Oséias 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.
1 Palavra do Senhor que veio a Oséias, filho de Beeri, durante os reinados de Uzias, Jotão, Acaz e Ezequias, reis de Judá, e de Jeroboão, filho de Jeoás, rei de Israel:
2 Wen God first tok to Israel pipol thru Hosea, E tell am, “Make yu go marry ashawo and just as my pipol don leave mi and nor dey faithful to mi, na so too yor wife nor go dey faithful to yu and e go born shidren wey nor go know dia papa.”
2 Quando o Senhor começou a falar por meio de Oséias, o Senhor lhe disse: "Vá, tome uma mulher adúltera e filhos da infidelidade, porque a nação é culpada do mais vergonhoso adultério por afastar-se do Senhor".
3 So Hosea go marry one girl wey bi Diblaim pikin and en name na Gomer. Afta dem don born dia first pikin wey bi boy,
3 Por isso ele se casou com Gômer, filha de Diblaim; ela engravidou e lhe deu um filho.
4 God tell Hosea, “Make yu koll am ‘Jezrel,’ bikos e nor go tey before I go ponish Israel king, bikos of di pipol wey dia grand-grand papa Jehu kill for Jezrel. I go skata Israel kingdom rish groun.
4 Então o Senhor disse a Oséias: "Dê a ele o nome de Jezreel, porque logo castigarei a dinastia de Jeú por causa do massacre ocorrido em Jezreel, e darei fim ao reino de Israel.
5 Dat time, I go distroy Israel sojas for Jezrel Valley.”
5 Naquele dia quebrarei o arco de Israel no vale de Jezreel".
6 Gomer, Hosea wife kon born anoda pikin, but dis time, na girl. Den God tell Hosea, “Yu go koll dis one, ‘Lo-Ruhamah wey mean: No-pity,’ bikos I nor go show Israel pipol love or forgive dem again.
6 Gômer engravidou novamente e deu à luz uma filha. Então o Senhor disse a Oséias: "Dê a ela o nome de Lo-Ruama, pois não mais mostrarei amor para com a nação de Israel, a ponto de perdoá-la.
7 But I go love and sorry for Judah pipol. Mi wey bi dia Oga God, go save dem, but e nor go bi thru war, swod, bow, arrow, horse or doz wey dey ride di horse dem.”
7 Contudo, tratarei com amor a nação de Judá; e eu lhes concederei vitória, não pelo arco, pela espada ou por combate, nem por cavalos e cavaleiros, mas pelo Senhor, o seu Deus".
8 Afta Gomer don stop to breast feed Lo-Ruhamah, e kon get belle again and e born anoda boy.
8 Depois de ter desmamado Lo-Ruama, Gômer teve outro filho.
9 So God tell Hosea, “Make yu koll dis one, ‘Nor bi my pipol (Lo-Ammi),’ bikos Israel pipol nor bi my pipol and I nor bi dia God.”
9 Então o Senhor disse: "Dê a ele o nome de Lo-Ami, pois vocês não são meu povo, e eu não sou seu Deus.
10 But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”
10 "Contudo os israelitas ainda serão como a areia da praia, que não se pode medir nem contar. No lugar onde se dizia a eles: ‘Vocês não são meu povo’, eles serão chamados ‘filhos do Deus vivo’.
11 Den Judah and Israel pipol go kom togeda as one again. Dem go choose one pesin wey go lead dem and dem go plenty kon prosper for dia land again. Yes! Dat day for Jezrel, go dey great well-well!
11 O povo de Judá e o povo de Israel serão reunidos, e eles designarão para si um só líder, e se levantarão da terra, pois será grande o dia de Jezreel.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Oséias 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.