Romanos 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Make evribody obey di pipol wey dey rule dem. Bikos na only God dey give authority and put pipol for pawa.
1 Toda a alma esteja sujeita às potestades superiores; porque não há potestade que não venha de Deus; e as potestades que há foram ordenadas por Deus.
2 So anybody wey dey disobey dia ruler, dey disobey God and God go ponish am.
2 Por isso quem resiste à potestade resiste à ordenação de Deus; e os que resistem trarão sobre si mesmos a condenação.
3 Bikos doz wey dey do good, nor go get problem with dia rulers, so dem nor nid to fear. Make una just do wetin dey good and dem go praiz una.
3 Porque os magistrados não são terror para as boas obras, mas para as más. Queres tu, pois, não temer a potestade? Faze o bem, e terás louvor dela.
4 Bikos all rulers na God savant and na dia duty to help una. If una do bad, den make una fear, bikos dis rulers get pawa to ponish una. Dem bi God savants wey dey ponish doz wey do bad tins.
4 Porque ela é ministro de Deus para teu bem. Mas, se fizeres o mal, teme, pois não traz debalde a espada; porque é ministro de Deus, e vingador para castigar o que faz o mal.
5 But una must obey di rulers, bikos una know sey naim bi di rite tin to do, nor bi bikos God go vex for una.
5 Portanto é necessário que lhe estejais sujeitos, não somente pelo castigo, mas também pela consciência.
6 Una must still pay una tax too. Di rulers na God savants and na dia work to kare for all dis matter.
6 Por esta razão também pagais tributos, porque são ministros de Deus, atendendo sempre a isto mesmo.
7 Make una pay evritin wey una dey whole; weda na tax, respet or honor.
7 Portanto, dai a cada um o que deveis: a quem tributo, tributo; a quem imposto, imposto; a quem temor, temor; a quem honra, honra.
8 Make love bi di only tin wey yu dey whole! If yu love odas, yu don do evritin wey di law tok.
8 A ninguém devais coisa alguma, a não ser o amor com que vos ameis uns aos outros; porque quem ama aos outros cumpriu a lei.
9 Di law get difren-difren kommand like, “Nor kommit adultery; nor kill pesin; nor tif; nor put eye for anoda man propaty.” All dis na just one kommand wey sey, “Make pipol love odas, just as dem love diasef.”
9 Com efeito: Não adulterarás, não matarás, não furtarás, não darás falso testemunho, não cobiçarás; e se há algum outro mandamento, tudo nesta palavra se resume: Amarás ao teu próximo como a ti mesmo.
10 If yu love pesin, yu nor go do am bad. So, na love bi di main tin wey di law dey tok about.
10 O amor não faz mal ao próximo. De sorte que o cumprimento da lei é o amor.
11 Since una know di time wey wi dey naw, make una dey bihave well, bikos di time don rish wen una go wake-up from sleep. Una know sey di day wey God go give us salvashon, don near well-well pass as e bi wen wi first bilive.
11 E isto digo, conhecendo o tempo, que já é hora de despertarmos do sono; porque a nossa salvação está agora mais perto de nós do que quando aceitamos a fé.
12 Nite don nearly finish and day go soon break. So make wi stop to bihave like pipol wey dey darkness and make wi ready to waka for lite.
12 A noite é passada, e o dia é chegado. Rejeitemos, pois, as obras das trevas, e vistamo-nos das armas da luz.
13 So make wi dey bihave well as pipol dey do for day time. Nor go anyhow party or drink too mush, den kon dey bihave anyhow. Nor kworel or judge pipol.
13 Andemos honestamente, como de dia; não em glutonarias, nem em bebedeiras, nem em desonestidades, nem em dissoluções, nem em contendas e inveja.
14 Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.
14 Mas revesti-vos do Senhor Jesus Cristo, e não tenhais cuidado da carne em suas concupiscências.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.