Zacarias 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 For di eight mont for di sekond year wey Darius dey rule for Persia, God give dis message to Profet Zekaraya, Berekaya pikin wey Iddo bi en grand-papa.
1 No oitavo mês do segundo ano de Dario veio a palavra do Senhor ao profeta Zacarias, filho de Berequias, filho de Ido, dizendo:
2 Mi wey bi God, bin dey vex well-well for una grand-grand papa dem,
2 O Senhor se irou fortemente contra vossos pais.
3 so make yu tell di pipol sey, “Dis na wetin God wey dey lead heaven sojas tok: ‘Make una turn kom meet mi and I go kom meet una too, dis na wetin Oga God wey dey rule ova evritin, tok.’
3 Portanto dize-lhes: Assim diz o Senhor dos exércitos: Tornai-vos para mim, diz o Senhor dos exércitos, e eu me tornarei para vós, diz o Senhor dos exércitos.
4 Make una nor bi like una grand-grand papa dem. Before-before, my profets prish give dem sey, make dem stop to sin and do evil, but dem nor gri listin or obey dem.
4 Não sejais como vossos pais, aos quais clamavam os profetas antigos, dizendo: Assim diz o Senhor dos exércitos: Convertei-vos agora dos vossos maus caminhos e das vossas más obras; mas não ouviram, nem me atenderam, diz o Senhor.
5 Where una grand-grand papa dem naw? Dem with di profets don die since.
5 Vossos pais, onde estão eles? E os profetas, viverão eles para sempre?
6 But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”
6 Contudo as minhas palavras e os meus estatutos, que eu ordenei pelos profetas, meus servos, acaso não alcançaram a vossos pais? E eles se arrependeram, e disseram: Assim como o Senhor dos exércitos fez tenção de nos tratar, segundo os nossos caminhos, e segundo as nossas obras, assim ele nos tratou.
7 For di sekond year wey Darius dey rule, for di twenty fourt day, for di elevent mont wey bi Shebat, God give dis message to Zekaraya, Berekaya pikin wey Iddo bi en grand-papa.
7 Aos vinte e quatro dias do mês undécimo, que é o mês de sebate, no segundo ano de Dario, veio a palavra do Senhor ao profeta Zacarias, filho de Berequias, filho de Ido, dizendo:
8 For inside vishon dat nite, I si one man dey ride one red horse, den e stop for one valley wey trees full and I kon si anoda red, brown and white horse wey get black spot for body, dey follow am for back.
8 Olhei de noite, e vi um homem montado num cavalo vermelho, e ele estava parado entre as murtas que se achavam no vale; e atrás dele estavam cavalos vermelhos, baios e brancos.
9 Den I ask, “Oga God, wetin all dis horse mean?” E ansa, “I go show yu wetin dem mean.”
9 Então perguntei: Meu Senhor, quem são estes? Respondeu-me o anjo que falava comigo: Eu te mostrarei o que estes são.
10 Den di man wey stand near di myrtle tree kon sey, “Na God send dem make dem go look how di eart bi.”
10 Respondeu, pois, o homem que estava parado entre as murtas, e disse: Estes são os que o Senhor tem enviado para percorrerem a terra.
11 So dem go back kon tell di angel, “Wi don go round di eart kon si sey peace dey evriwhere.”
11 E eles responderam ao anjo do Senhor, que estava parado entre as murtas, e disseram: Nós temos percorrido a terra, e eis que a terra toda está tranqüila e em descanso.
12 Den di angel pray to God, “Oga God wey dey mighty, Yu don dey vex for Jerusalem and Judah town for seventy years naw. How long e go take before Yu go sorry for dem?”
12 Então o anjo do Senhor respondeu, e disse: O Senhor dos exércitos, até quando não terás compaixão de Jerusalém, e das cidades de Judá, contra as quais estiveste indignado estes setenta anos?
13 So God ansa di angel wey dey tok to mi with words wey dey make belle sweet pesin.
13 Respondeu o Senhor ao anjo que falava comigo, com palavras boas, palavras consoladoras.
14 So di angel kon tell mi, “Make yu go tell evribody wetin God tok, ‘I love and dey koncern about Jerusalem and Zion wey bi my holy town,
14 O anjo, pois, que falava comigo, disse-me: Clama, dizendo: Assim diz o Senhor dos exércitos: Com grande zelo estou zelando por Jerusalém e por Sião.
15 but I dey vex for di nashons wey feel sey dem dey save. Bikos as I dey try make I nor vex for my pipol, doz nashons dey make my pipol sofa more-more.
15 E estou grandemente indignado contra as nações em descanso; porque eu estava um pouco indignado, mas eles agravaram o mal.
16 “ ‘So I don kom back to Jerusalem town kon show dem mesi. Dem go build my temple and di town again.’ ”
16 Portanto, o Senhor diz assim: Voltei-me, agora, para Jerusalém com misericórdia; nela será edificada a minha casa, diz o Senhor dos exércitos, e o cordel será estendido sobre Jerusalém.
17 Di angel still sey: “God go help Jerusalem and make di town prosper again and di town go bi en own.”
17 Clama outra vez, dizendo: Assim diz o Senhor dos exércitos: As minhas cidades ainda se transbordarão de bens; e o Senhor ainda consolará a Sião, e ainda escolherá a Jerusalém.
18 Den wen I look up again, I kon si four horns.
18 Levantei os meus olhos, e olhei, e eis quatro chifres.
19 I ask di angel wey dey tok to mi, “Wetin dis horn dem mean?” E ansa, “Dem stand for di wiked pawas for di world wey skata Judah, Israel and Jerusalem pipol.”
19 Eu perguntei ao anjo que falava comigo: Que é isto? Ele me respondeu: Estes são os chifres que dispersaram a Judá, a Israel e a Jerusalém.
20 Den God kon show mi four men wey bi karpenter.
20 O Senhor mostrou-me também quatro ferreiros.
21 I kon ask, “Wetin dis men dey kom do?” E ansa, “Dem dey kom treaten Judah enemies and skata di horns wey won distroy Judah pipol.”
21 Então perguntei: Que vêm estes a fazer? Ele respondeu, dizendo: Estes são os chifres que dispersaram Judá, de maneira que ninguém levantou a cabeça; mas estes vieram para os amedrontarem, para derrubarem os chifres das nações que levantaram os seus chifres contra a terra de Judá, a fim de a espalharem.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Zacarias 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.