Zacarias 9
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Na Oga God give mi dis message against Hadrak and Damaskus town.
1 A palavra do Senhor está contra a terra de Hadraque, e repousará sobre Damasco, pois ao Senhor pertencem as cidades de Arã, e todas as tribos de Israel.
2 God go judge di pipol wey dey Hamat with Damaskus, Tyre and Sidon pipol wey share boundary with dem, bikos dem tink sey dem wise well-well.
2 E também Hamate que confina com ela, e Tiro e Sidom, ainda que sejam mui sábias.
3 Tyre pipol build strong house for demsef kon gada many gold and silva like sey na san-san!
3 Ora Tiro edificou para si fortalezas, e amontoou prata como o pó, e ouro como a lama das ruas.
4 But God go take evritin wey dem get from dem. E go trow all dia propaty for sea and dem go burn di town rish groun.
4 Eis que o Senhor a despojará, e ferirá o seu poder no mar; e ela será consumida pelo fogo.
5 Ashkelon pipol go si all dis tins and fear go katch dem. Wen Gaza pipol go si dis tins, dem go bigin shake. Even Ekron pipol nor go get hope again. Dem go kill Gaza king kon distroy and skata Ashkelon town.
5 Asquelom o verá, e temerá; também Gaza, e terá grande dor; igualmente Ecrom, porque a sua esperança será iludida; e de Gaza perecerá o rei, e Asquelom não será habitada.
6 Na strenjas go stay for Ashdod town and I go really distroy Filistia pipol, bikos dem too dey karry body up.
6 Povo mestiço habitará em Asdode; e exterminarei a soberba dos filisteus.
7 “Dem nor go chop meat wey nor get blood again or food wey my pipol dey forbid. All di pipol wey survive, go bi my pipol too and dem go bi one family for Judah. Ekron pipol go bi my own too, just like Jebus pipol.
7 E da sua boca tirarei o sangue, e dentre os seus dentes as abominações; e ele também ficará como um resto para o nosso Deus; e será como chefe em Judá, e Ecrom como um jebuseu.
8 Den I go surround and guide my temple both for back and front. I nor go allow wiked rulers opress my pipol again, bikos naw, I don si how my pipol sofa rish.”
8 Ao redor da minha casa acamparei contra o exército, para que ninguém passe, nem volte; e não passará mais por eles o opressor; pois agora vi com os meus olhos.
9 Zion pipol! Make una happy well-well!
9 Alegra-te muito, ó filha de Sião; exulta, ó filha de Jerusalém; eis que vem a ti o teu rei; ele é justo e traz a salvação; ele é humilde e vem montado sobre um jumento, sobre um jumentinho, filho de jumenta.
10 God sey,
10 De Efraim exterminarei os carros, e de Jerusalém os cavalos, e o arco de guerra será destruído, e ele anunciará paz às nações; e o seu domínio se estenderá de mar a mar, e desde o Rio até as extremidades da terra.
11 God sey, “Bikos of di sakrifice and blood kovenant wey I make with una, I go free una pipol from slave work.
11 Ainda quanto a ti, por causa do sangue do teu pacto, libertei os teus presos da cova em que não havia água.
12 Israel pipol wey bi prisonas, make una kom back, bikos una don get hope. Make una kom back to di place where una go for dey save. I dey tell una naw sey, ‘I go give una doubol blessing, bikos of how una don sofa.’
12 Voltai à fortaleza, ó presos de esperança; também hoje anuncio que te recompensarei em dobro.
13 I go use Judah pipol take do bow and Israel pipol go bi my arrow. Zion men go bi my swod wey I go take distroy Greece pipol.”
13 Pois curvei Judá por meu arco, pus-lhe Efraim por seta; suscitarei a teus filhos, ó Sião, contra os teus filhos, ó Grécia; e te farei a ti, ó Sião, como a espada de um valente.
14 God go appear on-top en pipol; E go shot en arrow like tonda lite. God wey get pawa go blow di trumpet; E go mash kom from sout under one heavy rain.
14 Por cima deles será visto o Senhor; e a sua flecha sairá como o relâmpago; e o Senhor Deus fará soar a trombeta, e irá com redemoinhos do sul.
15 Oga God wey get pawa go protet en pipol and dem go distroy dia enemies. Dem go dey shaut for war like who drink dey katch and dem go kill dia enemies finish. Dia enemies blood go plenty well-well like sakrifice blood wey dem pour put for di altar.
15 O Senhor dos exércitos os protegerá; e eles devorarão, e pisarão os fundibulários; também beberão o sangue deles como ao vinho; e encher-se-ão como bacias de sacrifício, como os cantos do altar.
16 Wen dat day rish, just as shepad dey save en animals from danger, na so too Oga God go save en pipol. Dem go shine for en land like crown wey dem make with gold.
16 E o Senhor seu Deus naquele dia os salvará, como o rebanho do seu povo; porque eles serão como as pedras de uma coroa, elevadas sobre a terra dele.
17 Dem go dey good and fine well-well! Di korn and wine wey di yong pipol go dey chop and drink, go make dem grow and dey strong.
17 Pois quão grande é a sua bondade, e quão grande é a sua formosura! o trigo fará florescer os mancebos e o mosto as donzelas.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Zacarias 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.