Neemias 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 All of dem gada for Jerusalem for one hall wey dey di Wota Gate front. Dem kon tell Ezra wey sabi di law sey make e go bring di Law Book wey God give Israel thru Moses.
1 todo o povo juntou-se como se fosse um só homem na praça, em frente da porta das Águas. Pediram ao escriba Esdras que trouxesse o Livro da Lei de Moisés, que o Senhor dera a Israel.
2 So Ezra wey bi priest karry am kom where di pipol gada put, both men, wimen and shidren wey don get sense.
2 Assim, no dia primeiro do sétimo mês, o sacerdote Esdras trouxe a Lei diante da assembléia, que era constituída de homens e mulheres e de todos os que podiam entender.
3 E read di law for di hall wey dey near di gate from morning go rish aftanoon and all of dem listin well-well.
3 Ele a leu em voz alta desde o raiar da manhã até o meio-dia, de frente para a praça, em frente da porta das Águas, na presença dos homens, mulheres e de outros que podiam entender. E todo o povo ouvia com atenção a leitura do Livro da Lei.
4 Ezra stand on-top stage wey dem build, bikos of dis meetin. Di men wey stand for en rite side na: Mattitaya, Shema, Anaya, Uriaya, Hilkaya and Maaseaya, while di men wey stand for en left na: Pedaaya, Mishael, Malkijah, Hashum, Hashbaddanah, Zekaraya and Meshullam.
4 O escriba Esdras estava numa plataforma elevada, de madeira, construída para a ocasião. Ao seu lado, à direita, estavam Matitias, Sema, Anaías, Urias, Hilquias e Maaséias; e à esquerda estavam Pedaías, Misael, Malquias, Hasum, Hasbadana, Zacarias e Mesulão.
5 As Ezra stand on-top di stage, all di pipol kon dey look am. All of dem stand up as e just open di book.
5 Esdras abriu o livro diante de todo o povo, e este podia vê-lo, pois ele estava num lugar mais alto. E, quando abriu o livro, o povo todo se levantou.
6 Ezra kon sey, “Make wi praiz di Oga wey bi di great God!” All di pipol raiz dia hand go up kon ansa, “Amen! Amen!” Dem knee down, bow and woship God.
6 Esdras louvou o Senhor, o grande Deus, e todo o povo ergueu as mãos e respondeu: "Amém! Amém! " Então eles adoraram o Senhor, prostrados, rosto em terra.
7 Afta, Levi pipol wey bi: Jeshua, Bani, Sherebaya, Jamin, Akkub, Shabbetai, Hodaya, Maaseaya, Kelita, Zabud, Jozabad, Hanan and Pelaaya kon esplain di law give di pipol wey stand der dey listin.
7 Os levitas Jesua, Bani, Serebias, Jamim, Acube, Sabetai, Hodias, Maaséias, Quelita, Azarias, Jozabade, Hanã e Pelaías, instruíram o povo na Lei, e todos permaneciam ali.
8 Dem read and esplain God law, so dat di pipol go undastand am.
8 Leram o Livro da Lei de Deus, interpretando-o e explicando-o, a fim de que o povo entendesse o que estava sendo lido.
9 Wen di pipol hear wetin dem read for di law, di word tosh dem sotey dem kon start to kry. So Nehemaya wey bi di govnor, Ezra wey bi priest wey know di law well-well and Levi pipol wey dey esplain di law kon tell all di pipol, “Today dey holy for di Oga wey bi una God, so una nor suppose mourn or kry.
9 Então Neemias, o governador, Esdras, o sacerdote e escriba, e os levitas que estavam instruindo o povo disseram a todos: "Este dia é consagrado ao Senhor Deus. Nada de tristeza e de choro! " Pois todo o povo estava chorando enquanto ouvia as palavras da Lei.
10 “Naw, make una go house go celebrate. Share food and wine with pipol wey nor get. Today na holy day for awa Oga God, so make una nor kry, bikos na God happiness dey make una strong.”
10 E Neemias acrescentou: "Podem sair, e comam e bebam do melhor que tiverem, e repartam com os que nada têm preparado. Este dia é consagrado ao nosso Senhor. Não se entristeçam, porque a alegria do Senhor os fortalecerá".
11 Levi pipol kon go round dey tok to di pipol make dem nor kry, bikos today na holy day.
11 Os levitas tranqüilizaram todo o povo, dizendo: "Acalmem-se porque este é um dia santo. Não fiquem tristes! "
12 So all di pipol go dia house dey happy, dey chop and drink and share wetin dem get with one anoda, bikos dem undastand wetin dem read give dem.
12 Então todo o povo saiu para comer, beber, repartir com os que nada tinham preparado e para comemorar com grande alegria, pois agora compreendiam as palavras que lhes foram explicadas.
13 Di next day, di head for each family, with di priests and Levi pipol go meet Ezra wey know di law well-well so dat e go really tish dem.
13 No segundo dia do mês, os chefes de todas as famílias, os sacerdotes e os levitas reuniram-se com o escriba Esdras para estudar as palavras da Lei.
14 Dem si sey, Moses rite for God Law sey, make Israel pipol stay for shelta wen ever dem dey do di feast for di sevent mont.
14 Descobriram que estava escrito na Lei, que o Senhor tinha ordenado por meio de Moisés, que os israelitas deviam morar em tendas durante a festa do sétimo mês.
15 So dem make and send dis kommand go round Jerusalem and di oda village and towns sey: “Make una go di hills go kut wood kom from olive, myrtle, palm and oda trees make wi take build where wi go stay celebrate di festival, just as dem rite am for di law.”
15 Por isso anunciaram em todas as suas cidades e em Jerusalém: "Saiam às montanhas e tragam ramos de oliveiras cultivadas, de oliveiras silvestres, de murtas, de tamareiras e de árvores frondosas, para fazerem tendas", conforme está escrito.
16 So di pipol go kut palm leaf take kover dia house, di temple kourtyard and di field wey dey near di Wota Gate and Efraim Gate.
16 Então o povo saiu e trouxe os ramos, e eles mesmos construíram tendas nos seus terraços, nos seus pátios, nos pátios do templo de Deus e na praça junto à porta das Águas e na que fica junto à porta de Efraim.
17 All di pipol wey kom back from Babilon build house kon dey stay der. Dis na di first time wen dem dey do am afta di time wey Nun pikin, Jeshua do am and evribody happy well-well.
17 Todos os que tinham voltado do exílio construíram tendas e moraram nelas. Desde os dias de Josué, filho de Num, até aquele dia, os israelitas não tinham celebrado a festa dessa maneira. E a alegria deles foi muito grande.
18 From di first day wey di festival start go rish di end, dem dey read one-one part from God law evriday. Dem celebrate for seven days kon finish di festival for di eight day, just as dem rite am for di law.
18 Dia após dia, desde o primeiro até o último dia da festa, Esdras leu o Livro da Lei de Deus. Eles celebraram a festa durante sete dias, e no oitavo dia, conforme o ritual, houve uma reunião solene.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Neemias 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.