Romanos 16
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 I get betta tins to tok about awa sista, Foebe, wey bi leader for di church wey dey Cenchrea.
1 Recomendo-vos a nossa irmã Febe, que é diaconisa da igreja de Cêncris,
2 Make una welkom am with God name as God shidren suppose do. And make una gi-am anytin wey e nid; bikos e don help mi and oda pipol before.
2 para que a recebais no Senhor, dum modo digno dos santos, e a ajudeis em qualquer coisa que de vós venha a precisar; porque ela tem ajudado a muitos e também a mim.
3 Make una salot Priscilla and Akwila for mi. Dem bi my ko-workers for awa Oga God Jesus Christ work,
3 Saudai Prisca e Áquila, meus cooperadores em Cristo Jesus;
4 dem don even risk dia life bikos of mi. So, mi and di whole church dey tank dem well-well.
4 pela minha vida eles expuseram as suas cabeças. E isso lhes agradeço, não só eu, mas também todas as igrejas dos gentios.
5 Make una still help mi salot di pipol for di church wey dey meet for dia house. Salot Epaenetus, my good friend (di first pesin to bilive Christ for Asia).
5 Saudai também a comunidade que se reúne em sua casa. Saudai o meu querido Epêneto, que foi as primícias da Ásia para Cristo.
6 Greet Mary wey don work well-well with una.
6 Saudai Maria, que muito trabalhou por vós.
7 Make una greet my kousin Andronikus and Junia wey dey prison with mi before. Di apostles dey respet dem and dem too don dey follow God, before I even know Christ.
7 Saudai Andrônico e Júnias, meus parentes e companheiros de prisão, os quais são muito estimados entre os apóstolos e se tornaram discípulos de Cristo antes de mim.
8 Greet Ampliatus, wey get faith and e bi my good friend.
8 Saudai Ampliato, amicíssimo meu no Senhor.
9 Greet Urbanus wey follow us work. Greet Stachys wey bi my good friend.
9 Saudai Urbano, nosso colaborador em Cristo Jesus, e o meu amigo Estáquis.
10 Make una greet Apelles for mi, bikos Jesus Christ don choose am. Den make una still greet Aristobulus family for mi.
10 Saudai Apeles, provado em Cristo. Saudai aqueles que são da casa de Aristóbulo.
11 Make una greet Herodion my kountry man and Narcissus and en family wey don bilive God.
11 Saudai Herodião, meu parente. Saudai os que são da família de Narciso, que estão no Senhor.
12 Greet Trifena and Trifosa and my friend Persis wey dey do Christ work.
12 Saudai Trifena e Trifosa, que trabalham para o Senhor. Saudai a estimada Pérside, que muito trabalhou para o Senhor.
13 Greet Rufus, di pesin wey di Oga God don choose and en mama wey trit mi like sey e bi my mama.
13 Saudai Rufo, escolhido no Senhor, e sua mãe, que considero como minha.
14 Make una greet Asynkritus, Flegon, Hermes, Patrobas, Hermas and all di brodas and sistas wey dey with dem.
14 Saudai Asíncrito, Flegonte, Hermes, Pátrobas, Hermas e os irmãos que estão com eles.
15 Greet Filologus and Julia, Nereus and en sista, Olympas and all di bilivers wey dey with dem.
15 Saudai Filólogo e Júlia, Nereu e sua irmã, Olímpio e todos os irmãos que estão com eles.
16 Make una salot one anoda with kiss for jaw. All di church wey bi Christ own, dey greet una.
16 Saudai-vos uns aos outros com ósculo santo. Todas as igrejas de Cristo vos saúdam.
17 Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, make una know di pipol wey dey kause wahala and oppoz di tishing wey una don learn from us. Den make una nor go near dem!
17 Rogo-vos, irmãos, que desconfieis daqueles que causam divisões e escândalos, apartando-se da doutrina que recebestes. Evitai-os!
18 Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.
18 Esses tais não servem a Cristo nosso Senhor, mas ao próprio ventre. E com palavras adocicadas e linguagem lisonjeira enganam os corações simples.
19 I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin.
19 A vossa obediência se tornou notória em toda parte, razão por que eu me alegro a vosso respeito. Mas quero que sejais prudentes no tocante ao bem, e simples no tocante ao mal.
20 And God wey dey give peace, go soon distroy Satan for una. Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.
20 O Deus da paz em breve não tardará a esmagar Satanás debaixo dos vossos pés. A graça de nosso Senhor Jesus Cristo esteja convosco!
21 Timoti, my ko-worker; Lucius, Jason and Sosipater my kountry man, all of dem dey greet una.
21 Saúdam-vos Timóteo, meu cooperador, Lúcio, Jasão e Sosípatro, meus parentes.
22 Even mi, Tertius wey rite dis leta, dey greet una with Christ name.
22 Eu, Tércio, que escrevi esta carta, vos saúdo no Senhor.
23 Gaius, wey dey kare for mi and di church, dey greet una. Erastus wey bi di town treasurer and awa broda Kwartus, dey greet una.
23 Saúda-vos Gaio, meu hospedeiro, e de toda a Igreja.
24 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una!
24 Saúda-vos Erasto, tesoureiro da cidade, e Quarto, nosso irmão.
25 Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret,
25 Àquele que é poderoso para vos confirmar, segundo o meu Evangelho, na pregação de Jesus Cristo - conforme a revelação do mistério, guardado em segredo durante séculos,
26 but naw, dem don tok am at last. God wey nor dey die, kommand en profets make dem rite about di Good News, so dat pipol for evriwhere, go obey am and get faith.
26 mas agora manifestado por ordem do eterno Deus e, por meio das Escrituras proféticas, dado a conhecer a todas as nações, a fim de levá-las à obediência da fé - ,
27 Naw, wi dey praiz di only God wey dey wise forever, bikos of Jesus Christ! Amen.
27 a Deus, único, sábio, por Jesus Cristo, glória por toda a eternidade! Amém.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.