Romanos 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ.
1 Portanto, agora nenhuma condenação há para os que estão em Cristo Jesus, que não andam segundo a carne, mas segundo o Espírito.
2 Since di Holy Spirit don give una life wey kom from Jesus Christ, e go free una from sin and deat.
2 Porque a lei do Espírito de vida, em Cristo Jesus, me livrou da lei do pecado e da morte.
3 Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.
3 Porquanto o que era impossível à lei, visto como estava enferma pela carne, Deus, enviando o seu Filho em semelhança da carne do pecado, pelo pecado condenou o pecado na carne;
4 God do so, so dat wetin di law tok, go happen wen wi obey di Spirit, instead of awa own mind.
4 Para que a justiça da lei se cumprisse em nós, que não andamos segundo a carne, mas segundo o Espírito.
5 Bikos pipol wey dey live by dia own mind, dey tink of only demsef. But evribody wey di Holy Spirit dey rule, dey tink of tins wey di Spirit wont.
5 Porque os que são segundo a carne inclinam-se para as coisas da carne; mas os que são segundo o Espírito para as coisas do Espírito.
6 If wi let sin rule awa mind, wi go die. But if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace.
6 Porque a inclinação da carne é morte; mas a inclinação do Espírito é vida e paz.
7 Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.
7 Porquanto a inclinação da carne é inimizade contra Deus, pois não é sujeita à lei de Deus, nem, em verdade, o pode ser.
8 Doz wey dey obey sin, nor go fit make God happy.
8 Portanto, os que estão na carne não podem agradar a Deus.
9 But una nor dey obey sin, instead, na as di Spirit sey make una live, na so una dey live.
9 Vós, porém, não estais na carne, mas no Espírito, se é que o Espírito de Deus habita em vós. Mas, se alguém não tem o Espírito de Cristo, esse tal não é dele.
10 Christ dey live inside una. So una dey alive, bikos God don asept una, even doh una body must die, bikos of una sins.
10 E, se Cristo está em vós, o corpo, na verdade, está morto por causa do pecado, mas o espírito vive por causa da justiça.
11 If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.
11 E, se o Espírito daquele que dentre os mortos ressuscitou a Jesus habita em vós, aquele que dentre os mortos ressuscitou a Cristo também vivificará os vossos corpos mortais, pelo seu Espírito que em vós habita.
12 So my brodas and sistas, wi get work to do for God, so make wi nor live as awa body wont.
12 De maneira que, irmãos, somos devedores, não à carne para viver segundo a carne.
13 Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.
13 Porque, se viverdes segundo a carne, morrereis; mas, se pelo Espírito mortificardes as obras do corpo, vivereis.
14 Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren.
14 Porque todos os que são guiados pelo Espírito de Deus esses são filhos de Deus.
15 Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!”
15 Porque não recebestes o espírito de escravidão, para outra vez estardes em temor, mas recebestes o Espírito de adoção de filhos, pelo qual clamamos: Aba, Pai.
16 Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren.
16 O mesmo Espírito testifica com o nosso espírito que somos filhos de Deus.
17 And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
17 E, se nós somos filhos, somos logo herdeiros também, herdeiros de Deus, e co-herdeiros de Cristo: se é certo que com ele padecemos, para que também com ele sejamos glorificados.
18 I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us.
18 Porque para mim tenho por certo que as aflições deste tempo presente não são para comparar com a glória que em nós há de ser revelada.
19 Evritin wey God kreate for dis world, dey wait for God to show en shidren to di world.
19 Porque a ardente expectação da criatura espera a manifestação dos filhos de Deus.
20 Bikos of sin, di world dey sofa from God curse naw and nor bi bikos dem wont am like dat. But di world dey hope
20 Porque a criação ficou sujeita à vaidade, não por sua vontade, mas por causa do que a sujeitou,
21 sey one day, God go free dem from deat and wahala and dem go-go join en shidren wey E don save.
21 Na esperança de que também a mesma criatura será libertada da servidão da corrupção, para a liberdade da glória dos filhos de Deus.
22 Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry.
22 Porque sabemos que toda a criação geme e está juntamente com dores de parto até agora.
23 Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.
23 E não só ela, mas nós mesmos, que temos as primícias do Espírito, também gememos em nós mesmos, esperando a adoção, a saber, a redenção do nosso corpo.
24 Na dis hope save us. But if wi don already get wetin wi dey hope for, den wi nor nid to dey hope again. Abi who dey hope for wetin e don already get?
24 Porque em esperança fomos salvos. Ora a esperança que se vê não é esperança; porque o que alguém vê como o esperará?
25 But if wi put hope for wetin wi nor fit si, wi go take all awa mind wait for am with patient.
25 Mas, se esperamos o que não vemos, com paciência o esperamos.
26 Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain.
26 E da mesma maneira também o Espírito ajuda as nossas fraquezas; porque não sabemos o que havemos de pedir como convém, mas o mesmo Espírito intercede por nós com gemidos inexprimíveis.
27 And God wey dey si evritin inside awa belle, know wetin dey di Spirit mind, bikos di Spirit dey pray for all God pipol, as God wont.
27 E aquele que examina os corações sabe qual é a intenção do Espírito; e é ele que segundo Deus intercede pelos santos.
28 And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.
28 E sabemos que todas as coisas contribuem juntamente para o bem daqueles que amam a Deus, daqueles que são chamados segundo o seu propósito.
29 God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born.
29 Porque os que dantes conheceu também os predestinou para serem conformes à imagem de seu Filho, a fim de que ele seja o primogênito entre muitos irmãos.
30 Doz wey God don asept, na dem E koll; doz wey E koll, na dem E make raitious and E kon share en glory with dem.
30 E aos que predestinou a estes também chamou; e aos que chamou a estes também justificou; e aos que justificou a estes também glorificou.
31 Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?
31 Que diremos, pois, a estas coisas? Se Deus é por nós, quem será contra nós?
32 True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!
32 Aquele que nem mesmo a seu próprio Filho poupou, antes o entregou por todos nós, como nos não dará também com ele todas as coisas?
33 Who go fit akuiz pesin wey God don choose? Na God know who good or bad.
33 Quem intentará acusação contra os escolhidos de Deus? É Deus quem os justifica.
34 Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us.
34 Quem é que condena? Pois é Cristo quem morreu, ou antes quem ressuscitou dentre os mortos, o qual está à direita de Deus, e também intercede por nós.
35 Na who go fit separate us from Christ love? Na trobol or opreshon; honga or poverty; wahala or deat; or na bikos klot nor dey to wear?
35 Quem nos separará do amor de Cristo? A tribulação, ou a angústia, ou a perseguição, ou a fome, ou a nudez, ou o perigo, ou a espada?
36 As dem rite am, “Bikos of una, wi dey face deat from morning go rish nite and wi bi like sheep wey dem won go kill.”
36 Como está escrito:Por amor de ti somos entregues à morte todo o dia;Somos reputados como ovelhas para o matadouro.
37 Inside all dis tins, awa joy don dey full, bikos Jesus love us!
37 Mas em todas estas coisas somos mais do que vencedores, por aquele que nos amou.
38 But I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di ones wey dey kom;
38 Porque estou certo de que, nem a morte, nem a vida, nem os anjos, nem os principados, nem as potestades, nem o presente, nem o porvir,
39 tins wey dey heaven; tins for under dis eart or anytin wey God kreate, non of dem go fit separate us from God love, bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.
39 Nem a altura, nem a profundidade, nem alguma outra criatura nos poderá separar do amor de Deus, que está em Cristo Jesus nosso Senhor.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.