Rute 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.
1 Nos dias em que julgavam os juízes, houve fome na terra; e um homem de Belém de Judá saiu a habitar na terra de Moabe, com sua mulher e seus dois filhos.
2 (Di man name na Elimelek and en wife name na Naomi. E get two shidren wey bi Mahlon and Kilion. Dem kom from Efrat family wey dey Betlehem for Judah.)
2 Este homem se chamava Elimeleque, e sua mulher, Noemi; os filhos se chamavam Malom e Quiliom, efrateus, de Belém de Judá; vieram à terra de Moabe e ficaram ali.
3 Afta sometaim, Naomi husband, Elimelek kon die leave di woman and en two pikin.
3 Morreu Elimeleque, marido de Noemi; e ficou ela com seus dois filhos,
4 So di shidren marry wimen from Moab and dia name na Orpah and Rut. Dem kon stay for Moab for anoda ten years.
4 os quais casaram com mulheres moabitas; era o nome de uma Orfa, e o nome da outra, Rute; e ficaram ali quase dez anos.
5 Den Naomi two sons, Mahlon and Kilion kon die too. So Naomi nor get husband or shidren again.
5 Morreram também ambos, Malom e Quiliom, ficando, assim, a mulher desamparada de seus dois filhos e de seu marido.
6 So Naomi kon decide sey e go-go back to Betlehem (and en shidren wifes follow am), bikos as e dey for Moab, e hear sey God don bless en pipol and honga nor dey dia land again.
6 Então, se dispôs ela com as suas noras e voltou da terra de Moabe, porquanto, nesta, ouviu que o Senhor se lembrara do seu povo, dando-lhe pão.
7 So, wen en and en two pikin wife komot for where dem dey stay kon dey go back to Judah,
7 Saiu, pois, ela com suas duas noras do lugar onde estivera; e, indo elas caminhando, de volta para a terra de Judá,
8 Naomi kon tell di wimen, “Make una listin to mi! Make una go back to una mama house! Make God show una en favor just as una don show am to mi and my shidren wey don die!
8 disse-lhes Noemi: Ide, voltai cada uma à casa de sua mãe; e o Senhor use convosco de benevolência, como vós usastes com os que morreram e comigo.
9 Make God guide una for una new husband house!”
9 O Senhor vos dê que sejais felizes, cada uma em casa de seu marido. E beijou-as. Elas, porém, choraram em alta voz
10 But di wimen tell am, “No! Wi go follow yu go meet yor pipol.”
10 e lhe disseram: Não! Iremos contigo ao teu povo.
11 So Naomi ansa dem, “My dotas! Make una dey go house! No nid to follow mi go back to Judah! I nor go fit born pikin wey go bi una husband again!
11 Porém Noemi disse: Voltai, minhas filhas! Por que iríeis comigo? Tenho eu ainda no ventre filhos, para que vos sejam por maridos?
12 My dotas, make una dey go house! I don old well-well to marry again. Even if I feel sey hope still dey to marry dis nite kon get belle born pikin,
12 Tornai, filhas minhas! Ide-vos embora, porque sou velha demais para ter marido. Ainda quando eu dissesse: tenho esperança ou ainda que esta noite tivesse marido e houvesse filhos,
13 true-true una nor go won wait until dem big rish to marry una! Una nor go fit stay thru-out dat time without husband. Yes! Una nor go fit wait. So my dotas, make una nor follow mi go, bikos my wahala and sofa too many for una to karry and na God dey ponish mi!”
13 esperá-los-íeis até que viessem a ser grandes? Abster-vos-íeis de tomardes marido? Não, filhas minhas! Porque, por vossa causa, a mim me amarga o ter o Senhor descarregado contra mim a sua mão.
14 Dem kon kry well-well again. Den Orpah kiss Naomi kon go back, but Rut nor gri go.
14 Então, de novo, choraram em voz alta; Orfa, com um beijo, se despediu de sua sogra, porém Rute se apegou a ela.
15 So Naomi tell am, “Si, yor husband broda wife dey go back go meet en pipol and en god. So make yu follow yor husband broda wife go back!”
15 Disse Noemi: Eis que tua cunhada voltou ao seu povo e aos seus deuses; também tu, volta após a tua cunhada.
16 But Rut ansa, “Nor force mi sey make I leave yu! Anywhere wey yu go, na der I go-go. Anywhere wey yu won stay, na der I go stay. Yor pipol go bi my pipol and yor God go bi my God.
16 Disse, porém, Rute: Não me instes para que te deixe e me obrigue a não seguir-te; porque, aonde quer que fores, irei eu e, onde quer que pousares, ali pousarei eu; o teu povo é o meu povo, o teu Deus é o meu Deus.
17 Where yu for die, I go die for der too and na der dem go beri mi put. Make God ponish mi well-well if I nor do wetin I promise! Na only deat go fit separate mi from yu!”
17 Onde quer que morreres, morrerei eu e aí serei sepultada; faça-me o Senhor o que bem lhe aprouver, se outra coisa que não seja a morte me separar de ti.
18 Wen Naomi si sey Rut sirious to follow am go, e kon stop to tell am make e go back.
18 Vendo, pois, Noemi que de todo estava resolvida a acompanhá-la, deixou de insistir com ela.
19 So dem two kon travel until dem rish Betlehem. As dem rish der, di whole village happy sey dem kom. Di wimen for di village kon sey, “Na Naomi bi dis?”
19 Então, ambas se foram, até que chegaram a Belém; sucedeu que, ao chegarem ali, toda a cidade se comoveu por causa delas, e as mulheres diziam: Não é esta Noemi?
20 Naomi ansa, “Make una nor koll mi, ‘Naomi’, but make una koll mi ‘Mara’, bikos God wey get pawa don ponish mi well-well.
20 Porém ela lhes dizia: Não me chameis Noemi; chamai-me Mara, porque grande amargura me tem dado o Todo-Poderoso.
21 I komot here with my husband and shidren, but God don make mi kom back with empty hand. Wetin make una dey koll mi, ‘Naomi,’ wen una si sey God tok against mi and di One wey get pawa don make mi dey sofa?”
21 Ditosa eu parti, porém o Senhor me fez voltar pobre; por que, pois, me chamareis Noemi, visto que o Senhor se manifestou contra mim e o Todo-Poderoso me tem afligido?
22 So na like dis Naomi take kom back from Moab with Rut, en pikin, Mahlon wife. Dem rish Betlehem wen grain harvest just dey start.
22 Assim, voltou Noemi da terra de Moabe, com Rute, sua nora, a moabita; e chegaram a Belém no princípio da sega da cevada.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Rute 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.