Zacarias 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 Den di angel wey bin dey tok to mi kom back kon wake mi just as dem dey wake pesin wey dey sleep.
1 E o anjo que falava comigo veio novamente, e despertou-me, como a um homem que é despertado do seu sono,
2 E ask mi, “Wetin yu si naw?” I ansa, “Na one lampstand wey dem make with gold, wey get bowl where dem dey pour oil put. Seven lamps dey on-top di lampstand and each one get seven whole for di wick.
2 e disse-me: O que vês? E eu disse: Eu olhei, e eis que vejo um castiçal todo de ouro, com um vaso no seu topo, e com sete lâmpadas sobre ele, e sete canudos para as sete lâmpadas que estão no seu topo.
3 Two olive tree dey near di lampstand too; one for each side.”
3 E duas oliveiras junto a ele, uma do lado direito do vaso, e a outra do lado esquerdo.
4 Den I ask di angel wey tok to mi, “My oga, wetin dis tins mean?”
4 Então respondi, dizendo ao anjo que falava comigo: O que é isto, meu senhor?
5 E ansa, “So yu nor know wetin all dis tins mean?” I ansa, “No o-o, my oga! I nor know.”
5 Então o anjo que falava comigo respondeu e disse-me: Não sabes o que é isto? E eu disse: Não, meu senhor.
6 Den e tell mi, “Dis na wetin Oga God dey tell Zerubabel: ‘Nor bi with force or human being bin pawa, but na with my Spirit.’
6 Então ele respondeu e falou-me, dizendo: Esta é a palavra do SENHOR a Zorobabel, dizendo: Não por força, nem por poder, mas pelo meu Espírito, diz o SENHOR dos Exércitos.
7 “Even di strongest mountin nor go fit stand fight Zerubabel, bikos di mountin go turn ordinary groun for en front! And wen Zerubabel don put di final stone for where e suppose dey for di temple, di pipol go shaut, ‘Make God bless am! Make God bless di temple well-well!’ ”
7 Quem és tu, ó grande monte? Diante de Zorobabel te tornarás uma planície; e ele trará a pedra angular com brados e clamores: Graça, graça a ela.
8 Den God tell mi anoda message:
8 Ademais, a palavra do SENHOR veio a mim, dizendo:
9 “Na Zerubabel start di temple foundashon and na-im go komplete am. Dat time, una go know sey na Oga God send mi kom.
9 As mãos de Zorobabel estabeleceram a fundação desta casa; as suas mãos também a finalizarão; para que saibais que o SENHOR dos Exércitos enviou-me a vós.
10 Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)
10 Pois quem despreza o dia das coisas pequenas? Pois eles se alegrarão, e verão o prumo na mão de Zorobabel com aqueles sete; eles são os olhos do SENHOR, que percorrem a terra de um canto para outro.
11 Den I ask di angel, “Na wetin bi dis two olive tree wey dey each side for di lampstand
11 Então respondi, dizendo-lhe: O que são essas duas oliveiras do lado direito e esquerdo do castiçal?
12 and di two olive branches wey dey pour gold oil kom out from di two gold pipe?”
12 E respondendo-lhe outra vez, disse: O que são esses dois ramos de oliveira que, através de dois canos dourados, escorrem de si o óleo dourado?
13 Di angel ansa, “So yu nor know wetin dem mean?” I ansa, “No o-o, my oga! I nor know.”
13 E ele me respondeu e disse: Não sabes o que é isso? E eu disse: Não, meu senhor.
14 Den e tell mi, “Na dem bi di two pesin wey dem anoint for heaven to serve Oga wey bi God for di whole eart.”
14 Então ele disse: Estes são os dois ungidos, que estão diante do Senhor de toda a terra.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Zacarias 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.