Zacarias 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Den I look again kon si one man whole ruler wey dem take dey measure.
1 Tornei a levantar os meus olhos, e olhei, e eis um homem que tinha na mão um cordel de medir.
2 So I ask am, “Where yu dey go?” E ansa, “I dey go measure Jerusalem, make I for know as e wide and long rish.”
2 Então perguntei: Para onde vais tu? Respondeu-me ele: Para medir Jerusalém, a fim de ver qual é a sua largura e qual o seu comprimento.
3 Den di angel wey dey tok to mi kon waka go front and anoda angel kom meet am.
3 E eis que saiu o anjo que falava comigo, e outro anjo lhe saiu ao encontro,
4 Di first angel kon tell di sekond one, “Make yu run go tell di man wey whole di ruler sey, ‘Very soon, pipol and animals go plenty for Jerusalem, sotey di town nor go fit kontain dem again.’
4 e lhe disse: Corre, fala a este mancebo, dizendo: Jerusalém será habitada como as aldeias sem muros, por causa da multidão, nela, dos homens e dos animais.
5 God don promise sey na en go bi di fire wey surround di town like wall kon protet en pipol and E go stay der with all en glory.”
5 Pois eu, diz o Senhor, lhe serei um muro de fogo em redor, e eu, no meio dela, lhe serei a glória.
6 God tell en pipol, “Pipol wey dey nort, make una run, bikos I don skata una go evriwhere.
6 Ah, ah! fugi agora da terra do norte, diz o Senhor, porque vos espalhei como os quatro ventos do céu, diz o Senhor.
7 Zion pipol, make una eskape and run komot Babilon!
7 Ah! Escapai para Sião, vós que habitais com a filha de Babilônia.
8 Bikos Oga God wey dey rule ova evritin tell mi sey, na bikos of en own glory E send mi go di nashons wey bin distroy una, bikos anybody wey tosh una, don tosh di pipol wey E love well-well.”
8 Pois assim diz o Senhor dos exércitos: Para obter a glória ele me enviou às nações que vos despojaram; porque aquele que tocar em vós toca na menina do seu olho.
9 God sey, “I go ponish dem well-well and na dia own slave go distroy and pak dia propaty.” Den una go know sey na Oga God wey dey rule ova evritin send mi kom.
9 Porque eis aí levantarei a minha mão contra eles, e eles virão a ser a presa daqueles que os serviram; assim sabereis vós que o Senhor dos exércitos me enviou.
10 So Zion pipol, make una shaut and happy as una dey sing, bikos I dey kom meet and stay with una.
10 Exulta, e alegra-te, ó filha de Sião; pois eis que venho, e habitarei no meio de ti, diz o Senhor.
11 For dat time, many nashons go kom meet God and dem go bi en pipol. God go stay with una, den una go know sey na God send mi kom.
11 E naquele dia muitas nações se ajuntarão ao Senhor, e serão o meu povo; e habitarei no meio de ti, e saberás que o Senhor dos exércitos me enviou a ti.
12 Judah go bi God special propaty for en holy land again, den Jerusalem go bi di town wey God choose.
12 Então o Senhor possuirá a Judá como sua porção na terra santa, e ainda escolherá a Jerusalém.
13 So, make evribody kwayet for God present, bikos E dey kom from en holy place.
13 Cale-se, toda a carne, diante do Senhor; porque ele se levantou da sua santa morada.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Zacarias 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.