Neemias 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Den for Nisan mont for di twenteth year wen King Atazazes dey rule. As e dey chop, I go gi-am wine and bikos e neva si my face like dat before,
1 No mês de nisã, no ano vigésimo do rei Artaxerxes, uma vez posto o vinho diante dele, eu o tomei para oferecer e lho dei; ora, eu nunca antes estivera triste diante dele.
2 e kon ask, “Why yor face bi like who dey sick even doh yu nor sick? Dis one mean sey yu nor dey happy!”
2 O rei me disse: Por que está triste o teu rosto, se não estás doente? Tem de ser tristeza do coração. Então, temi sobremaneira
3 so I tell di king, “My king, make yu live forever! Wetin nor go make my face look like who dey sick wen e bi sey dem skata and burn di gates for di town where dem beri my grand-grand papa put.”
3 e lhe respondi: viva o rei para sempre! Como não me estaria triste o rosto se a cidade, onde estão os sepulcros de meus pais, está assolada e tem as portas consumidas pelo fogo?
4 Den di king ask, “Na wetin yu wont naw?”
4 Disse-me o rei: Que me pedes agora? Então, orei ao Deus dos céus
5 den I ansa, “If my king dey happy with mi and go gri do wetin I wont, den make yu allow mi go Judah town, where dem beri my grand-grand papa dem put, so dat I go fit ribuild am.”
5 e disse ao rei: se é do agrado do rei, e se o teu servo acha mercê em tua presença, peço-te que me envies a Judá, à cidade dos sepulcros de meus pais, para que eu a reedifique.
6 Di king and en wife wey sidan near am kon agri. Den e ask mi how many days I go stay, before I go kom back. So I kon tell am.
6 Então, o rei, estando a rainha assentada junto dele, me disse: Quanto durará a tua ausência? Quando voltarás? Aprouve ao rei enviar-me, e marquei certo prazo.
7 I still beg am make e give mi letas, make I give di govnors for West Eufrates aria, so dat dem go allow mi travel well pass dia aria until I rish Judah.
7 E ainda disse ao rei: Se ao rei parece bem, deem-se-me cartas para os governadores dalém do Eufrates, para que me permitam passar e entrar em Judá,
8 I still ask di king make e give mi leta wey I go give Asaf wey dey guide di royal forest, so dat e go give mi big-big woods make I take build di guide gate for di temple, di town wall and di house wey I go stay. So di king give mi all wetin I wont, bikos God dey with mi.
8 como também carta para Asafe, guarda das matas do rei, para que me dê madeira para as vigas das portas da cidadela do templo, para os muros da cidade e para a casa em que deverei alojar-me. E o rei mas deu, porque a boa mão do meu Deus era comigo.
9 As I dey go West Eufrates, di king send some soja oga and horse-men follow mi. For der, I kon give di king letas to di govnors.
9 Então, fui aos governadores dalém do Eufrates e lhes entreguei as cartas do rei; ora, o rei tinha enviado comigo oficiais do exército e cavaleiros.
10 But wen Sanballat, wey kom from Bet-Horon town and Tobaya, one offisa for Ammon aria, hear sey somebody don kom help Israel pipol, dem kon dey vex well-well.
10 Disto ficaram sabendo Sambalate, o horonita, e Tobias, o servo amonita; e muito lhes desagradou que alguém viesse a procurar o bem dos filhos de Israel.
11 I kon go Jerusalem and for three days,
11 Cheguei a Jerusalém, onde estive três dias.
12 I nor tell anybody wetin God put for my mind make I kom do for Jerusalem. Den for mid-nite, I wake-up kon take some among my men follow body with only one donkey wey I ride.
12 Então, à noite me levantei, e uns poucos homens, comigo; não declarei a ninguém o que o meu Deus me pusera no coração para eu fazer em Jerusalém. Não havia comigo animal algum, senão o que eu montava.
13 Day neva break well wen I leave di town kon pass thru di Valley Gate for west go di sout-side, den I pass Dragon Well go di Dirty Gate. As I dey go, I dey look all di wall wey don break for di town and di gates wey fire distroy.
13 De noite, saí pela Porta do Vale, para o lado da Fonte do Dragão e para a Porta do Monturo e contemplei os muros de Jerusalém, que estavam assolados, cujas portas tinham sido consumidas pelo fogo.
14 For di east side for di town, I pass nort go di Well Gate and di King Pool. Di donkey wey I dey ride nor si enough space to pass,
14 Passei à Porta da Fonte e ao açude do rei; mas não havia lugar por onde passasse o animal que eu montava.
15 so I kom down go Kidron Valley as I still dey look di wall dem. Den I pass di Valley Gate, go back to di town.
15 Subi à noite pelo ribeiro e contemplei ainda os muros; voltei, entrei pela Porta do Vale e tornei para casa.
16 Di ofisas nor know where I from dey kom or wetin I go do, bikos I nor tok anytin to my fellow Jew pipol, di priests, di leaders, di ofisas or any oda pesin wey go join do di work.
16 Não sabiam os magistrados aonde eu fora nem o que fazia, pois até aqui não havia eu declarado coisa alguma, nem aos judeus, nem aos sacerdotes, nem aos nobres, nem aos magistrados, nem aos mais que faziam a obra.
17 Den I leta tell dem, “Make una si di kind trobol wey wi dey face, bikos Jerusalem don skata and en gates don distroy! Make wi ribuild di town wall, so dat shame go komot from awa eye.”
17 Então, lhes disse: Estais vendo a miséria em que estamos, Jerusalém assolada, e as suas portas, queimadas; vinde, pois, reedifiquemos os muros de Jerusalém e deixemos de ser opróbrio.
18 I tell dem how God help and dey with mi. I still tell dem evritin wey di king tell mi.
18 E lhes declarei como a boa mão do meu Deus estivera comigo e também as palavras que o rei me falara. Então, disseram: Disponhamo-nos e edifiquemos. E fortaleceram as mãos para a boa obra.
19 Wen Sanballat, Tobaya and one Arab man wey en name bi Geshem, hear wetin wi dey plan to do, dem kon dey laf us sey, “Wetin una tink sey una dey do so? Una won fight against di king?”
19 Porém Sambalate, o horonita, e Tobias, o servo amonita, e Gesém, o arábio, quando o souberam, zombaram de nós, e nos desprezaram, e disseram: Que é isso que fazeis? Quereis rebelar-vos contra o rei?
20 I ansa dem, “God wey dey heaven go give us viktory. Wi bi en savants and wi go start to build. But una nor get rite, share or anytin to klaim for Jerusalem.”
20 Então, lhes respondi: o Deus dos céus é quem nos dará bom êxito; nós, seus servos, nos disporemos e reedificaremos; vós, todavia, não tendes parte, nem direito, nem memorial em Jerusalém.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Neemias 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.