Zacarias 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Den Oga God wey dey lead heaven sojas give Zekaraya dis message:
1 Mais uma vez veio a mim a palavra do Senhor dos Exércitos:
2 “Dis na wetin God wey dey lead heaven soja tok: ‘I dey always like to bless Zion, bikos of di strong love wey I get for en pipol and na dis love dey make mi vex for dia enemies.’ ”
2 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Tenho muito ciúme de Sião; estou me consumindo de ciúmes por ela".
3 And naw, Oga God sey, “I dey go back to Jerusalem kon stay for Zion wey bi my holy town. Den pipol go koll Jerusalem ‘Di town wey dey faithful’ and dem go koll Oga God mountin, ‘Di holy mountin.’ ”
3 Assim diz o Senhor: "Estou voltando para Sião e habitarei em Jerusalém. Então Jerusalém será chamada Cidade da Verdade, e o monte do Senhor dos Exércitos será chamado Monte Sagrado".
4 Oga God wey get pawa sey, “Old men and wimen wey dey Jerusalem, go waka round di town with dia walkin stik and dem go sidan for di town centre again.
4 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Homens e mulheres de idade avançada voltarão a sentar-se nas praças de Jerusalém, cada um com sua bengala, por causa da idade.
5 Boys and girls go full di strits kon dey play again.”
5 As ruas da cidade ficarão cheias de meninos e meninas brincando".
6 God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol wey remain fit tink sey all dis tins nor dey possibol, but with mi wey bi Oga God wey get pawa well-well, evritin dey possibol.”
6 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Mesmo que isso pareça impossível para o remanescente deste povo naquela época, será impossível para mim? ", declara o Senhor dos Exércitos.
7 God wey dey lead heaven sojas sey, “My pipol, make una dey sure sey I go save una from di land wey dey east and west.
7 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Salvarei meu povo dos países do leste e do oeste.
8 I go bring una kom back to una house and una go get peace for Jerusalem. Una go bi my pipol and I go bi una God wey go rule and judge una well.”
8 Eu os trarei de volta para que habitem em Jerusalém; serão meu povo e eu serei o Deus deles, com fidelidade e justiça".
9 God wey dey lead heaven sojas sey, “Make una dey strong kon finish di work! Na since dem start to build God Temple, una don hear wetin di profets dey tok about how di temple work go take komplete.
9 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Vocês que estão ouvindo hoje estas palavras já proferidas pelos profetas quando foram lançados os alicerces do templo do Senhor dos Exércitos, fortaleçam as mãos para que o templo seja construído.
10 Before dat time, nobody get money to hire men or animals and nobody dey save from en enemies, bikos na mi God turn pipol against each oda.”
10 Pois antes daquele tempo não havia salários para os homens nem para os animais. Ninguém podia tratar os seus negócios com segurança por causa de seus adversários, porque eu tinha posto cada um contra o seu próximo.
11 But naw, God wey dey lead heaven sojas sey, “As for my pipol wey remain, I go dey trit dem well.
11 Mas agora não vou mais tratar com o remanescente deste povo como fiz no passado", declara o Senhor dos Exércitos.
12 Nobody go wahala dem wen dem dey plant dia seed. Dia vine go get many fruits; di groun go produce food and rain go always dey fall for dem. I go give all dis blessings to my pipol wey remain.
12 "Haverá uma rica semeadura, a videira dará o seu fruto, a terra produzirá suas colheitas e o céu derramará o orvalho. E darei todas essas coisas como uma herança ao remanescente deste povo.
13 Judah and Israel pipol! Before-before, strenjas dey curse diasef sey, ‘Make di kind wahala wey fall press Judah and Israel pipol, fall press yu!’ But I go save una and doz strenjas go still tell each oda sey, ‘Make yu receive di same blessing wey Judah and Israel pipol get!’ So make una get hope and nor fear.”
13 Assim como vocês foram uma maldição para as nações, ó Judá e Israel, também os salvarei e vocês serão uma bênção. Não tenham medo, antes sejam fortes. "
14 Oga God sey, “I plan to distroy una grand-grand papa dem wen dem make mi vex and I do just as I plan.
14 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Assim como eu havia decidido castigar vocês sem compaixão quando os seus antepassados me enfureceram", diz o Senhor dos Exércitos,
15 But naw, I dey plan to bless Judah and Jerusalem pipol. So make una nor fear.
15 "também agora decidi fazer de novo o bem a Jerusalém e a Judá. Não tenham medo!
16 But dis na wetin una go do: ‘Make una always dey tell each oda di trut. Make una judge well, di kind judgement wey dey bring peace.
16 Eis o que devem fazer: Falem somente a verdade uns com os outros, e julguem retamente em seus tribunais;
17 Make una nor plan bad against each oda or swear as una dey tok wetin una eye nor si. I hate lie, opreshon and doz wey dey kause wahala.’ ”
17 não planejem no íntimo o mal contra o seu próximo, e não queiram jurar com falsidade. Porque eu odeio todas essas coisas", declara o Senhor.
18 Oga God tell Zekaraya sey,
18 Mais uma vez veio a mim a palavra do Senhor dos Exércitos.
19 “Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”
19 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Os jejuns do quarto, do quinto, do sétimo e do décimo meses serão ocasiões alegres e cheias de júbilo, festas felizes para o povo de Judá. Por isso amem a verdade e a paz".
20 Oga God wey dey rule ova evritin sey, “Di time dey kom wen pipol from difren kountries go kom Jerusalem.
20 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Povos e habitantes de muitas cidades ainda virão,
21 Pipol from one kountry go tell doz from anoda kountry sey, ‘Wi dey go woship Oga God wey get pawa kon pray make E bless us. So make una kom follow us go!’
21 e os habitantes de uma cidade irão a outra e dirão: ‘Vamos logo suplicar o favor do Senhor e buscar o Senhor dos Exércitos. Eu mesmo já estou indo’.
22 Many pipol and strong nashons go kom Jerusalem kon woship and pray to God wey get pawa, so dat E go bless dem.”
22 E muitos povos e nações poderosas virão buscar o Senhor dos Exércitos em Jerusalém e suplicar o seu favor".
23 God wey dey lead heaven sojas sey, “For dat time, ten strenjas go kom meet one Jew pesin sey, ‘Wi won share from yor blessings, bikos wi hear sey God dey with yu.’ ”
23 Assim diz o Senhor dos Exércitos: "Naqueles dias, dez homens de todas as línguas e nações agarrarão firmemente a barra das vestes de um judeu e dirão: ‘Nós vamos com você porque ouvimos dizer que Deus está com vocês’ ".

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Zacarias 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.