Romanos 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Na wetin Abraham awa grand-grand papa learn from dis matter?
1 Portanto, que diremos do nosso antepassado Abraão?
2 If na di good tins wey e do make am dey good for God eye, den e suppose to dey boast for pipol, but e nor go ever fit boast for God.
2 Se de fato Abraão foi justificado pelas obras, ele tem do que se gloriar, mas não diante de Deus.
3 Wetin dem rite for God word? “Abraham bilive God thru faith and God kon si am as raitious pesin.”
3 Que diz a Escritura? "Abraão creu em Deus, e isso lhe foi creditado como justiça".
4 Wen pesin work, dem must pay am en money, nor bi dash e bi, but na money wey e work for.
4 Ora, o salário do homem que trabalha não é considerado como favor, mas como dívida.
5 Doz wey nor depend on wetin dem dey do, but dem get faith and bilive sey God dey forgive sinnas, na dis faith God dey use take forgive dem dia sins.
5 Todavia, àquele que não trabalha, mas confia em Deus que justifica o ímpio, sua fé lhe é creditada como justiça.
6 David tok di same tin wen e tok about di blessing wey pesin dey get wen God don asept am, even doh dem nor deserve dat kind blessing. David still sey,
6 Davi diz a mesma coisa, quando fala da felicidade do homem a quem Deus credita justiça independente de obras:
7 “God don bless pipol wey E forgive
7 "Como são felizes aqueles que têm suas transgressões perdoadas, cujos pecados são apagados.
8 God don bless di pesin
8 Como é feliz aquele a quem o Senhor não atribui culpa".
9 Dis blessing wey David dey tok about so, na only Jew pipol e tok am for, bikos dem sekonsaiz dem? No! Na still for Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz. Bikos wi read for God word sey, “Abraham bilive God and bikos of en faith, God kon asept am as raitious pesin.”
9 Destina-se esta felicidade apenas aos circuncisos ou também aos incircuncisos? Já dissemos que, no caso de Abraão, a fé lhe foi creditada como justiça.
10 Na wen all dis tins take happen? Na before dem sekonsaiz Abraham or afta dem sekonsaiz am? Na before, nor bi afta dem sekonsaiz am!
10 Sob quais circunstâncias? Antes ou depois de ter sido circuncidado? Não foi depois, mas antes!
11 But leta, dem sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en faith, God don si am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribody wey bilive God, pipol wey God don asept, even doh dem neva sekonsaiz.
11 Assim ele recebeu a circuncisão como sinal, como selo da justiça que ele tinha pela fé, quando ainda não fora circuncidado. Portanto, ele é o pai de todos os que crêem, sem terem sido circuncidados, a fim de que a justiça fosse creditada também a eles;
12 Doz wey don sekonsaiz, na Abraham bi dia papa and dia faith bi like en own, afta dem sekonsaiz am.
12 e é igualmente o pai dos circuncisos que não somente são circuncisos, mas também andam nos passos da fé que teve nosso pai Abraão antes de passar pela circuncisão.
13 Wen God promise Abraham and en shidren sey dem go inherit di whole world, E do am, nor bi bikos Abraham dey obey di law, but bikos e bilive God and God si am as raitious pesin.
13 Não foi mediante a lei que Abraão e a sua descendência receberam a promessa de que ele seria o herdeiro do mundo, mas mediante a justiça que vem da fé.
14 If God promise na for only doz wey dey obey di law, den faith nor mean anytin and God promise go dey yuzles.
14 Pois se os que vivem pela lei são herdeiros, a fé não tem valor, e a promessa é inútil;
15 Di law dey bring God vexnashon, bikos where sin nor dey, law nor go dey.
15 porque a lei produz a ira. E onde não há lei, não há transgressão.
16 Na dis one make God promise dey kom by faith and wi dey get am thru favor. Nor bi only pipol wey dey obey di law bi Abraham shidren, but pipol wey bilive God like Abraham, naim en shidren dem bi too, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.
16 Portanto, a promessa vem pela fé, para que seja de acordo com a graça e seja assim garantida a toda a descendência de Abraão; não apenas aos que estão sob o regime da lei, mas também aos que têm a fé que Abraão teve. Ele é o pai de todos nós.
17 God word sey, “I don make yu papa for many nashons.” So for God eye, Abraham na awa papa, bikos e get faith for God wey get pawa to raiz pipol wey don die and to kommand tins wey nor dey before, like sey dem dey.
17 Como está escrito: "Eu o constituí pai de muitas nações". Ele é nosso pai aos olhos de Deus, em quem creu, o Deus que dá vida aos mortos e chama à existência coisas que não existem, como se existissem.
18 Even wen tins hard, Abraham still bilive God and e hope sey God go do am, even wen e bi like sey nor-tin go happen. But naw, e don bikom, “Papa for many nashons.” Just as God tell am, “Yor shidren go many like di stars wey dey heaven.”
18 Abraão, contra toda esperança, em esperança creu, tornando-se assim pai de muitas nações, como foi dito a seu respeito: "Assim será a sua descendência".
19 Abraham nor komplain for one day, even wen e don old nearly rish hundred years. Even doh E know sey en body don nearly die and en wife Sarah nor go fit born again,
19 Sem se enfraquecer na fé, reconheceu que o seu corpo já estava sem vitalidade, pois já contava cerca de cem anos de idade, e que também o ventre de Sara já estava sem vitalidade.
20 e nor doubt God promise. En faith make am strong and e tank God for evritin.
20 Mesmo assim não duvidou nem foi incrédulo em relação à promessa de Deus, mas foi fortalecido em sua fé e deu glória a Deus,
21 E dey sure sey God go do wetin E promise.
21 estando plenamente convencido de que ele era poderoso para cumprir o que havia prometido.
22 Na dis make God koll am raitious pesin.
22 Em conseqüência, "isso lhe foi também creditado como justiça".
23 Even doh God koll am “Raitious pesin”, E tok dis word bikos of only Abraham?
23 As palavras "lhe foi creditado" não foram escritas apenas para ele,
24 No! E tok am for wi too wey God go still asept as raitious pipol; wi wey bilive sey God raiz Jesus Christ from deat.
24 mas também para nós, a quem Deus creditará justiça, para nós, que cremos naquele que ressuscitou dos mortos a Jesus, nosso Senhor.
25 Na awa sins make God give Jesus Christ to dem make dem kill-am and God raiz am from deat, so dat e go make us raitious pipol.
25 Ele foi entregue à morte por nossos pecados e ressuscitado para nossa justificação.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.