Romanos 14
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Make una dey welkom God pipol. Even doh dia faith nor too strong, make una nor curse dem, bikos of wetin dem dey tink sey dey good or bad.
1 Ora, ao que é fraco na fé, acolhei-o, mas não para condenar-lhe os escrúpulos.
2 Some pipol tink sey e dey rite to chop any food and odas wey dia faith dey weak, dey chop only vegitabol.
2 Um crê que de tudo se pode comer, e outro, que é fraco, come só legumes.
3 Since God dey welkom evribody, make una nor kondemn odas bikos dem chop or dem nor chop wetin una like.
3 Quem come não despreze a quem não come; e quem não come não julgue a quem come; pois Deus o acolheu.
4 Wish rite yu get to kondemn anoda pesin savant? Na only dia oga fit tok weda dem dey do well and e must make sure sey, dem do di rite tin.
4 Quem és tu, que julgas o servo alheio? Para seu próprio senhor ele está em pé ou cai; mas estará firme, porque poderoso é o Senhor para o firmar.
5 Some pipol tink sey one day betta pass anoda and some tink sey, evriday na di same. But make evribody bilive wetin dem won bilive.
5 Um faz diferença entre dia e dia, mas outro julga iguais todos os dias. Cada um esteja inteiramente convicto em sua própria mente.
6 Anybody wey tink sey one day betta pass anoda, dey do so to honor God. And anybody wey chop meat, dey tank God just like di pesin wey nor won chop.
6 Aquele que faz caso do dia, para o Senhor o faz. E quem come, para o Senhor come, porque dá graças a Deus; e quem não come, para o Senhor não come, e dá graças a Deus.
7 Nobody dey live or die for ensef. Weda wi die or wi live, na God still get us.
7 Porque nenhum de nós vive para si, e nenhum morre para si.
8 If wi live, na God wi dey live for; if wi die, na God wi still die for. So, weda wi die or wi live, na God still get us.
8 Pois, se vivemos, para o Senhor vivemos; se morremos, para o Senhor morremos. De sorte que, quer vivamos quer morramos, somos do Senhor.
9 Dis na bikos Christ die and e kom back to life, so dat e go bi Oga God to pipol wey don die and doz wey dey alive.
9 Porque foi para isto mesmo que Cristo morreu e tornou a viver, para ser Senhor tanto de mortos como de vivos.
10 But why yu dey kondemn oda Christians? Why yu dey si dem as small shidren? Di day dey kom wen God go judge all of us.
10 Mas tu, por que julgas teu irmão? Ou tu, também, por que desprezas teu irmão? Pois todos havemos de comparecer ante o tribunal de Deus.
11 God word sey, “Weda dem like am or not, evribody go knee down for my front kon sey na mi bi God.”
11 Porque está escrito: Por minha vida, diz o Senhor, diante de mim se dobrará todo joelho, e toda língua louvará a Deus.
12 So, all of us go tell God wetin wi do with awa life.
12 Assim, pois, cada um de nós dará conta de si mesmo a Deus.
13 So, make wi nor dey judge one anoda and make wi nor spoil anoda pesin faith.
13 Portanto não nos julguemos mais uns aos outros; antes o seja o vosso propósito não pôr tropeço ou escândalo ao vosso irmão.
14 As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin.
14 Eu sei, e estou certo no Senhor Jesus, que nada é de si mesmo imundo a não ser para aquele que assim o considera; para esse é imundo.
15 Bikos if di food wey yu chop make yor broda or sista vex for yu, den yu nor dey show love again. So make yu nor let di kind food wey yu dey chop, offend di pesin wey Jesus Christ die for.
15 Pois, se pela tua comida se entristece teu irmão, já não andas segundo o amor. Não faças perecer por causa da tua comida aquele por quem Cristo morreu.
16 Nor let pipol curse Jesus Christ, bikos of di food wey yu dey chop.
16 Não seja pois censurado o vosso bem;
17 Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol.
17 porque o reino de Deus não consiste no comer e no beber, mas na justiça, na paz, e na alegria no Espírito Santo.
18 If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.
18 Pois quem nisso serve a Cristo agradável é a Deus e aceito aos homens.
19 So, make wi live for peace, den wi go help each oda grow as dem dey serve God.
19 Assim, pois, sigamos as coisas que servem para a paz e as que contribuem para a edificação mútua.
20 Nor skata God work bikos of food. Evry food dey okay, but e nor good make yu chop wetin go spoil anoda pesin faith.
20 Não destruas por causa da comida a obra de Deus. Na verdade tudo é limpo, mas é um mal para o homem dar motivo de tropeço pelo comer.
21 E betta make yu nor chop meat, drink wine or do anytin wey fit spoil yor brodas faith.
21 Bom é não comer carne, nem beber vinho, nem fazer outra coisa em que teu irmão tropece.
22 Anytin wey yu bilive about dis matter, make yu keep am to yorsef and God wey dey heaven, dey si am. God don bless di pesin wey nor kondemn ensef, bikos of wetin e do.
22 A fé que tens, guarda-a contigo mesmo diante de Deus. Bem-aventurado aquele que não se condena a si mesmo naquilo que aprova.
23 But if yu dey doubt wetin yu chop, den yu dey kondemn yorsef and yu know sey dat nor good, bikos anytin wey yu do against wetin yu bilive, na sin.
23 Mas aquele que tem dúvidas, se come está condenado, porque o que faz não provém da fé; e tudo o que não provém da fé é pecado.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.