Tiago 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 Wetin dey make una kworel and fight? Nor bi di tins wey dey hongry una to do?
1 De onde vêm as guerras e brigas entre vós? Porventura não vêm disto, das concupiscências que guerreiam nos vossos membros?
2 Yu wont sometin, but yu nor get am; yu dey kill, dey wont wetin oda pipol get and yu nor dey fit get am; so yu go kon dey kworel and fight. Yu nor get, bikos yu nor ask God make E give yu.
2 Cobiçais, e nada tendes; matais, e desejais ter, e não podeis obter; combateis e guerreais, e nada tendes, porque não pedis.
3 Wen yu ask for sometin, yu nor receive am, bikos yu nor ask well and yu won take am do wetin yu like.
3 Pedis, e não recebeis, porque pedis mal, para consumirdes em vossos deleites.
4 Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.
4 Adúlteros e adúlteras, não sabeis vós que a amizade do mundo é inimizade contra Deus? Qualquer que quiser ser amigo do mundo, torna-se um inimigo de Deus.
5 Abi yu tink sey God nor mean wetin E tok wen E sey, “Di Spirit wey I put inside una dey jealous well-well?”
5 Pensais vós que a escritura diz em vão: O Espírito que em nós habita tem ciúmes?
6 But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”
6 Antes, dá mais graça. Portanto ele diz: Deus resiste aos orgulhosos, mas dá graça aos humildes.
7 So, make yu give yorsef to God. But rijet di devil and e go run komot from where yu dey.
7 Sujeitai-vos, pois, a Deus, resisti ao diabo, e ele fugirá de vós.
8 Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.
8 Chegai-vos a Deus, e ele se chegará a vós. Limpai vossas mãos, vós pecadores; e purificai vossos corações, vós de duplo ânimo.
9 Make una kry and make sorrow dey una heart, den una go show sey una nor dey happy.
9 Estai aflitos, e lamentai e chorai; converta-se o vosso riso em pranto, e a vossa alegria em pesar.
10 If una put una body down for God, E go karry una go up.
10 Humilhai-vos diante do Senhor, e ele vos exaltará.
11 My brodas and sistas, make una nor tok bad about each oda. Anybody wey tok bad or judge en broda or sista for Christ, e dey tok bad about di law and e dey judge di law. But if una judge di law, den una nor dey obey di law, but una don bikom di law judge bi dat.
11 Não faleis mal uns dos outros, meus irmãos. Aquele que fala mal de seu irmão, e julga a seu irmão, fala mal da lei, e julga a lei; e, se tu julgas a lei, já não és um cumpridor da lei, mas juiz.
12 Na only one Pesin give di law and na-im bi judge. Na-im dey save and distroy. Yu wey dey judge yor neighbour, na who yu even tink sey yu bi?
12 Há um legislador que é capaz de salvar e destruir. Quem és tu, porém, que julgas a outrem?
13 Look, yu wey dey sey, “Today or tumoro, wi go-go dis or dat town go stay der for one year and do business kon get gain,”
13 Ide agora vós, que dizeis: Hoje, ou amanhã, iremos a tal cidade, e lá passaremos um ano, e compraremos, e venderemos, e teremos um ganho.
14 but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.
14 Porque vós não sabeis o que trará o amanhã. Porquanto, o que é a vossa vida? É apenas um vapor que aparece por um pouco de tempo, e depois desaparece.
15 Instead, yu suppose to sey, “If God wont, wi go dey alive and wi go do dis or dat tin.”
15 Porque isso é o que devíeis dizer: Se o Senhor quiser, haveremos de viver, e faremos isto ou aquilo.
16 But as e bi so, yu dey boast dey karry body up. All dat kind boastin nor good.
16 Mas agora vos gloriais em vossas presunções; toda esta glória é maligna.
17 So anybody wey know wetin good and e nor do am, don kommit sin bi dat.
17 Portanto, aquele que sabe fazer o bem e não o faz, comete pecado.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Tiago 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.