Neemias 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Afta sometaim, many among Israel pipol, both men and wimen kon dey komplain about dia own brodas.
1 Foi, porém, grande o clamor do povo e de suas mulheres, contra os judeus, seus irmãos.
2 Some sey, “Wi get big family, so wi nid enough food wey wi go dey chop, so dat wi nor go die.”
2 Porque havia quem dizia: Nós, nossos filhos e nossas filhas, somos muitos; então tomemos trigo, para que comamos e vivamos.
3 Odas sey, “Wi don use awa farm, vineyard and house take-take loan, so dat wi go get enough food to chop, make honga nor kill us.”
3 Também havia quem dizia: As nossas terras, as nossas vinhas e as nossas casas empenhamos, para tomarmos trigo nesta fome.
4 Some odas still sey, “Wi borrow money take pay di royal tax for awa farm and vineyards.
4 Também havia quem dizia: Tomamos emprestado dinheiro até para o tributo do rei, sobre as nossas terras e as nossas vinhas.
5 Wi bi Jew pipol too, awa shidren bi like dia own shidren. But wi sell awa shidren as slave give dem. Dem don sell some among awa dotas as slave. Wi nor get pawa or who go help us, bikos dem don take awa farms and vineyards from us.”
5 Agora, pois, a nossa carne é como a carne de nossos irmãos, e nossos filhos como seus filhos; e eis que sujeitamos nossos filhos e nossas filhas para serem servos; e até algumas de nossas filhas são tão sujeitas, que já não estão no poder de nossas mãos; e outros têm as nossas terras e as nossas vinhas.
6 I vex well-well wen I hear dia kry and komplain.
6 Ouvindo eu, pois, o seu clamor, e estas palavras, muito me indignei.
7 Afta I tink about am well-well, I kon tok against di ofisas and doz wey get money. I tell dem, “Una dey opress and ponish una own brodas as una dey take intrest wen dem borrow money from una!” Bikos of dem, I kon koll evribody togeda make dem tok for di matter.
7 E considerei comigo mesmo no meu coração; depois pelejei com os nobres e com os magistrados, e disse-lhes: Sois usurários cada um para com seu irmão. E convoquei contra eles uma grande assembléia.
8 I kon sey, “Just as wi fit, wi don dey buy awa Jew brodas wey sell demsef give strenjas back. But naw, una by unasef won sell una own brodas! So how many times wey go buy dem back?” But di leaders kwayet and nor fit defend diasef.
8 E disse-lhes: Nós resgatamos os judeus, nossos irmãos, que foram vendidos às nações, segundo nossas posses; e vós outra vez venderíeis a vossos irmãos, ou vender-se-iam a nós? Então se calaram, e não acharam que responder.
9 Den I sey, “Wetin una dey do so nor good! Una nid to respet God and dey do wetin korrect. Den una nor go give awa enemies wey bi Gentile pipol, any shance to laf us.
9 Disse mais: Não é bom o que fazeis; porventura não andaríeis no temor do nosso Deus, por causa do opróbrio das nações, os nossos inimigos?
10 Even mi, my brodas and men dey borrow money and korn give di pipol, but naw, make wi stop dis intrest wey wi dey take from dem.
10 Também eu, meus irmãos e meus servos, a juros lhes temos emprestado dinheiro e trigo. Deixemos este ganho.
11 Make una kancel all di debt wey dem dey owe una; weda na money, korn, wine or olive oil kon give dem back dia vineyards, farms, olive farm and house!”
11 Restituí-lhes hoje, vos peço, as suas terras, as suas vinhas, os seus olivais e as suas casas; como também a centésima parte do dinheiro, do trigo, do mosto e do azeite, que vós exigis deles.
12 Di ofisas and doz wey get money kon ansa, “Wi go do as yu tok. Wi go give dem dia propaty and nor kollect wetin dem dey owe us.”
12 Então disseram: Restituir-lhes-emos, e nada procuraremos deles; faremos assim como dizes. Então chamei os sacerdotes, e os fiz jurar que fariam conforme a esta palavra.
13 I pul di garment wey I wear kon shake am. Den I sey, “Na so God go take shake any of una wey nor keep en promise. E go distroy una house and evritin wey una get and nor-tin go remain for una.”
13 Também sacudi as minhas vestes, e disse: Assim sacuda Deus todo o homem da sua casa e do seu trabalho que não confirmar esta palavra, e assim seja sacudido e vazio. E toda a congregação disse: Amém! E louvaram ao Senhor; e o povo fez conforme a esta palavra.
14 Na di twenteth year wey Atazazes bi king, e make mi govnor for Judah and since den kon rish naw wey bi di twelft year wey I dey rule Judah (di thirty-two years wey Atazazes don dey rule), mi and my family nor chop di food wey dem suppose dey give mi as govnor.
14 Também desde o dia em que me mandou que eu fosse seu governador na terra de Judá, desde o ano vinte, até ao ano trinta e dois do rei Artaxerxes, doze anos, nem eu nem meus irmãos comemos o pão do governador.
15 All di govnors wey don rule before mi, trobol di pipol and dey kollect forty silva koins evriday for food and wine. Even dia savants dey opress di pipol too. But I difren from dem, bikos I dey fear God.
15 Mas os primeiros governadores, que foram antes de mim, oprimiram o povo, e tomaram-lhe pão e vinho e, além disso, quarenta siclos de prata, como também os seus servos dominavam sobre o povo; porém eu assim não fiz, por causa do temor de Deus.
16 I use all my pawa and money take ribuild di wall and I nor buy any propaty for mysef. Evribody wey dey work for mi, join ribuild di town too.
16 Como também na obra deste muro fiz reparação, e terra nenhuma compramos; e todos os meus servos se ajuntaram ali à obra.
17 I dey always feed 150 Jew pipol and dia leaders for my house; apart from di strenjas wey dey kom meet mi from di tribes wey surround us.
17 Também dos judeus e dos magistrados, cento e cinqüenta homens, e os que vinham a nós dentre as nações que estão ao redor de nós, se punham à minha mesa.
18 I dey kill one melu, six big sheep and many fawol evriday and evry ten days, I dey provide fresh wine. I nor take di tins wey I suppose take from di pipol as dia govnor, bikos of di heavy work wey dem dey do.
18 E o que se preparava para cada dia era um boi e seis ovelhas escolhidas; também aves se me preparavam e, de dez em dez dias, muito vinho de todas as espécies; e nem por isso exigi o pão do governador, porquanto a servidão deste povo era grande.
19 So my Oga God, I abeg, make Yu remember evritin wey I don do for dis pipol, den make Yu bless mi.
19 Lembra-te de mim para bem, ó meu Deus, e de tudo quanto fiz a este povo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Neemias 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.