Números 16
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Naw some pipol from Reuben tribe kon sin, dis pipol na: Korah wey Izhar born, wey Kohat born, wey Levi born with Datan and Abiram wey Eliab bi dia papa and On wey Pelet born.
1 — ausente —
2 Dem with some Israel pipol (two hundred and fifty popula prince from di kommunity) kon dey tok against Moses.
2 — ausente —
3 Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”
3 Eles foram juntos falar com Moisés e Arão e disseram: — Agora chega! Todo o povo pertence a Deus, o
4 Wen Moses hear wetin dem tok, e bow for groun kon start to pray.
4 Quando Moisés ouviu isso, ajoelhou-se, encostou o rosto no chão
5 Den e tell Korah and doz wey dey follow am sey, “Tumoro morning, God go show us who bi en own and who dey holy. Na only di pesin wey bi God own go fit enter en Holy Place.
5 e disse o seguinte a Corá e a todos os seus seguidores: — Amanhã cedo o
6 Tumoro morning yu and doz wey dey follow yu: make una bring una burn ofrin kontaina.
6 — ausente —
7 Una go lite fire, put incense inside, den karry am go di altar. Den wi go si di pesin own wey God go take. Levi pipol, na una own worse pass!”
7 — ausente —
8 Moses tell Korah pipol again, “Levi pipol, make una listin to mi!
8 Moisés disse também a Corá: — Agora escutem, levitas!
9 Una tink sey e nor mean anytin to God wey choose una among Israel pipol to dey near am, so dat una go fit serve am for en Tabanako kon stand and dey prish to di pipol?
9 O Deus de Israel os separou do resto do povo para poderem chegar perto dele, para fazerem o seu serviço na Tenda do Senhor e para realizarem as cerimônias em favor do povo. Será que isso não basta para vocês?
10 E don already give dis tins to both una and una fellow Levi pipol. And naw, una sey una won bi priest too!
10 Deus deu a você e a todos os outros levitas esse privilégio, e agora vocês estão querendo também ser sacerdotes?
11 So, na God una dey gada against! Who Aaron bi wey una dey komplain about?”
11 Quando vocês reclamam contra Arão, na verdade é contra o Senhor que você e os seus seguidores estão se revoltando.
12 So Moses koll Datan and Abiram wey Eliab born, but dem ansa am, “Wi nor go kom.
12 Então Moisés mandou chamar Datã e Abirão, filhos de Eliabe, mas eles responderam aos mensageiros: — Nós não vamos!
13 Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant?
13 Será que não basta você nos ter tirado de uma terra boa e rica a fim de nos fazer morrer neste deserto? E além disso ainda quer mandar em nós?
14 Yu neva take us go any land where milk and honey full or sey yu give us where get vineyard as awa propaty. Yu tink sey yu go fit deceive us? Wi nor go kom.”
14 Na verdade você não nos trouxe para uma terra boa e rica, nem nos deu campos e plantações de uvas para serem nossa propriedade; e ainda por cima está querendo nos enganar. Nós não vamos!
15 Moses vex well-well kon tell God, “Make Yu nor asept dia ofrin. I nor tif dia animal or do any bad tin against dem.”
15 Então Moisés ficou muito zangado e disse a Deus, o Senhor : — Não aceites as ofertas desses homens. Eu nunca prejudiquei a nenhum deles, nem tirei deles nem mesmo um jumento!
16 Den Moses tell Korah, “Tumoro make yu and doz wey dey follow yu kom stand for God present and Aaron go kom too.
16 Aí Moisés disse a Corá: — Amanhã você e os seus duzentos e cinquenta seguidores venham até a Tenda Sagrada. Arão também estará ali.
17 Make each of una take en own kontaina with incense kom meet God: Both Aaron and una two hundred and fifty kontaina with incense. Each pesin among una with en own kontaina wey incense full.”
17 Cada um de vocês pegará o seu queimador de incenso, colocará incenso nele e o levará até o altar.
18 So all of dem take dia kontaina with incense kon lite fire put, den dem stand for di tent where dem for dey do meetin door-mot, with Moses and Aaron.
18 Assim, cada homem pegou o seu queimador de incenso, pôs brasas e incenso nele, e todos ficaram na entrada da Tenda Sagrada com Moisés e Arão.
19 Wen Korah gada di kommunity against Moses and Aaron for di tent door-mot, God glory kon appear to di whole kommunity.
19 Então Corá reuniu todo o povo, e eles ficaram diante de Moisés e Arão na entrada da Tenda. De repente, a glória do Senhor apareceu a todo o povo,
20 God tell Moses and Aaron:
20 e o Senhor disse a Moisés e a Arão:
21 “Make una komot from among dis kommunity, so dat I go distroy dem kwik-kwik.”
21 — Saiam do meio dessa gente, pois eu vou acabar com eles agora mesmo.
22 Den dem fall face groun kon sey, “My God, di God of all pipol spirit, Yu go vex for di whole kommunity wen e bi sey na only one pesin sin?”
22 Mas Moisés e Arão se ajoelharam, encostaram o rosto no chão e disseram: — Ó Deus, tu dás vida a todos. Será que por causa do pecado de uma só pessoa vais ficar
23 So God tell Moses:
23 Então o Senhor respondeu a Moisés:
24 “Make yu tell di whole kommunity sey: ‘Make dem komot from Korah, Datan and Abiram tent.’ ”
24 — Diga ao povo que saia de perto das barracas de Corá, Datã e Abirão.
25 So Moses get up go meet Datan and Abiram and di eldas for Israel, follow am.
25 Aí Moisés saiu e, junto com os líderes do povo, foi para onde estavam Datã e Abirão.
26 E kon tell di kommunity sey, “Make una komot from doz wiked pipol tent and nor tosh anytin wey bi dia own, if not, God go distroy una bikos of dia sin.”
26 E Moisés disse ao povo: — Afastem-se das barracas desses homens maus e não toquem em nada que seja deles; se não, vocês também serão destruídos por causa dos pecados deles.
27 So dem komot from Korah, Datan and Abiram tent. Den Datan and Abiram kom out kon stand for di tent door-mot with dia wifes and shidren.
27 Aí o povo se afastou das barracas de Corá, Datã e Abirão. Datã e Abirão saíram e ficaram na entrada da sua barraca, com as suas mulheres e filhos.
28 Moses kon sey, “Na so una go take know sey na God send mi kom do dis work, bikos I nor dey do am by mysef.
28 Então Moisés disse ao povo: — Eu vou dizer como vocês vão ficar sabendo que não fui eu quem resolveu fazer tudo isso. Fiz todas essas coisas porque o
29 If dis men die normal deat without sey God ponish dem, den nor bi God send mi.
29 Se estes homens tiverem morte natural como todos os outros, sem nenhum castigo de Deus, então o Senhor não me enviou.
30 But if God do sometin wey neva happen before and di eart open swallow dem with all wetin dem get and dem die alive, den una go know sey dis men don rijet God.”
30 Mas, se ele fizer acontecer alguma coisa fora do comum, e se a terra se abrir e engolir essa gente com tudo o que eles têm, e eles descerem vivos para o mundo dos mortos , vocês ficarão sabendo que estes homens rejeitaram o Senhor .
31 Wen e tok finish, di groun under Datan and Abiram open
31 E aconteceu que, assim que Moisés acabou de falar, a terra se abriu debaixo deles
32 kon swallow dem, with dia tent, all Korah men and with all dia propaty.
32 e os engoliu com as suas famílias, junto com todos os seguidores de Corá e tudo o que eles tinham.
33 Dem and all wetin dem get enter groun alive, den di eart klose against dem. So dem die komot di kommunity.
33 Assim, desceram vivos para o mundo dos mortos, eles e tudo o que possuíam. A terra os cobriu, e eles desapareceram.
34 Israel pipol wey dey der kon run komot wen dem hear di pipol dey kry. Dem kon dey shaut sey, “Make wi run o-o! Di eart fit swallow us too!”
34 Ao ouvirem os gritos deles, todos os israelitas que estavam ali saíram correndo e gritando: — A terra vai engolir a gente também!
35 Den God send fire kon distroy di two hundred and fifty men wey lite incense.
35 Então o Senhor enviou fogo e matou os duzentos e cinquenta homens que haviam oferecido incenso.
36 God tell Moses:
36 Aí o Senhor Deus disse a Moisés:
37 “Make yu tell Eleazar wey Aaron di priest born sey, make e pick di kontaina wey dem dey put incense komot from di fire, bikos dem dey holy, den make dem pak di shako go far.
37 — Diga a Eleazar, filho do sacerdote Arão, que pegue os queimadores de incenso do meio dos restos do incêndio e espalhe para longe as brasas que ainda estiverem neles, pois os queimadores de incenso são sagrados.
38 Di pipol wey die bikos of dia sin, make una use dia kontaina take make wetin dem go take kover di altar, bikos dem offa am to God, so dem dey klean. Dem go bi sign for Israel pipol.”
38 Eles ficaram sagrados quando foram oferecidos no altar do Senhor . Portanto, pegue os queimadores de incenso desses homens que foram mortos por causa dos seus pecados e deles faça folhas finas de metal. E com essas folhas prepare uma cobertura para o altar. Isso será um aviso para o povo de Israel.
39 So Eleazar take di bronze kontaina kon use dem do kover for di altar.
39 Então o sacerdote Eleazar pegou os queimadores de incenso de metal que os homens que tinham sido mortos haviam trazido e mandou que deles fossem feitas folhas de metal para cobrir o altar.
40 Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.
40 Conforme o Senhor tinha dito a Moisés, isso ficou sendo um aviso para os israelitas a fim de que nenhuma pessoa que não seja descendente de Arão venha a queimar incenso diante do Senhor e seja castigada, como aconteceu com Corá e com os seus seguidores.
41 But for di next day, di whole kommunity kon dey komplain against Moses and Aaron sey, “Una don kill God pipol.”
41 Mas no dia seguinte todos os israelitas começaram a reclamar contra Moisés e Arão, dizendo assim: — Vocês mataram o povo de Deus, o
42 Afta dem gada against Moses and Aaron, dem turn face di tent where dem for dey do meetin kon si di kloud kover am and God glory kon appear.
42 Depois que todos se reuniram para protestar contra Moisés e Arão, eles se viraram para a Tenda Sagrada e viram que a nuvem a estava cobrindo. Então a glória do Senhor apareceu.
43 Den Moses and Aaron stand for di tent where dem for dey do meetin.
43 Moisés e Arão foram até a frente da Tenda,
44 God tell Moses,
44 e o Senhor disse a Moisés:
45 “Make yu komot from dis kommunity, so dat I go distroy dem naw-naw!” Moses and Aaron kon bow face groun.
45 — Saiam do meio desse povo, pois vou destruí-lo agora mesmo! Aí Moisés e Arão se ajoelharam e encostaram o rosto no chão.
46 Den Moses tell Aaron, “Make yu take di kontaina with incense kon put fire inside am from di altar. Den kwik go di kommunity side go do sakrifice to make dem holy, bikos God go send one bad diziz kon meet dem, since E dey vex for dem.”
46 E Moisés disse a Arão: — Pegue o seu queimador de incenso, ponha nele algumas brasas do altar e jogue incenso em cima delas. E vá depressa até o lugar onde o povo está e ofereça o
47 So Aaron do wetin Moses kommand and e run enter di pipol centre. Naw di diziz just dey start among di pipol. Aaron put di incense for der kon make dem holy.
47 Então Arão pegou o queimador de incenso, conforme Moisés havia mandado, e correu para o meio do povo. Quando viu que a epidemia já havia começado, Arão jogou o incenso nas brasas e ofereceu o sacrifício para conseguir o perdão dos pecados do povo.
48 E stand between doz wey don die and doz wey dey alive kon stop di diziz.
48 Com isso a epidemia parou, e Arão ficou de pé entre os vivos e os mortos.
49 Naw, di pipol wey die with di diziz na 14,700 plus di pipol wey die bikos of Korah matter.
49 Naquela epidemia morreram catorze mil e setecentas pessoas, fora as que morreram na revolta de Corá.
50 Afta di diziz stop, Aaron kon go meet Moses for di tent door-mot.
50 Quando acabou a epidemia, Arão voltou para a entrada da Tenda, onde Moisés estava.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Números 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.