Tito 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Na Paul, wey bi Jesus Christ apostle and God savant rite dis leta to help pipol wey God don choose, so dat dia faith go strong kon know di trut wey go help dem live di kind life wey God wont.
1 Paulo, servo de Deus, apóstolo de Jesus Cristo para levar aos eleitos de Deus a fé e o profundo conhecimento da verdade que conduz à piedade,
2 Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.
2 na esperança da vida eterna prometida em tempos longínquos por Deus veraz e fiel,
3 As di time don rish, E don give us en message thru di word wey wi dey prish give evribody and na God awa Savior give mi pawa to do dis work.
3 que na ocasião escolhida manifestou a sua palavra mediante a pregação que me foi confiada por ordem de Deus, nosso Salvador,
4 I dey rite to Titus, my own pikin for faith. Make grace and peace wey dey kom from God awa Papa and from awa Savior Jesus Christ, dey with yu.
4 a Tito, meu verdadeiro filho em nossa fé comum: graça e paz da parte de Deus Pai e de Jesus Cristo, nosso Salvador!
5 Titus! Na dis message make mi leave yu for Krete, so dat yu go kontinue awa work for der and pick new leaders for each town, just as I kommand yu.
5 Eu te deixei em Creta para acabares de organizar tudo e estabeleceres anciãos em cada cidade, de acordo com as normas que te tracei.
6 Anybody wey won bi elder must dey good. E must get only one wife and en shidren must bi bilivers; dey gentol and dey respet demsef.
6 {Devem ser escolhidos entre} quem seja irrepreensível, casado uma só vez, tenha filhos fiéis e não acusados de má conduta ou insubordinação.
7 Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money.
7 Porquanto é mister que o bispo seja irrepreensível, como administrador que é posto por Deus. Não arrogante, nem colérico, nem intemperante, nem violento, nem cobiçoso.
8 Instead make e dey welkom strenjas for en house; love wetin dey good and e must get sense; make e nor dey put hand for bad tin; e must dey holy and fit kontrol ensef.
8 Ao contrário, seja hospitaleiro, amigo do bem, prudente, justo, piedoso, continente,
9 E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.
9 firmemente apegado à doutrina da fé tal como foi ensinada, para poder exortar segundo a sã doutrina e rebater os que a contradizem.
10 Many pipol nor won do wetin God tok, instead, dem dey tok anyhow, dey deceive pipol and follow Jew pipol law wey sey, evribody must sekonsaiz.
10 Com efeito, há muitos insubmissos, charlatães e sedutores, principalmente entre os da circuncisão.
11 So wi must stop dem, bikos dem dey tish pipol tins wey go make pipol komot from di trut and dem dey do like dis, bikos of di money wey dem go get.
11 É necessário tapar-lhes a boca, porque transtornam famílias inteiras, ensinando o que não convém, e isso por vil espírito de lucro.
12 Even one among dia own profets sey, “Krete pipol dey always tok lie, dem bi wiked animals and lazy pipol wey get long-trot.”
12 Um dentre eles, o profeta deles disse: Os cretenses são sempre mentirosos, feras selvagens, glutões preguiçosos.
13 Wetin di profet tok, na true. So bikos of dis, make yu stop dem, so dat di bilivers go strong for faith.
13 Esta asserção reflete a verdade. Portanto, repreende-os severamente, para que se mantenham sãos na fé,
14 Make dem stop to listin to Jew pipol lie-lie story and nor dey bihave like doz wey nor bilive.
14 e não dêem ouvidos a fábulas judaicas nem a preceitos de homens avessos à verdade.
15 Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. But nor-tin dey pure to doz wey bad tins full dia mind.
15 Para os puros todas as coisas são puras. Para os corruptos e descrentes nada é puro: até a sua mente e consciência são corrompidas.
16 Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.
16 Proclamam que conhecem a Deus, mas na prática o renegam, detestáveis que são, rebeldes e incapazes de qualquer boa obra.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Tito 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.