Neemias 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Wen dem dey read Moses law give di pipol, dem kon rish di place wey sey make dem nor allow any Ammon or Moab pesin join God pipol.
1 Naquele dia, se leu para o povo no Livro de Moisés; achou-se escrito que os amonitas e os moabitas não entrassem jamais na congregação de Deus,
2 And dis na bikos Ammon and Moab pipol nor gri give Israel pipol food or wota drink wen dem dey komot from Egypt. Instead, dem give Balaam money make e curse Israel, but awa God turn di curse to blessing.
2 porquanto não tinham saído ao encontro dos filhos de Israel com pão e água; antes, assalariaram contra eles Balaão para os amaldiçoar; mas o nosso Deus converteu a maldição em bênção.
3 Wen Israel pipol hear dat part for di law, dem nor kon add all di strenjas for di town join.
3 Ouvindo eles, o povo, esta lei, apartaram de Israel todo elemento misto.
4 Before dis time, Priest Eliashib wey bi Tobaya broda, dey kare for di temple store room.
4 Ora, antes disto, Eliasibe, sacerdote, encarregado da câmara da casa do nosso Deus, se tinha aparentado com Tobias;
5 E build one big room where dem bin dey keep korn ofrins and incense, di tins wey dem dey use for di temple, di ofrin wey bi priests own and one from evry ten tins wey pipol bring from dia korn, wine and olive oil wey dem give Levi pipol and doz wey dey guide and sing for di temple.
5 e fizera para este uma câmara grande, onde dantes se depositavam as ofertas de manjares, o incenso, os utensílios e os dízimos dos cereais, do vinho e do azeite, que se ordenaram para os levitas, cantores e porteiros, como também contribuições para os sacerdotes.
6 I nor dey Jerusalem wen dis tins dey happen, so for di thirty-two years wen Atazazes bi king for Babilon, I kon go ripot gi-am. Afta sometaim, e permit mi
6 Mas, quando isso aconteceu, não estive em Jerusalém, porque no trigésimo segundo ano de Artaxerxes, rei da Babilônia, eu fora ter com ele; mas ao cabo de certo tempo pedi licença ao rei e voltei para Jerusalém.
7 and I kon go back to Jerusalem. I shok wen I si sey Eliashib allow Tobaya dey use one room for di temple.
7 Então, soube do mal que Eliasibe fizera para beneficiar a Tobias, fazendo-lhe uma câmara nos pátios da Casa de Deus.
8 I vex well-well kon trowey Tobaya tins for outside.
8 Isso muito me indignou a tal ponto, que atirei todos os móveis da casa de Tobias fora da câmara.
9 I kon orda sey make dem do sakrifice take santify di room and make dem put di temple tins, korn ofrins and incense back for der.
9 Então, ordenei que se purificassem as câmaras e tornei a trazer para ali os utensílios da Casa de Deus, com as ofertas de manjares e o incenso.
10 I still hear sey, doz wey dey sing for di temple and some among Levi pipol don leave Jerusalem kon go back to dia farms, bikos di pipol nor dey give dem food.
10 Também soube que os quinhões dos levitas não se lhes davam, de maneira que os levitas e os cantores, que faziam o serviço, tinham fugido cada um para o seu campo.
11 So I kworel with di leaders kon ask dem, “Wetin make una forget God Temple?” Den I go bring Levi pipol and doz wey dey sing kom back to di temple, so dat dem go start dia work again.
11 Então, contendi com os magistrados e disse: Por que se desamparou a Casa de Deus? Ajuntei os levitas e os cantores e os restituí a seus postos.
12 Den Israel pipol kon start to dey bring one out of evry ten korn, wine and olive oil kom di temple store room again.
12 Então, todo o Judá trouxe os dízimos dos cereais, do vinho e do azeite aos depósitos.
13 So I kon put dis men make dem dey guide di store room and dem bi, Shelemaya wey bi priest; Zadok wey know di law well-well and Pedaaya wey kom from Levi family. Hanan wey Matanaya pikin Zakkur born, na-im dey help dem. I know sey I go fit trust dis men wen dem dey share di tins give di pipol wey dey follow dem work.
13 Por tesoureiros dos depósitos pus Selemias, o sacerdote, Zadoque, o escrivão, e, dentre os levitas, Pedaías; como assistente deles, Hanã, filho de Zacur, filho de Matanias; porque foram achados fiéis, e se lhes encarregou que repartissem as porções para seus irmãos.
14 My God, make Yu remember all dis tins wey I don do for yor temple and for yor work.
14 Por isto, Deus meu, lembra-te de mim e não apagues as beneficências que eu fiz à casa de meu Deus e para o seu serviço.
15 For dat time, I si pipol for Judah dey make juice from grapes for Sabat Day. While some dey load korn, wine, grapes, figs and oda tins on-top dia donkey kon take dem go Jerusalem. So I warn dem sey make dem nor sell anytin for Sabat Day.
15 Naqueles dias, vi em Judá os que pisavam lagares ao sábado e traziam trigo que carregavam sobre jumentos; como também vinho, uvas e figos e toda sorte de cargas, que traziam a Jerusalém no dia de sábado; e protestei contra eles por venderem mantimentos neste dia.
16 Some men wey kom from Tyre town dey stay for Jerusalem and dem bring difren tins kom di town kon sell for awa pipol for Sabat Day.
16 Também habitavam em Jerusalém tírios que traziam peixes e toda sorte de mercadorias, que no sábado vendiam aos filhos de Judá e em Jerusalém.
17 I kworel with di Jew leaders kon tell dem, “Si di kind bad tin wey una dey do! Una nor wont make di Sabat Day dey holy.
17 Contendi com os nobres de Judá e lhes disse: Que mal é este que fazeis, profanando o dia de sábado?
18 Na dis tin make God ponish una grand-grand papa dem kon distroy di town. Yet una still dey won make God vex well-well for Israel, bikos una nor dey make di Sabat Day holy.”
18 Acaso, não fizeram vossos pais assim, e não trouxe o nosso Deus todo este mal sobre nós e sobre esta cidade? E vós ainda trazeis ira maior sobre Israel, profanando o sábado.
19 So I kon give orda sey make dem dey lock di town gate for morning go rish evening for evry Sabat Day and make dem nor open am until dat day finish. I put some among my men for di gate, make dem make sure sey dem nor karry anytin enter or go outside di town for Sabat Day.
19 Dando já sombra as portas de Jerusalém antes do sábado, ordenei que se fechassem; e determinei que não se abrissem, senão após o sábado; às portas coloquei alguns dos meus moços, para que nenhuma carga entrasse no dia de sábado.
20 One or two time, pipol wey dey sell difren tins dey sleep outside di town.
20 Então, os negociantes e os vendedores de toda sorte de mercadorias pernoitaram fora de Jerusalém, uma ou duas vezes.
21 So I warn dem, “No nid to dey wait for outside till morning. If una try am again, I go ponish una.” From dat time go, dem nor kon dey kom der for Sabat Day.
21 Protestei, pois, contra eles e lhes disse: Por que passais a noite defronte do muro? Se outra vez o fizerdes, lançarei mão sobre vós. Daí em diante não tornaram a vir no sábado.
22 I give orda sey make Levi pipol go santify demsef, den kon guide di gate to make sure sey dem keep di Sabat Day holy.
22 Também mandei aos levitas que se purificassem e viessem guardar as portas, para santificar o dia de sábado. Também nisto, Deus meu, lembra-te de mim; e perdoa-me segundo a abundância da tua misericórdia.
23 For dat time, I notis sey many among Jew men marry wimen from Ashdod, Ammon and Moab town.
23 Vi também, naqueles dias, que judeus haviam casado com mulheres asdoditas, amonitas e moabitas.
24 Half of dia shidren dey speak Ashdod language (or some oda language), but dem nor fit speak Hibru language.
24 Seus filhos falavam meio asdodita e não sabiam falar judaico, mas a língua de seu respectivo povo.
25 I kworel, curse, slap and pul di men hair. Den I make dem swear with God name sey dem and dia shidren nor go ever marry from anoda kountry.
25 Contendi com eles, e os amaldiçoei, e espanquei alguns deles, e lhes arranquei os cabelos, e os conjurei por Deus, dizendo: Não dareis mais vossas filhas a seus filhos e não tomareis mais suas filhas, nem para vossos filhos nem para vós mesmos.
26 I still tell dem, “Na wimen from anoda kountry make King Solomon sin. Dis man great pass any of di king for oda nashons. God love am kon make am king ova Israel pipol, yet e still kommit sin.
26 Não pecou nisto Salomão, rei de Israel? Todavia, entre muitas nações não havia rei semelhante a ele, e ele era amado do seu Deus, e Deus o constituiu rei sobre todo o Israel. Não obstante isso, as mulheres estrangeiras o fizeram cair no pecado.
27 So e good make wi dey hear all dis una wiked tins and how una disobey awa God and marry wimen from oda kountries?”
27 Dar-vos-íamos nós ouvidos, para fazermos todo este grande mal, prevaricando contra o nosso Deus, casando com mulheres estrangeiras?
28 Naw, Eliashib wey bi di priest born Joiada, but one for Joiada pikin marry Sanballat dota, wey kom from Bet-Horon town, so I sey make Joiada komot from Jerusalem.
28 Um dos filhos de Joiada, filho do sumo sacerdote Eliasibe, era genro de Sambalate, o horonita, pelo que o afugentei de mim.
29 My God, make Yu remember dem, bikos dem don spoil di priests work and break di priest and Levi pipol kovenant.
29 Lembra-te deles, Deus meu, pois contaminaram o sacerdócio, como também a aliança sacerdotal e levítica.
30 So I santify di pipol from evry strenj tin kon tell di priests and Levi pipol wetin dem go do.
30 Limpei-os, pois, de toda estrangeirice e designei o serviço dos sacerdotes e dos levitas, cada um no seu mister,
31 I still provide di wood wey dem go use take burn di ofrin for di rite time and for di first korn and fruit.
31 como também o fornecimento de lenha em tempos determinados, bem como as primícias. Lembra-te de mim, Deus meu, para o meu bem.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Neemias 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.