Romanos 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 My brodas and sistas, I know sey I dey tok to pipol wey know di law. Na only wen pesin still dey for life, naim di law dey get pawa for en body.
1 Não sabeis vós, irmãos (pois que falo aos que sabem a lei), que a lei tem domínio sobre o homem por todo o tempo que vive?
2 As di law tok, woman wey don marry dey under en husband as long as di man dey alive. But if di man die, di woman don free.
2 Porque a mulher que está sujeita ao marido, enquanto ele viver, está-lhe ligada pela lei; mas, morto o marido, está livre da lei do marido.
3 So if woman marry anoda man wen en husband still dey alive, e mean sey e don kommit adultery. But if en husband die, e don free from wetin di law tok and e go fit marry anoda man again.
3 De sorte que, vivendo o marido, será chamada adúltera se for doutro marido; mas, morto o marido, livre está da lei e assim não será adúltera se for doutro marido.
4 So my brodas and sistas, na so e bi with una too. Una don bikom part for Jesus Christ body and una don die to di law pawa. Naw, una dey free to bi Christ own; di pesin wey God raiz from deat make una for dey serve am.
4 Assim, meus irmãos, também vós estais mortos para a lei pelo corpo de Cristo, para que sejais doutro, daquele que ressuscitou de entre os mortos, a fim de que demos fruto para Deus.
5 Wen wi still dey di world, di law dey make us do bad tins wey awa body wont and all dis tins dey bring deat.
5 Porque, quando estávamos na carne, as paixões dos pecados, que são pela lei, operavam em nossos membros para darem fruto para a morte.
6 But naw, wi don free from di law. Wi bi like deat body and di law nor get pawa for awa body again. Naw wi suppose to serve God with di new life wey di Spirit dey give, nor bi di old life, wey bi to obey di law wey pesin rite.
6 Mas, agora, estamos livres da lei, pois morremos para aquilo em que estávamos retidos; para que sirvamos em novidade de espírito, e não na velhice da letra.
7 Dis mean sey di law nor good? No! But na di law make mi know wetin sin bi. If to sey di law nor sey, “Nor get long-trot for anoda man tin,” I nor for know sey I nor suppose to do dat kind tin.
7 Que diremos, pois? É a lei pecado? De modo nenhum! Mas eu não conheci o pecado senão pela lei; porque eu não conheceria a concupiscência, se a lei não dissesse: Não cobiçarás.
8 But bikos of di law, di sin pawa wey dey inside mi kon dey make mi tink about tins wey nor good and if law nor dey, sin for nor get pawa for my life.
8 Mas o pecado, tomando ocasião pelo mandamento, despertou em mim toda a concupiscência: porquanto, sem a lei, estava morto o pecado.
9 Before I know di law, I dey alive, but wen I hear God kommandment, sin just enter my life
9 E eu, nalgum tempo, vivia sem lei, mas, vindo o mandamento, reviveu o pecado, e eu morri;
10 and I kon die. So di law wey suppose give mi life, don kill mi!
10 e o mandamento que era para vida, achei eu que me era para morte.
11 Since sin pawa use di law deceive mi, I kon die.
11 Porque o pecado, tomando ocasião pelo mandamento, me enganou e, por ele, me matou.
12 But di law dey holy, rite and good.
12 Assim, a lei é santa; e o mandamento, santo, justo e bom.
13 So dis mean sey na wetin good kill mi? No! But na sin pawa wey dey inside mi, na-im kill mi; bikos e use wetin good bring deat and naw, wi dey si how sin bad and wiked rish.
13 Logo, tornou-se-me o bom em morte? De modo nenhum! Mas o pecado, para que se mostrasse pecado, operou em mim a morte pelo bem, a fim de que pelo mandamento o pecado se fizesse excessivamente maligno.
14 Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.
14 Porque bem sabemos que a lei é espiritual; mas eu sou carnal, vendido sob o pecado.
15 I nor undastand wetin I dey do; bikos I nor dey do wetin I won really do. Instead na wetin I nor like, I dey do.
15 Porque o que faço, não o aprovo, pois o que quero, isso não faço; mas o que aborreço, isso faço.
16 Since I dey do wetin I hate to do, e show sey di law dey korrect.
16 E, se faço o que não quero, consinto com a lei, que é boa.
17 Nor bi mi really dey do wetin I dey do, but na di sin pawa wey dey inside mi.
17 De maneira que, agora, já não sou eu que faço isto, mas o pecado que habita em mim.
18 I know sey wetin dey inside mi nor go let mi do good. Even wen I won do good, I nor dey fit.
18 Porque eu sei que em mim, isto é, na minha carne, não habita bem algum; e, com efeito, o querer está em mim, mas não consigo realizar o bem.
19 Instead of make I do wetin dey good, na bad tins I dey do.
19 Porque não faço o bem que quero, mas o mal que não quero, esse faço.
20 So if I do wetin I nor won do, e show sey nor bi mi dey do am again, but na di sin pawa wey dey inside mi.
20 Ora, se eu faço o que não quero, já o não faço eu, mas o pecado que habita em mim.
21 So I si sey dis law dey work, bikos wen I won do good, na only bad tins dey enter my mind.
21 Acho, então, esta lei em mim: que, quando quero fazer o bem, o mal está comigo.
22 I dey like to obey God law with my whole mind,
22 Porque, segundo o homem interior, tenho prazer na lei de Deus.
23 but inside mi, I kon undastand sey sometin dey fight against my mind and e dey make mi bi sin savant, bikos e dey kontrol my body.
23 Mas vejo nos meus membros outra lei que batalha contra a lei do meu entendimento e me prende debaixo da lei do pecado que está nos meus membros.
24 I nor dey happy at-all! Who go save mi from dis body wey dey push mi go die?
24 Miserável homem que eu sou! Quem me livrará do corpo desta morte?
25 Tank God! Jesus Christ don save mi. So, I go obey God law with my mind, even doh sin pawa still dey inside mi.
25 Dou graças a Deus por Jesus Cristo, nosso Senhor. Assim que eu mesmo, com o entendimento, sirvo à lei de Deus, mas, com a carne, à lei do pecado.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.