2 Timóteo 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 So yu, my pikin, make yu dey strong for di grace wey Christ dey give.
1 Tu, portanto, meu filho, procura progredir na graça de Jesus Cristo.
2 Di tins wey yu hear mi tok for pipol present, make yu tish oda pipol wey yu trust sey dem dey ready to tish odas.
2 O que de mim ouviste em presença de muitas testemunhas, confia-o a homens fiéis que, por sua vez, sejam capazes de instruir a outros.
3 Make yu dey ready to sofa as mi and odas dey sofa, so dat yu go bi good soja for Christ.
3 Suporta comigo os trabalhos, como bom soldado de Jesus Cristo.
4 Nor-tin koncern sojas with tins wey ordinary pipol dey do; if not, e nor go do wetin en oga wont.
4 Nenhum soldado pode implicar-se em negócios da vida civil, se quer agradar ao que o alistou.
5 Bikos anybody wey dey run race, nor go fit win unless e follow di rule wey dey di game.
5 Nenhum atleta será coroado, se não tiver lutado segundo as regras.
6 Farmer wey work well-well, naim suppose get di first share for di harvest.
6 É preciso que o lavrador trabalhe antes com afinco, se quer boa colheita.
7 Make yu tink about wetin I dey tok so and Christ go help yu to undastand evritin.
7 Entende bem o que eu quero dizer. O Senhor há de dar-te inteligência em tudo.
8 Remember Jesus Christ wey kom from David family; di pesin wey God raiz from deat; bikos na so e bi for di message wey I dey prish
8 Lembra-te de Jesus Cristo, saído da estirpe de Davi e ressuscitado dos mortos, segundo o meu Evangelho,
9 and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison!
9 pelo qual estou sofrendo até as cadeias como um malfeitor. Mas a palavra de Deus, esta não se deixa acorrentar.
10 So I dey ready to bear di sofa, as long as e go save doz wey God don choose inside Christ with glory wey go dey forever and ever.
10 Pelo que tudo suporto por amor dos escolhidos, para que também eles consigam a salvação em Jesus Cristo, com a glória eterna.
11 Dis word na true:
11 Eis uma verdade absolutamente certa: Se morrermos com ele, com ele viveremos.
12 If wi bear with am,
12 Se soubermos perseverar, com ele reinaremos.
13 Weda wi get faith for am or not,
13 Se, porém, o renegarmos, ele nos renegará. Se formos infiéis... ele continua fiel, e não pode desdizer-se.
14 Make yu remind evribody about dis tins, den make yu kommand dem for God present sey, make dem nor dey argue about words, bikos doz kind tins nor dey good and e fit konfuse doz wey dey listin.
14 Lembra-lhes estas coisas e conjura-os, por Deus, a evitarem discussões de palavras, que só servem para a perdição dos ouvintes.
15 Make yu do evritin wey yu fit do, so dat God go si yu as betta pesin. Dey do yor work well as pesin wey nor dey shame, but dey ready to esplain God word wey bi trut.
15 Empenha-te em te apresentares diante de Deus como homem digno de aprovação, operário que não tem de que se envergonhar, íntegro distribuidor da palavra da verdade.
16 Make yu nor put mout for yeye tok, bikos pipol wey dey do doz tins, dey far from God.
16 Procura esquivar-te das conversas frívolas dos mundanos, que só contribuem para a impiedade.
17 Dia word dey spread like diziz and na dis tin happen to Hymenaeus and Filetus.
17 As palavras dessa gente destroem como a gangrena. Entre eles estão Himeneu e Fileto,
18 Dem leave di trut kon dey sey resureshon don happen already and like dis, dem don make some pipol fall from di faith.
18 que se desviaram da verdade dizendo que a ressurreição já aconteceu e transtornaram a fé em alguns.
19 But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”
19 Contudo, o sólido fundamento de Deus se mantém firme, porque vem selado com estas palavras: O Senhor conhece os que são seus {Nm 16,5}; e: Renuncie à iniqüidade todo aquele que pronuncia o nome do Senhor {Is 26,13}.
20 Wen yu go rish man house, nor bi only gold and silva tins dey der, but tins wey dem use wood and klay take make still dey der too and some dey make di house fine and odas nor good at-all.
20 Numa grande casa não há somente utensílios de ouro e de prata, mas também de madeira e de barro. Aqueles para ocasiões finas, estes para uso ordinário.
21 So if yu keep yorsef without fault, yu go bi betta pesin wey Christ fit use as e dey do en good work.
21 Quem, portanto, se conservar puro e isento dessas doutrinas, será um utensílio nobre, santificado, útil ao seu possuidor, preparado para todo uso benéfico.
22 Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart.
22 Foge das paixões da mocidade, busca com empenho a justiça, a fé, a caridade, a paz, com aqueles que invocam o Senhor com pureza de coração.
23 I dey tell yu again sey, make yu nor put mout for yeye word, bikos yu know sey dis kind tin dey kause kworel.
23 Rejeita as discussões tolas e absurdas, visto que geram contendas.
24 Pesin wey bi Christ savant nor dey kworel, instead e must dey good with evribody; must sabi tish well-well and get patient with sturbon pipol.
24 Não convém a um servo do Senhor altercar; bem ao contrário, seja ele condescendente com todos, capaz de ensinar, paciente em suportar os males.
25 E must dey gentol as e dey korrect pipol wey dey oppoz en prishin and God fit let dis pipol turn from sin kom meet am, so dat dem go know di trut.
25 É com brandura que deve corrigir os adversários, na esperança de que Deus lhes conceda o arrependimento e o conhecimento da verdade,
26 Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.
26 e voltem a si, uma vez livres dos laços do demônio, que os mantém cativos e submetidos aos seus caprichos.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Timóteo 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.