Zacarias 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 I look up again and dis time, I si four shariot dey kom out from di centre for two bronze mountin.
1 E outra vez levantei os meus olhos, e olhei, e vi quatro carros que saíram dentre dois montes, e estes montes eram montes de metal.
2 Na red horses dey drag di first shariot, while black horses dey drag di sekond shariot.
2 No primeiro carro, eram os cavalos vermelhos, e, no segundo carro, cavalos pretos.
3 Na white horses dey drag di third one and na horses wey get spots for body dey drag di fourt one.
3 E, no terceiro carro, cavalos brancos, e, no quarto carro, cavalos grisalhos e fortes.
4 Den I ask di angel wey dey tok to mi, “My oga! Na wetin dis shariot dem mean?”
4 E respondi e disse ao anjo que falava comigo: Que é isto, Senhor meu?
5 E ansa, “Dis na di four spirit for heaven wey dey stand for God wey kreate di world front.” Dem dey go do en work.
5 E o anjo respondeu e me disse: Estes são os quatro ventos do céu, saindo donde estavam perante o Senhor de toda a terra.
6 Di shariot wey di black horse dey drag, dey go nort; di white horse dey go west and di horse wey get spots dey go di kountries for sout.
6 O carro em que estão os cavalos pretos sai para a terra do Norte, e os brancos saem atrás deles, e os grisalhos saem para a terra do Sul.
7 As di strong horse dem kom out, dem rush dey go patrol di eart. Di angel kon tell dem, “Make una go patrol di eart well-well!” So dem kon go.
7 E os cavalos fortes saíam e procuravam ir por diante, para andarem pela terra. E ele disse: Ide, andai pela terra. E andavam pela terra.
8 Den Oga God koll and tell mi, “Si, di shariot wey go di nort side don make mi stop to vex for di pipol for di land.”
8 E me chamou e me falou, dizendo: Eis que aqueles que saíram para a terra do Norte fizeram repousar o meu Espírito na terra do Norte.
9 God give mi dis message:
9 E a palavra do Senhor veio a mim, dizendo:
10 “Make yu take Heldai, Tobaya and Jedaya wey kom back from Babilon with di oda pipol, den go meet Josaya wey bi Zefanaya pikin for en house.
10 Recebe dos que foram levados cativos: de Heldai, de Tobias e de Jedaías (e vem naquele dia e entra na casa de Josias, filho de Sofonias), os quais vieram da Babilônia;
11 Yu go use di silva and gold wey dem bring as gift take make crown, den crown Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
11 recebe, digo, prata e ouro, e faze coroas, e põe-nas na cabeça de Josué, filho de Jozadaque, sumo sacerdote.
12 Make yu tell am, ‘God wey get pawa sey, “Dis na di man wey dem dey koll di Branch, e go prosper kon build God temple again.
12 E fala-lhe, dizendo: Assim fala e diz o Senhor dos Exércitos: Eis aqui o homem cujo nome é Renovo; ele brotará do seu lugar e edificará o templo do Senhor .
13 Naim go build di temple kon take di praiz wey suppose bi di king own and e go rule en pipol. One priest go stand near en throne and dem go work togeda with peace and undastandin.
13 Ele mesmo edificará o templo do Senhor , e levará a glória, e assentar-se-á, e dominará no seu trono, e será sacerdote no seu trono, e conselho de paz haverá entre ambos.
14 Na di crown dem go take honor and remember Heldai, Tobijah, Jedaya and Josaya for God temple.
14 E estas coroas serão de Helém, e de Tobias, e de Jedaías, e de Hem, filho de Sofonias, como um memorial no templo do Senhor .
15 Pipol from far go kom join build God temple again. And wen dem don build am finish, yu go know sey na God wey dey mighty send mi kom meet yu. All dis tins go happen if yu use yor whole heart take obey all wetin di Oga yor God kommand yu.” ’ ”
15 E aqueles que estão longe virão e edificarão no templo do Senhor , e vós sabereis que o Senhor dos Exércitos me tem enviado a vós; e isso acontecerá, se ouvirdes mui atentos a voz do Senhor , vosso Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Zacarias 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.