Zacarias 14
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Di day wen God go judge en pipol don near. Den, dem go tif all di propaty wey dey Jerusalem kon divide di tins wey dem tif for una present.
1 Eis que vem o dia do Senhor, em que os teus despojos serão divididos no meio de ti.
2 God go gada all di nashons go fight Jerusalem. Dem go attack di town, tif evritin from all di house, den rape di wimen. Dem go karry some of di pipol go anoda land as slave, but dem nor go take evribody komot from di town.
2 Juntarei todas as nações ao redor de Jerusalém: a cidade será atacada e tomada, as casas serão destruídas, as mulheres, violadas; metade da cidade irá para o cativeiro, mas o resto do povo não será expulso.
3 Den God go-go fight against doz nashons, just as E fight before.
3 Então sairá o Senhor e pelejará contra aquelas nações: ele combaterá como {o sabe} fazer em tempo de guerra.
4 For dat time, E go stand on-top Mount Olives kon face di east side for Jerusalem. Den Mount Olives go divide into two from east go west. Half part for di mountin go-go nort and di remainin part go-go sout.
4 Naquele dia os seus pés se apoiarão no monte das Oliveiras, defronte de Jerusalém, para o lado do oriente, e o monte dividir-se-á em dois pelo meio, do oriente ao ocidente, formando assim um grande vale. Uma metade do monte se afastará para o norte, a outra para o sul.
5 Una go from dis valley go di mountin kon eskape go di oda side. Una go run, just as una grand-grand papa dem do wen groun open for di time wen Uzzaya bi king for Judah. Den all di angels go follow Oga God wen E dey kom.
5 Fugireis pelo vale aberto entre as montanhas, porque este vale se prolongará até o lugar do julgamento; e fugireis como fugistes do terremoto no tempo de Ozias, rei de Judá. Então aparecerá o Senhor vosso Deus, com todos os seus santos.
6 For dat day, lite nor go shine again; di place wey dey bring lite from heaven, go stop.
6 Naquele dia não haverá frio nem gelo.
7 But e go happen for one special day and na only Oga God know di day. Normal day and nite go dey and even wen evening rish, lite go still dey shine like day time.
7 Será um dia contínuo {conhecido somente do Senhor}, e não haverá sucessão de dia e noite, e a noite será clara.
8 For dat day, na only fresh wota go dey rush kom out from Jerusalem. Half go-go di Dead Sea and di oda half go-go Mediterranean Sea. E go dey rush both for dry and rainin sizin.
8 Naquele dia jorrará água corrente de Jerusalém, metade para o mar do nascente e metade para o mar do poente; jorrará tanto no verão como no inverno.
9 Den God go bi king for all di eart; evribody go woship and know am as God.
9 O Senhor reinará sobre toda a terra. Naquele dia o Senhor será o único Deus e só o seu nome será invocado.
10 All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.
10 Toda a terra será aplanada, desde Gabaa até Remon, ao sul de Jerusalém. Jerusalém acupará o seu lugar, e dominará desde a porta de Benjamim até o lugar da Primeira Porta, até a Porta do Ângulo, e desde a torre de Hananeel até os lagares do rei.
11 Di pipol go stay and dey save for der and bad tin nor go happen to dem again.
11 Habitarão nela e não haverá mais interdito: Jerusalém estará verdadeiramente em segurança.
12 God go bring wiked diziz kom all di nashons wey fight against Jerusalem. Dia flesh go dey rotin even wen dem still dey alive; even dia eyes and tongue go rotin too.
12 Eis a praga com que o Senhor vai ferir todos os povos que atacaram Jerusalém: apodrecerá sua carne, estando eles ainda de pé; seus olhos apodrecerão dentro de suas órbitas, e apodrecer-lhes-á a língua dentro da boca.
13 For dat day, God go konfuse dem well-well and fear go katch dem, sotey dem go bigin seize and attack demsef.
13 Naquele dia o Senhor semeará o pânico no meio deles, de sorte que se atacarão mutuamente, e levantarão as mãos uns contra os outros.
14 Judah men sef go dey fight and defend Jerusalem. Dem go take all di oda nashons propaty plus dia gold, silva and all dia many klot.
14 Também Judá combaterá em Jerusalém; juntar-se-ão as riquezas de todas as nações vizinhas: ouro, prata e vestes em grande quantidade.
15 Wiked diziz go katch all di horse, melu, kamel, donkey and di oda animals wey dey di enemies kamp.
15 Cavalos, mulos, camelos, jumentos, e todo animal que se encontrar nos campos, serão feridos com a mesma praga.
16 Den all di pipol wey survive for di nashons wey attack Jerusalem go dey go der evry year go woship Oga God wey dey mighty and wey bi king and dem go still join celebrate Shelta Feast.
16 Os que restarem de todas as nações que tiverem atacado Jerusalém virão todos os anos adorar o rei, Senhor dos exércitos, e celebrar a festa dos Tabernáculos.
17 If any nashon nor gri go woship Oga God wey bi King, wey dey lead heaven sojas, rain nor go fall for dia land.
17 Toda e qualquer família da terra que não subir a Jerusalém para adorar o rei, Senhor dos exércitos, não receberá chuva!
18 If Egypt pipol nor gri celebrate Shelta Feast, di same diziz wey God send go all di nashons wey nor gri celebrate di feast, go katch dem too.
18 Se a família do Egito não subir nem vier, não haverá chuva para ela, mas será ferida com a praga com que o Senhor ferirá todas as nações que não subirem a Jerusalém para celebrar a festa dos Tabernáculos.
19 If Egypt pipol and all di oda nashons nor gri celebrate di Shelta Feast, all dis ponishment go follow dem.
19 Este será o castigo do Egito, como também de toda nação que não subir para celebrar a festa dos Tabernáculos.
20 For dat day, dem go rite sey, “Na Oga God Dey holy.” Di pot wey dey God temple go dey holy, just as di basin wey dey di altar front.
20 Naquele dia escrever-se-á até mesmo nos chocalhos dos cavalos: consagrado ao Senhor. Os caldeirões ordinários do templo do Senhor serão consagrados como as taças do altar.
21 Di pots wey dem take dey kook for Jerusalem and Judah go dey holy before di Oga awa God wey get pawa, so dat doz wey dey kom offa sakrifice, go use dem take kook dia sakrifice. For dat day, di pipol from Kanaan wey dey sell inside Oga God Temple, nor go ever dey for awa God house again.
21 Todo caldeirão, tanto em Jerusalém como em Judá, será consagrado ao Senhor dos exércitos; todo aquele que vier oferecer sacrifício poderá servir-se deles para cozinhar; e não haverá mais traficantes naqueles dias na casa do Senhor dos exércitos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Zacarias 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.