os teus animais, e te alimentarás até ficares saciado.
16 But make una dey kareful. Make una nor let anybody deceive una, so dat una nor go turn from God kon dey serve and woship oda gods.
16 Tende cuidado para que o vosso coração não seja seduzido e vos desvieis do Senhor para servir deuses estranhos, rendendo-lhes culto e prostrando-vos diante deles.
17 If una do like dis, God go vex for una well-well. E go lock di sky and rain nor go fall, den di groun nor go bear food. Den una go kwik-kwik die for di good land wey God dey give una.
17 A cólera do Senhor se inflamaria contra vós e ele fecharia os céus: a chuva cessaria de cair, e não haveria mais colheita, no vosso solo, de modo que não tardaríeis a perecer nesta boa terra que o Senhor vos dá.
18 So make una keep dis kommand for una mind. Make una tie dem for una hand kon wear dem for una head, so dat una go remember dem.
18 Gravai, pois, profundamente em vosso coração e em vossa alma estas minhas palavras; prenderas às vossas mãos como um sinal, e levaras como uma faixa frontal entre os vossos olhos.
19 Make una tish dis kommand to una shidren. Make una tok about dem wen una dey house and wen una dey for road, even wen una won sleep and wen una wake-up.
19 Ensinai-as aos vossos filhos, falando-lhes delas seja em vossa casa, seja em viagem, quando vos deitardes ou levantardes.
20 Make una rite dem put for una door-mot and for una gate,
20 Escreve-as nas ombreiras e nas portas de tua casa,
21 so dat as long as di sky dey on-top di eart, una and una shidren go dey betta for di land wey God promise una grand-grand papa.
21 para que se multipliquem os teus dias e os dias de teus filhos na terra que o Senhor jurou dar a teus pais, e sejam tão numerosos como os dias do céu sobre a terra.
22 Make una dey kareful as una dey obey all di kommand wey I dey give una today. Make una show love to di Oga una God kon bilive and do as E sey make una do.
22 Se observardes fielmente todos os mandamentos que vos prescrevo, amando o Senhor, vosso Deus, andando em seus caminhos e apegando-vos a ele,
23 Den God go drive all di kountries wey dey una front, aldo dem really strong and great pass una, but una go take dia land.
23 então o Senhor expulsará de diante de vós todas essas nações, e despojareis povos mais numerosos e mais fortes do que vós.
24 Anywhere wey una waka rish, dat land go bi una own. Una land go long and wide from di wildaness go Lebanon and from River Eufrates go rish Mediterranean Sea.
24 Todo lugar em que pisar a planta de vossos pés vos pertencerá. Vossa fronteiras irão desde o deserto até o Líbano e desde o rio Eufrates até o mar do ocidente.
25 Nobody go fit stop una; di Oga una God go make dem fear una for any land wey una waka enter, just as E promise una.
25 Ninguém vos poderá resistir: o Senhor, vosso Deus, semeará o pânico e o terror de vós em todas as terras onde pisardes, como vos prometeu.
26 Si, today I dey give una shance to pick between blessing and curse!
26 Vede: proponho-vos hoje bênção ou maldição.
27 God go bless una if una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today.
27 Bênção, se obedecerdes aos mandamentos do Senhor, vosso Deus, que hoje vos prescrevo.
28 But na curse bi una own, if una rijet di Oga una God kommand kon turn from am go woship oda gods wey una nor know before.
28 Maldição, se não obedecerdes aos mandamentos do Senhor, vosso Deus, e vos apartardes do caminho que hoje vos mostro, para seguintes deuses estranhos que não conheceis.
29 Wen di Oga una God take una enter di land kon help una stay der, una must tok about di blessing for Mount Gerizim and di curse for Mount Ebal.
29 Quando o Senhor, vosso Deus, te tiver introduzido na terra que vais possuir, pronunciarás a bênção sobre o monte Garizim, e a maldição sobre o monte Ebal.
30 (Dis two mountins dey di west side for Jordan River where Kanaan pipol for di Valley, dey stay, near Gilgal town wey nor far from Moreh Oak.)
30 Essas montanhas encontram-se além do Jordão, do outro lado do caminho do ocidente, na terra dos cananeus que habitam nas planícies defronte de Gálgala, perto dos carvalhos de Moré.
31 Bikos una go soon cross Jordan River go take di land wey God dey give una. Wen una take di land kon dey stay inside,
31 Com efeito, vós passareis o Jordão e tomareis posse da terra que te dá o Senhor. Quando a possuirdes e nela habitardes,
32 make una dey kareful as una dey obey all di rules and law wey I dey give and tell una today.
32 cuidareis de praticar todos os preceitos e todas as leis que hoje vos proponho.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.