Colossenses 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 So, if God raiz una with Christ, den make una put mind for tins wey dey heaven; di place where Christ for sidan for God rite side.
1 Portanto, já que vocês ressuscitaram com Cristo, procurem as coisas que são do alto, onde Cristo está assentado à direita de Deus.
2 Make una dey tink about tins for heaven, nor bi tins for dis eart,
2 Mantenham o pensamento nas coisas do alto, e não nas coisas terrenas.
3 bikos una don die and una life dey save with Christ for inside God.
3 Pois vocês morreram, e agora a sua vida está escondida com Cristo em Deus.
4 Wen Christ (wey bi una life) go kom, una go follow am kom with glory.
4 Quando Cristo, que é a sua vida, for manifestado, então vocês também serão manifestados com ele em glória.
5 So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.
5 Assim, façam morrer tudo o que pertence à natureza terrena de vocês: imoralidade sexual, impureza, paixão, desejos maus e a ganância, que é idolatria.
6 Na dis tins dey make God vex for doz wey nor dey obey am.
6 É por causa dessas coisas que vem a ira de Deus sobre os que vivem na desobediência,
7 Na so una dey live una life before wen una bi sinnas,
7 as quais vocês praticaram no passado, quando costumavam viver nelas.
8 but naw, to dey vex anyhow; to get bad mind for pesin; to take mout spoil pesin and to dey curse pipol, make una remove dem from una life.
8 Mas agora, abandonem todas estas coisas: ira, indignação, maldade, maledicência e linguagem indecente no falar.
9 Since una don kill una old sef and di tins wey una dey do before, make una nor dey lie give each oda.
9 Não mintam uns aos outros, visto que vocês já se despiram do velho homem com suas práticas
10 Make una wear di new pesin, so dat una go dey new as una dey learn to know and bi like di Pesin wey kreate una.
10 e se revestiram do novo, o qual está sendo renovado em conhecimento, à imagem do seu Criador.
11 For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.
11 Nessa nova vida já não há diferença entre grego e judeu, circunciso e incircunciso, bárbaro e cita, escravo e livre, mas Cristo é tudo e está em todos.
12 So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.
12 Portanto, como povo escolhido de Deus, santo e amado, revistam-se de profunda compaixão, bondade, humildade, mansidão e paciência.
13 Make una dey bear with each oda; dey forgive each oda; even doh una get wahala with anybody. Just as Christ don forgive una, make una forgive odas too.
13 Suportem-se uns aos outros e perdoem as queixas que tiverem uns contra os outros. Perdoem como o Senhor lhes perdoou.
14 With all dis good tins, make una love one anoda, bikos na love bi di best tin wey fit whole una togeda.
14 Acima de tudo, porém, revistam-se do amor, que é o elo perfeito.
15 Make Christ peace dey rule una heart (bikos na thru dis peace, Christ take koll una as one body) and make una dey tank God.
15 Que a paz de Cristo seja o juiz em seus corações, visto que vocês foram chamados a viver em paz, como membros de um só corpo. E sejam agradecidos.
16 Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.
16 Habite ricamente em vocês a palavra de Cristo; ensinem e aconselhem-se uns aos outros com toda a sabedoria, e cantem salmos, hinos e cânticos espirituais com gratidão a Deus em seus corações.
17 For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.
17 Tudo o que fizerem, seja em palavra ou em ação, façam-no em nome do Senhor Jesus, dando por meio dele graças a Deus Pai.
18 Una wey bi wife, make una dey do wetin una husband wont, as Christ pipol suppose do.
18 Mulheres, sujeitem-se a seus maridos, como convém a quem está no Senhor.
19 Una wey bi husband, make una love una wife and nor dey wiked to dem.
19 Maridos, amem suas mulheres e não as tratem com amargura.
20 Una wey bi pikin, make una dey obey una papa and mama for evritin, (dey do evritin wey una papa and mama tok), bikos na wetin Christ like bi dat.
20 Filhos, obedeçam a seus pais em tudo, pois isso agrada ao Senhor.
21 Una wey bi papa, make una nor do wetin go make una shidren vex, so dat life nor go taya dem.
21 Pais, não irritem seus filhos, para que eles não se desanimem.
22 Una wey bi savants, make una obey una mastas (dey do wetin dem tok) for evritin and nor bi only wen dem dey look una. Make una nor dey do like pipol wey wont make dem praiz dem, but make una dey obey with betta mind, bikos una dey fear God.
22 Escravos, obedeçam em tudo a seus senhores terrenos, não somente para agradar os homens quando eles estão observando, mas com sinceridade de coração, pelo fato de vocês temerem ao Senhor.
23 Anytin wey una dey do, make una do am with all una body, like sey una dey do am for Christ and nor bi for pipol,
23 Tudo o que fizerem, façam de todo o coração, como para o Senhor, e não para os homens,
24 bikos una know sey na Christ una really dey serve and una know sey E go reward una.
24 sabendo que receberão do Senhor a recompensa da herança. É a Cristo, o Senhor, que vocês estão servindo.
25 Pesin wey do bad, God go pay am back for wetin e do, bikos God dey judge evribody akordin to wetin dem do, since E nor dey support anybody anyhow.
25 Quem cometer injustiça receberá de volta injustiça, e não haverá exceção para ninguém.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Colossenses 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.