Números 14
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Den di pipol kon kry and dem kry well-well till di next day.
1 Toda a assembléia pôs-se a gritar e chorou aquela noite.
2 Israel pipol kon bigin komplain against Moses and Aaron sey, “E for betta sey wi die for Egypt or for di wildaness!
2 Todos os israelitas murmuraram contra Moisés e Aarão, dizendo: "Oxalá tivéssemos morrido no Egito ou neste deserto!
3 Wetin make God bring us kom dis land, so dat dem go kill us for war? Dem go katch awa wifes and shidren go as slaves! E for betta sey wi go Egypt back o-o?”
3 Por que nos conduziu o Senhor a esta terra para morrermos pela espada? Nossas mulheres e nossos filhos serão a presa do inimigo. Não seria melhor que voltássemos para o Egito?"
4 So dem kon dey tell demsef sey, “Make wi choose new leader wey go take us go Egypt back!”
4 E diziam uns para os outros: "Escolhamos um chefe e voltemos para o Egito."
5 Den Moses and Aaron fall face groun for di pipol front.
5 Moisés e Aarão caíram com o rosto por terra diante de toda a assembléia dos israelitas.
6 Joshua wey Nun born and Kaleb wey Jefunneh born wey dey among di men wey go shek di land kon tear dia klot, bikos dem dey vex
6 Josué, filho de Nun, e Caleb, filho de Jefoné, que tinham explorado a terra,
7 den dem sey, “Di land wey wi go shek dey good well-well.
7 rasgaram as suas vestes e disseram a toda a assembléia dos israelitas: "A terra que percorremos é muito boa.
8 If God dey happy with us, E go take us go der kon give us dat land wey full with milk and honey.
8 Se o Senhor nos for propício, introduzir-nos-á nela e no-la dará; é uma terra onde corre leite e mel.
9 Make una nor dey sturbon to God and make una nor fear di pipol wey dey di land, bikos dem bi like bread to us. God dey with us and E don defeat di gods wey dey protet dem; so make una nor fear.”
9 Somente não vos revolteis contra o Senhor, e não tenhais medo do povo dessa terra: devorá-lo-emos como pão. Não há mais salvação para eles, porque o Senhor está conosco. Não tenhais medo deles."
10 But di pipol kon dey plan to stone Joshua and Kaleb. Den God lite kon appear to Israel pipol for di Tabanako.
10 Toda a assembléia estava a ponto de apedrejá-los, quando a glória do Senhor apareceu sobre a tenda de reunião a todos os israelitas.
11 Den God tell Moses, “How long my pipol go rijet mi? Dem nor go ever bilive mi, even afta all di signs wey I don do for dia present?
11 O Senhor disse a Moisés: "Até quando me desprezará esse povo? Até quando não acreditará em mim, apesar de todos os prodígios que fiz no meio dele?
12 I go strike dem with diziz kon distroy dem, den I go make anoda nashon thru yu and e go dey great and mighty pass dem!”
12 Vou destruí-lo, ferindo-o de peste, mas farei de ti uma nação maior e mais poderosa do que ele."
13 But Moses ansa, “Na Yu bring dis pipol komot from Egypt with yor pawa. Egypt pipol know wetin Yu don do for yor pipol wen Yu save dem.
13 Moisés disse ao Senhor: "Os egípcios viram que, por vosso poder, tirastes este povo do meio deles e o disseram aos habitantes dessa terra.
14 Naw, if Yu distroy dem, wetin yu wont make Egypt pipol tell di pipol for dis land, wey don already bilive sey Yu dey among yor pipol? My God, dem know sey Yu don appear to yor pipol face-to-face. Yor kloud dey kover dem for day time and for nite, yor fire dey with dem.
14 Todo mundo sabe, ó Senhor, que estais no meio desse povo, e sois visto face a face, ó Senhor, que vossa nuvem está sobre eles e marchais diante deles de dia numa coluna de nuvem, e de noite numa coluna de fogo.
15 If Yu kill all yor pipol, di nashons wey don hear about Yu go kon sey,
15 Se fizerdes morrer todo esse povo, as nações que ouviram falar de vós dirão:
16 ‘Na bikos Yu nor fit take yor pipol go di land wey Yu promise dem, naim make Yu kill dem for di wildaness.’
16 o Senhor foi incapaz de introduzir o povo na terra que lhe havia jurado dar, e exterminou-o no deserto.
17 “So my God, I dey pray, make Yu show yor pawa kon give us wetin Yu promise wen Yu sey,
17 Agora, pois, rogo-vos que o poder do Senhor se manifeste em toda a sua grandeza, como o dissestes:
18 ‘Mi wey bi God, I nor dey kwik vex and I dey show my love and goodness well-well. I dey forgive pipol sins and sturbones, but I go still ponish dia shidren-shidren go rish dia third and fourt generashon, bikos of di sin wey dia papa and mama kommit.’
18 O Senhor é lento para a cólera e rico em bondade; ele perdoa a iniqüidade e o pecado, mas não tem por inocente o culpado, e castiga a iniqüidade dos pais nos filhos até a terceira e a quarta geração.
19 Abeg, make Yu forgive dis pipol akordin to yor love wey nor dey shange; wey strong well-well, just as Yu take forgive dem for Egypt kon rish naw.”
19 Perdoai o pecado desse povo segundo a vossa grande misericórdia, como já o tendes feito desde o Egito até aqui."
20 Den God ansa, “I don forgive dem as yu tok.
20 O Senhor respondeu: "Eu perdôo, conforme o teu pedido.
21 But I promise sey, as long as I dey,
21 Mas, pela minha vida e pela minha glória que enche toda a terra,
22 non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.
22 nenhum dos homens que viram a minha glória e os prodígios que fiz no Egito e no deserto, que me provocaram já dez vezes e não me ouviram,
23 Doz wey rijet mi nor go ever enter di land wey I promise dia grand-grand papa.
23 verá a terra que prometi com juramento aos seus pais. Nenhum daqueles que me desprezaram a verá.
24 But bikos my savant Kaleb nor bihave like di oda men and bikos e obey mi, I go take am go di land wey e go spy and en shidren-shidren go stay der.
24 Quanto ao meu servo Caleb, porém, que animado de outro espírito me obedeceu fielmente, eu o introduzirei na terra que ele percorreu, e a sua posteridade a possuirá.
25 (Naw Amalek and Kanaan pipol dey stay for di valley.) Tumoro, make una turn back kon travel go di wildaness for di road wey dey near di Red Sea.”
25 Visto que os amalecitas e os cananeus habitam no vale, voltai amanhã e parti para o deserto em direção ao mar Vermelho."
26 God tell Moses and Aaron:
26 O Senhor disse a Moisés e a Aarão:
27 “How long I go take bear di evil wey di pipol dey tok about mi? I don hear Israel pipol komplain about mi.
27 "Até quando sofrerei eu essa assembléia revoltada que murmura contra mim? Ouvi as murmurações que os israelitas proferem contra mim.
28 Make una tell dem sey, ‘As long as I dey, I go do anytin wey yu sey make I do. Na mi wey bi God tok am.
28 Dir-lhes-ás: juro por mim mesmo, diz o Senhor, tratar-vos-ei como vos ouvi dizer.
29 Una dead body go skata for dis wildaness, bikos una don komplain against mi. Nobody among una wey bi from twenty years go up, go enter di land.
29 Vossos cadáveres cairão nesse deserto. Todos vós que fostes recenseados da idade de vinte anos para cima, e que murmurastes contra mim,
30 I promise sey I go give Israel pipol di land, but una nor go enter der, apart from Kaleb and Joshua.
30 não entrareis na terra onde jurei estabelecer-vos, exceto Caleb, filho de Jefoné, e Josué, filho de Nun.
31 Una sey dem go katch una shidren, but I go take dem go di land wey una rijet and e go bi dia own.
31 Todavia, introduzirei nela os vossos filhinhos, dos quais dizíeis que seriam a presa do inimigo, e eles conhecerão a terra que desprezastes.
32 Una go die for dis wildaness.
32 Quanto a vós, os vossos cadáveres ficarão nesse deserto,
33 Una go waka anyhow for di wildaness for forty years kon sofa until di last pesin among una go die, bikos una nor good at-all.
33 onde os vossos filhos guardarão os seus rebanhos durante quarenta anos, pagando a pena de vossas infidelidades, até que vossos cadáveres apodreçam no deserto.
34 Akordin to di days wey una take shek di land, na so too una go sofa for una sin for forty years; one day go bi for one year, den una go know how e bi to make mi vex!’
34 Explorastes a terra em quarenta dias; tantos anos quantos foram esses dias pagareis a pena de vossas iniqüidades, ou seja, durante quarenta anos, e vereis o que significa ser objeto de minha vingança.
35 Mi God don sey, ‘I go do wetin I tell dis wiked pipol wey gada togeda against mi. All of dem go die for dis wildaness. Mi wey bi God, don tok.’ ”
35 Eu, o Senhor, o disse. Eis como hei de tratar essa assembléia rebelde que se revoltou contra mim. Eles serão consumidos e mortos nesse deserto!"
36 Di men wey Moses send go shek di land, wey kom back kon make Israel pipol dey komplain against God, bikos of di bad tin wey dem tok about di land;
36 Os homens que Moisés tinha enviado a explorar a terra e que, depois de terem voltado, tinham feito murmurar contra ele toda a assembléia,
37 doz men wey bring di evil ripot about di land, God kon kill dem with diziz.
37 depreciando a terra, morreram feridos por uma praga, diante do Senhor.
38 And out of di twelf pipol wey Moses send go shek di land, na only Joshua and Kaleb, remain.
38 Somente Josué, filho de Nun, e Caleb, filho de Jefoné, sobreviveram entre todos os que tinham explorado a terra.
39 Wen Moses tell Israel pipol wetin God tok, dem kon dey komplain more-more.
39 Moisés referiu tudo isso aos filhos de Israel, e o povo ficou profundamente desolado.
40 Early di next morning, dem start to travel go di hill kountries kon sey, “Naw wi don ready to go di place wey God don dey tell us. Wi know sey wi don sin.”
40 Levantaram-se de madrugada e se puseram a caminho para o cimo do monte dizendo: "Estamos prontos a subir para o lugar de que falou o Senhor, porque pecamos."
41 But Moses ansa dem, “Den why una kon dey disobey God? Una nor go fit win!
41 Moisés disse-lhes: "Por que transgredis a ordem do Senhor? Isto não será bem sucedido.
42 Make una nor go, bikos God nor dey with una and una enemies go win una,
42 Não subais; sereis derrotada por vossos inimigos, pois o Senhor não está no meio de vós.
43 bikos Amalek and Kanaan pipol dey wait una and dem go kill una well-well. Bikos una don turn from God, E nor go-go with una.”
43 Os amalecitas e os cananeus estão diante de vós, e sucumbireis sob a sua espada, porque vos desviasses do Senhor. O Senhor não estará convosco."
44 But dem still go di kountry on-top di hill, even doh God Kovenant Box and Moses nor dey with dem.
44 Eles obstinaram-se em querer subir até o cimo do monte; a arca da aliança do Senhor, porém, e Moisés, não saíram do acampamento.
45 Amalek and Kanaan pipol for der kon attack and porshu dem go rish Hormah.
45 Então os amalecitas e os cananeus, que habitavam nessa montanha, desceram e, tendo-os batido e retalhado, perseguiram-nos até Horma.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Números 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.