Romanos 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Since faith don make us dey good for God eye, wi don get peace thru awa Oga God Jesus Christ.
1 Tendo sido, pois, justificados pela fé, temos paz com Deus, por nosso Senhor Jesus Cristo;
2 Na faith e take buy us so dat wi go enter God grace, di place where wi dey naw. So wi fit boast with God glory wey wi dey enjoy.
2 Pelo qual também temos entrada pela fé a esta graça, na qual estamos firmes, e nos gloriamos na esperança da glória de Deus.
3 Wi still dey happy inside di wahala wey wi dey face, bikos wi know sey trobol go make us endure,
3 E não somente isto, mas também nos gloriamos nas tribulações; sabendo que a tribulação produz a paciência,
4 and endurance dey bring good karata, wey go make us get hope.
4 E a paciência a experiência, e a experiência a esperança.
5 Dis hope nor dey disappoint pesin at-all, bikos God pour en love like river wey dey flow inside awa heart, thru di Holy Spirit wey E give us.
5 E a esperança não traz confusão, porquanto o amor de Deus está derramado em nossos corações pelo Espírito Santo que nos foi dado.
6 For di time wen wi nor fit help awasef, Christ kon die for us wey bi sinnas.
6 Porque Cristo, estando nós ainda fracos, morreu a seu tempo pelos ímpios.
7 Nobody go won die for anoda pesin wey dey good for God eye, aldo somebody go fit die for pesin wey good well-well.
7 Porque apenas alguém morrerá por um justo; pois poderá ser que pelo bom alguém ouse morrer.
8 But God show how en love for us big rish, wen E send Christ kom die for us, even doh wi still dey sin.
8 Mas Deus prova o seu amor para conosco, em que Cristo morreu por nós, sendo nós ainda pecadores.
9 Naw, wi dey rite bikos of Christ blood and na dis blood go save us from God vexnashon.
9 Logo muito mais agora, tendo sido justificados pelo seu sangue, seremos por ele salvos da ira.
10 Wi bi God enemies before, but E don make us en friends thru en Pikin deat. Naw, since wi don bi God friends, E go save us thru di life wey en pikin get.
10 Porque se nós, sendo inimigos, fomos reconciliados com Deus pela morte de seu Filho, muito mais, tendo sido já reconciliados, seremos salvos pela sua vida.
11 Nor bi only dis won make us dey happy, but wi still dey happy bikos of wetin God don do thru awa Oga God Jesus Christ wey make us bi God friends.
11 E não somente isto, mas também nos gloriamos em Deus por nosso Senhor Jesus Cristo, pelo qual agora alcançamos a reconciliação.
12 Na thru one man sin enter dis world and deat kom thru sin. So wi must die, bikos evribody don sin.
12 Portanto, como por um homem entrou o pecado no mundo, e pelo pecado a morte, assim também a morte passou a todos os homens por isso que todos pecaram.
13 Sin dey di world before di law kom, but if law nor dey, wi nor go fit judge pipol sin.
13 Porque até à lei estava o pecado no mundo, mas o pecado não é imputado, não havendo lei.
14 From Adam kon rish Moses time, na deat dey rule for dis world, even doh nor bi evribody disobey God kommand like Adam. Dis Adam bi like Christ wey kom leta.
14 No entanto, a morte reinou desde Adão até Moisés, até sobre aqueles que não tinham pecado à semelhança da transgressão de Adão, o qual é a figura daquele que havia de vir.
15 But two of dem nor bi di same, bikos God free gift nor bi like Adam sin. Na true sey many pipol die bikos of one man sin. But God grace big well-well and e dey give free gift to pipol thru en pikin Jesus Christ!
15 Mas não é assim o dom gratuito como a ofensa. Porque, se pela ofensa de um morreram muitos, muito mais a graça de Deus, e o dom pela graça, que é de um só homem, Jesus Cristo, abundou sobre muitos.
16 God gift and one man sin nor bi di same. Judgement follow di one man sin kon kondemn evribody, but na God gift dey free us, even doh wi bi sinnas.
16 E não foi assim o dom como a ofensa, por um só que pecou. Porque o juízo veio de uma só ofensa, na verdade, para condenação, mas o dom gratuito veio de muitas ofensas para justificação.
17 But if na bikos of one man sin deat kill evribody, den, doz wey don get favor and Christ gift, dey good for God eye and dem go enjoy life thru Jesus Christ!
17 Porque, se pela ofensa de um só, a morte reinou por esse, muito mais os que recebem a abundância da graça, e do dom da justiça, reinarão em vida por um só, Jesus Cristo.
18 God go ponish evribody bikos of Adam sin. But bikos of di good tins wey Jesus do, God don asept and give us di gift wey dey give life.
18 Pois assim como por uma só ofensa veio o juízo sobre todos os homens para condenação, assim também por um só ato de justiça veio a graça sobre todos os homens para justificação de vida.
19 Bikos Adam nor obey God, many pipol bigin sin. But since Jesus obey God, many pipol go obey God too.
19 Porque, como pela desobediência de um só homem, muitos foram feitos pecadores, assim pela obediência de um muitos serão feitos justos.
20 Di law kom so dat sin go inkrease, but where sin get pawa, God grace strong pass am
20 Veio, porém, a lei para que a ofensa abundasse; mas, onde o pecado abundou, superabundou a graça;
21 and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.
21 Para que, assim como o pecado reinou na morte, também a graça reinasse pela justiça para a vida eterna, por Jesus Cristo nosso Senhor.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.