2 Crônicas 23

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 For di sevent year, Priest Jehoiada kon make plan with five sojas wey bi: Zabud wey Jeroham born, Ishmael wey bi Jehohanan pikin, Zabud wey Obed born, Maaseaya wey bi Adaya pikin and Elishafat wey Zikri born.
1 No sétimo ano, Joiada se animou e entrou em aliança com os capitães de cem: Azarias, filho de Jeroão, Ismael, filho de Joanã, Azarias, filho de Obede, Maaseias, filho de Adaías, e Elisafate, filho de Zicri.
2 Dem travel go Judah kon gada Levi pipol wey dey di towns with Israel pipol family leaders kom Jerusalem.
2 Estes percorreram Judá, e congregaram os levitas de todas as cidades de Judá e os cabeças das famílias de Israel, e vieram para Jerusalém.
3 All di pipol wey gada, kon make kovenant with di king for God Temple.
3 Toda essa congregação fez aliança com o rei na Casa de Deus; e Joiada lhes disse: Eis que reinará o filho do rei, como falou o Senhor a respeito dos filhos de Davi.
4 Dis na wetin una go do. Wen dem don divide di priest and Levi pipol wey dey duty for Sabat Day, one part must dey wosh di door.
4 Esta é a obra que haveis de fazer: uma terça parte de vós, sacerdotes e levitas, que entrais no sábado, servirá de guardas da porta;
5 Anoda part go stand for di palis gate and di oda part go dey di foundashon gate. All di pipol wey remain go stand for di kourtyard for God Temple.
5 outra terça parte estará na casa do rei; e a outra terça parte, à Porta do Fundamento; e todo o povo estará nos pátios da Casa do Senhor .
6 Make nobody enter God Temple escept di priest and Levi pipol wey dey duty. Dem fit enter bikos dia hand klean, but make di oda pipol dey outside.
6 Porém ninguém entre na Casa do Senhor , senão os sacerdotes e os levitas que ministram; estes entrarão, porque são santos; mas todo o povo guardará o preceito do Senhor .
7 Levi pipol must gada round di king and evribody go hold en weapon for hand. Anybody wey won enter di temple, make una kill-am. Una must follow di king go anywhere wey e dey go.”
7 Os levitas rodearão o rei, cada um de armas na mão, e qualquer que entrar na casa, seja morto; estareis com o rei quando entrar e quando sair.
8 So Levi pipol and Judah men do as Priest Jehoiada tell dem. Di kommander gada all di men wey dey duty and doz wey nor dey duty for dat Sabat Day.
8 Fizeram, pois, os levitas e todo o Judá segundo tudo quanto lhes ordenara o sacerdote Joiada; tomou cada um os seus homens, tanto os que entravam como os que saíam no sábado; porquanto o sacerdote Joiada não despediu os turnos.
9 Priest Jehoiada give di sojas King David spears and shields wey dey God Temple.
9 O sacerdote Joiada entregou aos capitães de cem as lanças, os paveses e os escudos que haviam sido do rei Davi e estavam na Casa de Deus.
10 E put all di men for pozishon with dia spear for dia hand. Dem line-up from di sout go rish nort for di temple and dem stand near di altar for di temple kon gada round di king.
10 Dispôs todo o povo, cada um de armas na mão, desde o lado direito da casa real até ao seu lado esquerdo, e até ao altar, e até ao templo, para rodear o rei.
11 Priest Jehoiada and en sons lead di king pikin kom out with di crown and king klot wey dem wear for en body. Dem make am king kon pour oil for en head dey shaut, “Make di king live forever!”
11 Então, trouxeram para fora o filho do rei, puseram-lhe a coroa, entregaram-lhe o Livro do Testemunho e o constituíram rei; Joiada e seus filhos o ungiram e gritaram: Viva o rei!
12 Wen Atalaya hear di royal guards dey shaut and praiz di king, e kon go where di pipol gada for di temple.
12 Ouvindo Atalia o clamor do povo que corria e louvava o rei, veio para onde este se achava na Casa do Senhor ;
13 E si di king stand near di pila for where dem take dey enter di temple. Di ofisas and doz wey dey blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land happy dey blow dia trumpet. Doz wey dey sing, dey der with difren instrument as dem dey lead di song. Atalaya tear en klot kon dey shaut, “Dis na wayo! Dis na wayo!”
13 olhou, e eis que o rei estava junto à coluna, à entrada, e os capitães e os que tocavam trombetas, junto ao rei; e todo o povo da terra se alegrava, e se tocavam trombetas. Também os cantores com os instrumentos músicos dirigiam o canto de louvores. Então, Atalia rasgou os seus vestidos e clamou: Traição! Traição!
14 Priest Jehoiada koll di ofisas oga kon tell dem, “Make una karry am go outside di temple kon gi-am to di guards. Make una kill anybody wey won stop una.” Di priest do like dis, bikos e nor wont make dem kill-am for inside God Temple.
14 Porém o sacerdote Joiada trouxe para fora os capitães que comandavam as tropas e disse-lhes: Fazei-a sair por entre as fileiras; se alguém a seguir, matai-o à espada. Porque o sacerdote tinha dito: Não a matem na Casa do Senhor .
15 Dem seize Atalaya, karry am go di palis kon kill-am for di horse gate.
15 Lançaram mão dela; e ela, pelo caminho da entrada dos cavalos, foi à casa do rei, onde a mataram.
16 Priest Jehoiada kon make kovenant sey en with all di pipol and di king go dey obey God.
16 Joiada fez aliança entre si mesmo, o povo e o rei, para serem eles o povo do Senhor .
17 All di pipol kon go distroy di juju temple. Dem skata di altar with all di juju wey dey inside. Dem kill Mattan wey bi Baal priest for di altar front.
17 Então, todo o povo se dirigiu para a casa de Baal e a derribaram; despedaçaram os seus altares e as suas imagens e a Matã, sacerdote de Baal, mataram perante os altares.
18 Priest Jehoiada put di priest and Levi pipol make dem dey work for di temple. E sey make dem do di duty wey King David give dem and burn di sakrifice wey dem give God with joy kon dey play music, just as dem rite am for Moses Law.
18 Entregou Joiada a superintendência da Casa do Senhor nas mãos dos sacerdotes levitas, a quem Davi designara para o encargo da Casa do Senhor , para oferecerem os holocaustos do Senhor , como está escrito na Lei de Moisés, com alegria e com canto, segundo a instituição de Davi.
19 Priest Jehoiada still put guards for God temple gate, so dat doz wey dey plan bad tin against di king, nor go fit enter di temple.
19 Colocou porteiros às portas da Casa do Senhor , para que nela não entrasse ninguém que de qualquer forma fosse imundo.
20 E koll di soja ofisas, di eldas, doz wey dey rule di pipol and all di pipol for di land, den kon lead di king komot from God Temple. Dem use di gate for up take enter di palis and di king kon sidan for en throne.
20 Tomou os capitães de cem, os nobres, os governadores do povo e todo o povo da terra, e todos estes conduziram, da Casa do Senhor , o rei; passaram, pela porta superior, para a casa do rei e assentaram o rei no trono do reino.
21 Di pipol for di land kon dey celebrate, bikos since dem kill Atalaya, di town kon get peace.
21 Alegrou-se todo o povo da terra, e a cidade ficou tranquila, pois haviam matado Atalia à espada.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Crônicas 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.