Tiago 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.
1 E agora, vós ricos, chorai e pranteai, por causa das desgraças que vos sobrevirão.
2 Yor money don rotin and ants don chop yor klot.
2 As vossas riquezas estão apodrecidas, e as vossas vestes estão roídas pela traça.
3 Yor gold and silva don rust, dia ashes go tok against yu and chop yor flesh like fire. For di last days, yu don gada money and fine tins for yorsef!
3 O vosso ouro e a vossa prata estão enferrujados; e a sua ferrugem dará testemunho contra vós, e devorará as vossas carnes como fogo. Entesourastes para os últimos dias.
4 Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.
4 Eis que o salário que fraudulentamente retivestes aos trabalhadores que ceifaram os vossos campos clama, e os clamores dos ceifeiros têm chegado aos ouvidos do Senhor dos exércitos.
5 Yu dey live life wey yu dey enjoy and yu dey enjoy for dis eart. Yu don make yorsef fat, dey wait for di day wey dem go kill yu.
5 Deliciosamente vivestes sobre a terra, e vos deleitastes; cevastes os vossos corações no dia da matança.
6 Yu don kondemn and kill pipol wey nor do bad, bikos dem nor fit stop yu.
6 Condenastes e matastes o justo; ele não vos resiste.
7 My brodas and sistas, make una get patient till Christ go kom back. Tink how farmer dey wait for wetin e plant until e grow kon bring food wey dear and e dey wait with patient for am, until di first and di last rain go fall put.
7 Portanto, irmãos, sede pacientes até a vinda do Senhor. Eis que o lavrador espera o precioso fruto da terra, aguardando-o com paciência, até que receba as primeiras e as últimas chuvas.
8 So, make una get patient too and make una heart strong, bikos di time wen Christ go kom back, don near.
8 Sede vós também pacientes; fortalecei os vossos corações, porque a vinda do Senhor está próxima.
9 My brodas and sistas, make una nor dey komplain about each oda, so dat dem nor go judge una, bikos God wey bi di judge, stand near di gate.
9 Não vos queixeis, irmãos, uns dos outros, para que não sejais julgados. Eis que o juiz está à porta.
10 Di profets wey God send kom tok to una, make una use dem as ezample to bear sofa and get patient.
10 Irmãos, tomai como exemplo de sofrimento e paciência os profetas que falaram em nome do Senhor.
11 Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.
11 Eis que chamamos bem-aventurados os que suportaram aflições. Ouvistes da paciência de Jó, e vistes o fim que o Senhor lhe deu, porque o Senhor é cheio de misericórdia e compaixão.
12 My brodas and sistas, make una remember dis kommand pass oda ones; make una nor swear, weda with heaven or eart or any oda tin. But make una let una “Yes” bi yes, and una “No” bi know, so dat una nor go fall enter God judgement.
12 Mas, sobretudo, meus irmãos, não jureis, nem pelo céu, nem pela terra, nem façais qualquer outro juramento; seja, porém, o vosso sim, sim, e o vosso não, não, para não cairdes em condenação.
13 If anybody dey sofa among una, make e pray. If anybody dey happy among una, make e sing dey praiz God.
13 Está aflito alguém entre vós? Ore. Está alguém contente? Cante louvores.
14 If anybody among una nor well, make e koll di eldas for di church, make dem pray and use oil anoint am for Jesus name.
14 Está doente algum de vós? Chame os anciãos da igreja, e estes orem sobre ele, ungido-o com óleo em nome do Senhor;
15 Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am.
15 e a oração da fé salvará o doente, e o Senhor o levantará; e, se houver cometido pecados, ser-lhe-ão perdoados.
16 So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.
16 Confessai, portanto, os vossos pecados uns aos outros, e orai uns pelos outros, para serdes curados. A súplica de um justo pode muito na sua atuação.
17 Elijah na human being like us and e pray with all en mind make rain nor fall. True-true, for three and half years, rain nor fall for dat place.
17 Elias era homem sujeito às mesmas paixões que nós, e orou com fervor para que não chovesse, e por três anos e seis meses não choveu sobre a terra.
18 Den e pray again and di sky kon bring rain and evritin wey dem plant, kon grow.
18 E orou outra vez e o céu deu chuva, e a terra produziu o seu fruto.
19 My brodas and sistas, if anybody among una waka komot from di trut and pesin bring am kom back,
19 Meus irmãos, se alguém dentre vós se desviar da verdade e alguém o converter,
20 make yu know sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom back from di bad way, don save yor soul from deat and e don make Christ forgive yu all yor sins.
20 sabei que aquele que fizer converter um pecador do erro do seu caminho salvará da morte uma alma, e cobrirá uma multidão de pecados.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Tiago 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.