Romanos 15
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 If awa faith dey strong, den make wi dey patient with doz wey get weak faith. Make wi try to make dem happy, instead of awasef.
1 Assim que nós, os fortes, devemos suportar as fraquezas dos fracos e não agradar a nós mesmos.
2 Make wi tink of tins wey good for dem, den do wetin go make dem grow.
2 Cada um de nós agrade ao seu próximo para o seu bem e edificação.
3 Even Christ nor do tins wey go just make ensef happy, but just as dem rite for God word, “Di pesin wey curse yu, don curse mi.”
3 Porque também Cristo não agradou a si mesmo, mas, como está escrito: Os insultos dos que te insultavam caíram sobre mim.
4 Bikos evritin wey dem rite from biginnin, na to tish, enkourage and give us hope.
4 Porque todas as coisas que foram escritas anteriormente, para nosso ensino foram escritas, para que, pela paciência e consolação das escrituras, tenhamos esperança.
5 So, I pray sey, God wey dey give konfort and patient, go help una live for peace with one anoda as una dey follow Jesus Christ,
5 Ora, o Deus da paciência e da consolação vos conceda o mesmo sentimento uns para com os outros, segundo Jesus Cristo.
6 so dat as una dey togeda, una go fit use one vois praiz God, wey bi awa Oga God Jesus Christ, Papa.
6 Para que, com uma só mente e uma só boca, glorifiqueis ao Deus e Pai de nosso Senhor Jesus Cristo.
7 So make una asept one anoda just as Christ asept una, so dat God go get all di glory.
7 Portanto, recebei-vos uns aos outros, como também Cristo nos recebeu para glória de Deus.
8 Make I tell una di trut, Christ kom as Jew pipol savant to show sey, God don keep di promise wey E make with dia grand-grand papa dem. Christ still kom,
8 Porque eu vos digo que Jesus Cristo foi ministro da circuncisão, por causa da verdade de Deus, para que confirmasse as promessas feitas aos pais.
9 so dat Gentile pipol go praiz God sey e dey good to dem. Just as God word sey, “I go tell Gentile pipol about yu and I go sing, dey praiz yor name.”
9 E para que os gentios glorifiquem a Deus por sua misericórdia, como está escrito: Por isto, eu te confessarei entre os gentios e cantarei ao teu nome.
10 God word still sey, “Gentile pipol! Make una happy with God pipol.”
10 E outra vez ele diz: Alegrai-vos, gentios, com seu povo.
11 Dem rite am for God word sey, “Una wey bi Gentile pipol, make una praiz God. Make evribody praiz am.”
11 E outra vez: Louvai ao Senhor, todos os gentios, e exaltai-o todos os povos.
12 Profet Isaya sey, “Somebody dey kom from David family (Jesse rut). E go rule Gentile pipol and dem go bilive am.”
12 E outra vez diz Isaías: Haverá uma raiz em Jessé, e aquele que se levantar para reger os gentios; nele os gentios confiarão.
13 I pray make God wey dey give hope, bless una with joy and peace bikos of una faith. So make di Holy Spirit pawa full una body with faith.
13 Ora, o Deus de esperança vos encha de toda a alegria e paz em crer, para que abundeis em esperança por meio do poder do Espírito Santo.
14 My friends, I dey sure sey una dey good; know God well-well and fit tish one anoda.
14 E eu mesmo, meus irmãos, tenho sido convencido a respeito de vós, de que também vós estais cheios de bondade, cheios de todo o conhecimento, capazes também para admoestar-vos uns aos outros.
15 But for dis leta, I rite some tins with boldness, so dat una go remember dem well-well. God dey good to mi and
15 Porém, irmãos, eu vos escrevi em alguns pontos ousadamente, para lembrá-los, por meio da graça que me foi dada por Deus,
16 naim make am choose mi to bi Jesus Christ savant for Gentile pipol and make I for dey prish di Good News. Dis tin happen, so dat di Holy Spirit go make God dey happy with Gentile pipol.
16 que eu seja ministro de Jesus Cristo aos gentios, ministrando o evangelho de Deus, para que a oferta dos gentios seja aceitável, santificada pelo Espírito Santo.
17 So I dey boast about di tins wey I dey do, bikos of Jesus Christ.
17 Por isso, eu tenho que me gloriar em Jesus Cristo, nas coisas pertencentes a Deus.
18 With betta mind, evritin wey I dey tok about, na how Christ let mi tok and work, so dat Gentile pipol go obey am.
18 Porque eu não ousaria falar alguma coisa que Cristo não tenha feito por mim, para fazer dos gentios obedientes, por palavras e por obras,
19 Yes! I go tok how Christ take do many mirakles and wonders thru di Holy Spirit pawa. I don prish di Good News from Jerusalem go rish Illyricum.
19 pelo poder dos sinais e maravilhas, através do poder do Espírito de Deus; de maneira que, desde Jerusalém e arredores até o Ilírico, eu tenho pregado plenamente o evangelho de Cristo.
20 But I like to prish di Good News for where pipol nor know Christ, so dat I nor go build house on-top anoda man foundashon,
20 E desta maneira me esforcei para pregar o evangelho, não onde Cristo houvera sido nomeado, para não edificar sobre fundamento de outro homem,
21 just as God word sey, “Doz wey dem tell about am, go si am and doz wey neva hear about am, dem go undastand.”
21 antes, como está escrito: Aqueles a quem ele não foi anunciado o verão, e os que não ouviram o entenderão.
22 My work neva let mi kom si una.
22 Razão pela qual também muitas vezes tenho sido impedido de ir até vós.
23 But naw, nor-tin remain wey I go do for dis part for di world again and e don tey wey I dey plan to kom visit una.
23 Mas agora, não tendo mais lugar nestas regiões, e tendo um grande desejo, há muitos anos, de chegar até vós,
24 I go plan to stop si una wen I dey go Spain, so dat una go help mi for di journey, afta I don stay with una for sometaim.
24 quando eu viajar para a Espanha, irei até vós. Porque eu espero ver-vos na minha viagem, e para lá ser conduzido por vós pelo caminho, após ter primeiro desfrutado um pouco da vossa companhia.
25 But naw, I dey take message go give God pipol for Jerusalem,
25 Mas agora eu vou para Jerusalém para ministrar aos santos.
26 bikos God pipol for Masidonia and Akaia give mi money make I give di poor Christians for der.
26 Porque agradou aos da Macedônia e Acaia fazerem uma certa contribuição para os pobres dentre os santos que estão em Jerusalém.
27 Dis na wetin dem really won do. Bikos wen den share di tins wey dem get with Jew pipol, den dem don follow Jew pipol share dia spiritual blessings too.
27 Isto lhes agradou de fato, e eles são seus devedores. Porque, se os gentios foram feitos participantes das suas coisas espirituais, também é seu dever ministrar-lhes as coisas carnais.
28 So, afta I don finish dis work kon dey sure sey di bilivers don get dia blessings for Jerusalem, I go visit una wen I dey go Spain.
28 Portanto, quando eu tiver completado isto, e lhes tiver selado este fruto, passando por vós, irei para a Espanha.
29 And I know sey wen I kom visit una, I go bring plenty blessings from Christ kon give una.
29 E sei que quando eu for até vós, chegarei com a plenitude da bênção do evangelho de Cristo.
30 My brodas and sistas, I dey beg una with Jesus Christ and di Holy Spirit love; make una help mi pray to God.
30 E agora eu suplico-vos, irmãos, por nosso Senhor Jesus Cristo e pelo amor do Espírito, que luteis juntos comigo nas vossas orações a Deus por mim,
31 Make una pray make God save mi from pipol wey nor bilive am for Judea and make di bilivers wey dey Jerusalem, asept wetin I dey prish.
31 para que eu seja livrado dos incrédulos que estão na Judeia, e que meu serviço em Jerusalém seja aceito pelos santos,
32 Make una pray give God, so dat I go kom visit una with happiness.
32 para que eu chegue até vós com alegria pela vontade de Deus, e possa revigorar-me convosco.
33 So make God wey dey give peace, dey with all of una. Amen.
33 E o Deus da paz seja com todos vós. Amém!
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.