Neemias 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 Wen Sanballat hear sey, wi Jew pipol don start to dey build di wall, e kon dey vex and laf us.
1 E sucedeu que, ouvindo Sambalate que edificávamos o muro, ardeu em ira, e se indignou muito; e escarneceu dos judeus.
2 For en friends and Samaria pipol front, e kon sey, “Wetin dis yeye Jew pipol tink sey dem dey do? Dem one build di town again? Dem tink sey, na to offa sakrifice dem go take build di town finish one day? Dem go fit make stones from di ashes of di tins wey fire burn?”
2 E falou na presença de seus irmãos, e do exército de Samaria, e disse: Que fazem estes fracos judeus? Permitir-se-lhes-á isto? Sacrificarão? Acabá-lo-ão num só dia? Vivificarão dos montões do pó as pedras que foram queimadas?
3 Tobaya wey kom from Ammon stand near am kon sey, “Even fit fox waka on-top di wall wey dem build, na wons di wall go fall rish groun!”
3 E estava com ele Tobias, o amonita, e disse: Ainda que edifiquem, contudo, vindo uma raposa, derrubará facilmente o seu muro de pedra.
4 Den I pray, “My Oga God! Make Yu hear as dem dey laf us. Make dia laf and disgrace fall for dia own head. Make dem tif all di propaty wey dem get kon karry dem as prisonas go strenj land.
4 Ouve, ó nosso Deus, que somos tão desprezados, e torna o seu opróbrio sobre a sua cabeça, e dá-os por presa, na terra do cativeiro.
5 Make Yu nor forgive di bad-bad tins wey dem do and nor forget dia sins, bikos dem don curse us wey dey build.”
5 E não cubras a sua iniqüidade, e não se risque de diante de ti o seu pecado, pois que te irritaram na presença dos edificadores.
6 So, wi kon kontinue to dey build di wall and bikos di pipol dey ready to work, wi kon almost build am rish half of how e high rish before.
6 Porém edificamos o muro, e todo o muro se fechou até sua metade; porque o coração do povo se inclinava a trabalhar.
7 Sanballat, Tobaya with Arab, Ammon and Ashdod pipol kon dey vex well-well wen dem hear sey wi still dey ribuild Jerusalem wall and kover all di holes wey dey.
7 E sucedeu que, ouvindo Sambalate e Tobias, e os árabes, os amonitas, e os asdoditas, que tanto ia crescendo a reparação dos muros de Jerusalém, que já as roturas se começavam a tapar, iraram-se sobremodo,
8 So, dem plan to attack and kause wahala for Jerusalem.
8 E ligaram-se entre si todos, para virem guerrear contra Jerusalém, e para os desviarem do seu intento.
9 But wi pray give awa God kon put men wey go dey guide di place both day and nite.
9 Porém nós oramos ao nosso Deus e pusemos uma guarda contra eles, de dia e de noite, por causa deles.
10 Judah pipol get one song wey dem dey sing: “Doz wey dey work, dia pawa don fail! Di trobol too mush and bikos of dat, wi nor fit ribuild di wall.”
10 Então disse Judá: Já desfaleceram as forças dos carregadores, e o pó é muito, e nós não poderemos edificar o muro.
11 Awa enemies still sey, “Before dem go si or know wetin dey happen, wi don attack, kill and kause wahala for dem!”
11 Disseram, porém, os nossos inimigos: Nada saberão disto, nem verão, até que entremos no meio deles, e os matemos; assim faremos cessar a obra.
12 So from time to time, Jew pipol wey dey stay among awa enemies, dey kom tell us di plan wey di enemies dey plan.
12 E sucedeu que, vindo os judeus que habitavam entre eles, dez vezes nos disseram: De todos os lugares, tornarão contra nós.
13 So I give di pipol swod, bow and arrow kon put some pipol for back of di walls and some for open space.
13 Então pus guardas nos lugares baixos por detrás do muro e nos altos; e pus ao povo pelas suas famílias com as suas espadas, com as suas lanças, e com os seus arcos.
14 I si sey di pipol dey worry, so I kon tell dem, dia ofisas and dia leaders sey, “Make una nor fear awa enemies. Make una remember how great and mighty God bi, den make una fight for una brodas, shidren, wifes and una house.”
14 E olhei, e levantei-me, e disse aos nobres, aos magistrados, e ao restante do povo: Não os temais; lembrai-vos do grande e terrível Senhor, e pelejai pelos vossos irmãos, vossos filhos, vossas mulheres e vossas casas.
15 Awa enemies hear sey wi don know di plan wey dem dey plan against us and dem know sey God don make dia plan fail. Den all of us kon go start to build again.
15 E sucedeu que, ouvindo os nossos inimigos que já o sabíamos, e que Deus tinha dissipado o conselho deles, todos voltamos ao muro, cada um à sua obra.
16 From den go, half among my men dey work and half dey guide, dem wear war klot and hold spears, shields and bows. And di leaders really support di pipol
16 E sucedeu que, desde aquele dia, metade dos meus servos trabalhava na obra, e metade deles tinha as lanças, os escudos, os arcos e as couraças; e os líderes estavam por detrás de toda a casa de Judá.
17 wey dey ribuild di wall. Even doz wey dey karry di tins wey dem take dey work, dey karry am with one hand kon hold swod for di oda hand
17 Os que edificavam o muro, os que traziam as cargas e os que carregavam, cada um com uma das mãos fazia a obra e na outra tinha as armas.
18 and evribody wey dey build, hang swod for dia waist. Di man wey go blow di trumpet as signal stand near mi.
18 E os edificadores cada um trazia a sua espada cingida aos lombos, e edificavam; e o que tocava a trombeta estava junto comigo.
19 I tell di pipol and dia ofisas, “Where wi dey work big well-well naim make us dey far from each oda for di wall.
19 E disse eu aos nobres, aos magistrados e ao restante do povo: Grande e extensa é a obra, e nós estamos apartados do muro, longe uns dos outros.
20 So if una hear di trumpet nois, make una gada round mi and awa God go fight for us.”
20 No lugar onde ouvirdes o som da buzina, ali vos ajuntareis conosco; o nosso Deus pelejará por nós.
21 So half dey work from morning go rish nite evriday, while di oda half dey guide.
21 Assim trabalhávamos na obra; e metade deles tinha as lanças desde a subida da alva até ao sair das estrelas.
22 By dis time, I tell di leaders sey dem and di pipol wey dey help dem, must stay for Jerusalem for nite, so dat wi go fit guide di town for nite and work for day time.
22 Também naquele tempo disse ao povo: Cada um com o seu servo fique em Jerusalém, para que à noite nos sirvam de guarda, e de dia na obra.
23 For dis time, mi, doz wey dey follow mi, my savant and my bodyguards, nor dey shange klot at-all. And all of us keep awa swod, bow and arrow for where wi go kwik take am even fit na wota wi dey drink.
23 E nem eu, nem meus irmãos, nem meus servos, nem os homens da guarda que me seguiam largávamos as nossas vestes; cada um tinha suas armas e água.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Neemias 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.