Tito 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Make yu remind di bilivers sey, make dem respet doz wey dey rule dem. Dem must obey and dey ready to do good.
1 Admoesta-os a que se sujeitem aos principados e potestades, que lhes obedeçam, e estejam preparados para toda a boa obra;
2 Make dem nor ever tok bad about anybody, instead make dem dey live for peace, dey gentol and dey bihave well to evribody.
2 Que a ninguém infamem, nem sejam contenciosos, mas modestos, mostrando toda a mansidão para com todos os homens.
3 Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.
3 Porque também nós éramos noutro tempo insensatos, desobedientes, extraviados, servindo a várias concupiscências e deleites, vivendo em malícia e inveja, odiosos, odiando-nos uns aos outros.
4 But wen God awa Savior show us di kindness and love wey E get for us,
4 Mas quando apareceu a benignidade e amor de Deus, nosso Salvador, para com os homens,
5 E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.
5 Não pelas obras de justiça que houvéssemos feito, mas segundo a sua misericórdia, nos salvou pela lavagem da regeneração e da renovação do Espírito Santo,
6 God give us dis Spirit for free thru Jesus Christ wey bi awa Savior.
6 Que abundantemente ele derramou sobre nós por Jesus Cristo nosso Salvador;
7 Since Christ grace don make us klean for God eye, wi don bi pipol wey dey wait for di life wey nor go end and wi dey sure sey, wi go get am.
7 Para que, sendo justificados pela sua graça, sejamos feitos herdeiros segundo a esperança da vida eterna.
8 Dis word wey I dey tok so na trut and I wont make yu make sure sey evribody wey trust God dey do good. Dis tishing dey good and e go help evribody.
8 Fiel é a palavra, e isto quero que deveras afirmes, para que os que crêem em Deus procurem aplicar-se às boas obras; estas coisas são boas e proveitosas aos homens.
9 Nor put mout for word wey nor dey good: like matter wey koncern who born who and kworel or fight about Jew pipol law. All dis tin dey yuzles and dem nor mean anytin.
9 Mas não entres em questões loucas, genealogias e contendas, e nos debates acerca da lei; porque são coisas inúteis e vãs.
10 If anybody dey won kause kworel for di church and yu don warn am rish two times and e nor gri shange, den make yu drive am.
10 Ao homem hereje, depois de uma e outra admoestação, evita-o,
11 Bikos dat kind pesin don turn from di trut and en own sin go kondemn am.
11 Sabendo que esse tal está pervertido, e peca, estando já em si mesmo condenado.
12 If I send Artemas or Tikikus kom meet yu, make yu try kom meet mi for Nikopolis, bikos I don decide sey, na der I go stay until kold sizin go end.
12 Quando te enviar Ártemas, ou Tíquico, procura vir ter comigo a Nicópolis; porque deliberei invernar ali.
13 Make yu do evritin wey yu fit do to help Zenas, wey bi lawyer and Apollos for dia journey and make sure sey dem get evritin wey dem nid.
13 Acompanha com muito cuidado Zenas, doutor da lei, e Apolo, para que nada lhes falte.
14 Like dis too, awa pipol go learn how to do good and help pipol wey really nid help. And as dem dey do like dis, dem nor go live yuzles life.
14 E os nossos aprendam também a aplicar-se às boas obras, nas coisas necessárias, para que não sejam infrutuosos.
15 Evribody wey dey with mi dey greet yu! Make yu greet all di pipol wey love us. Make God grace dey with all of una.
15 Saúdam-te todos os que estão comigo. Saúda tu os que nos amam na fé. A graça seja com vós todos. Amém.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Tito 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.