Mateus 9
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Jesus enter boat kon cross go en home-town for di oda side.
1 Jesus entrou num barco, voltou para o lado oeste do lago e chegou à sua cidade .
2 Some pipol kon bring one man wey nor fit waka kom meet am. Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey nor fit waka, “My pikin, make yu nor fear! God don forgive yu all yor sins.”
2 Então algumas pessoas trouxeram um paralítico deitado numa cama. Jesus viu que eles tinham fé e disse ao paralítico:
3 Den some law tishas kon dey tok to demsef sey, “Si as dis man dey shalenge God.”
3 Aí alguns mestres da Lei começaram a pensar: — Este homem está
4 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?
4 Porém Jesus sabia o que eles estavam pensando e disse:
5 Wish one eazy pass to tok, ‘I forgive yu yor sins’ or ‘Stand up make yu waka?’
5 O que é mais fácil dizer ao paralítico: “Os seus pecados estão perdoados” ou “Levante-se e ande”?
6 But make una know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive pipol dia sins.” So e kon tell di man wey nor fit waka, “Stand up, karry yor bed, make yu dey go yor house.”
6 Pois vou mostrar a vocês que eu, o Então disse ao paralítico:
7 Den di man stand up kon waka go en house.
7 O homem se levantou e foi para casa.
8 Wen di pipol si wetin happen, fear katch dem well-well and dem kon bigin praiz God wey give dis kind pawa to human being.
8 Quando o povo viu isso, ficou com medo e louvou a Deus por dar esse poder a seres humanos.
9 As Jesus komot from der, e si one man wey na name bi Matiu, wey sidan for where dem for dey pay tax. Jesus kon tell am, “Follow mi.” At wons, di man kon get up follow am.
9 Jesus saiu dali e, no caminho, viu um cobrador de impostos, chamado Mateus, sentado no lugar onde os impostos eram pagos. Jesus lhe disse: Mateus se levantou e foi com ele.
10 As Jesus dey chop for Matiu house, many tax kollectors and sinnas follow en and en disciples dey chop too.
10 Mais tarde, enquanto Jesus estava jantando na casa de Mateus, muitos cobradores de impostos e outras pessoas de má fama chegaram e sentaram-se à mesa com Jesus e os seus discípulos.
11 Wen di Farisee si wetin dey happen, dem kon bigin ask di disciples, “Wetin make una tisha dey follow tax kollectors and sinnas dey chop?”
11 Alguns fariseus viram isso e perguntaram aos discípulos: — Por que é que o mestre de vocês come com os cobradores de impostos e com outras pessoas de má fama?
12 Wen Jesus hear wetin dem dey tok, e kon ansa dem, “Pesin wey well nor nid doctor to cure am, but na who nor well, nid am.
12 Jesus ouviu a pergunta e respondeu:
13 Make una go learn wetin dis word mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice, bikos na sinnas I kom save, nor bi good pipol.’ ”
13 Vão e procurem entender o que quer dizer este trecho das
14 John disciples kom meet Jesus kon ask am, “Why e bi sey wi and di Farisee pipol dey fast evritime and yor disciples nor dey fast?”
14 Então os discípulos de João Batista chegaram perto de Jesus e perguntaram: — Por que é que nós e os
15 Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.
15 Jesus respondeu:
16 “Nobody dey take new klot pash di whole wey dey for old klot, bikos where dem pash for di old klot go tear more and di whole wey go dey der, go big pass di one wey dey before.
16 — Ninguém usa um retalho de pano novo para remendar uma roupa velha; pois o remendo novo encolhe e rasga a roupa velha, aumentando o buraco.
17 Nobody go pour new wine inside old wine bag, bikos di bag go burst and di wine go pour trowey, den di wine bag go tear. Na dis make dem dey put new wine inside new wine bag, so dat di wine nor go trowey and di wine bag nor go tear.”
17 Ninguém põe vinho novo em
18 As Jesus dey tok dis tins, one oga kom knee down for en front sey, “My dota just die, make yu kom tosh am and e go wake-up.”
18 Enquanto Jesus estava falando ao povo, um chefe religioso chegou perto dele, ajoelhou-se e disse: — A minha filha morreu agora mesmo! Venha e ponha as mãos sobre ela para que viva de novo.
19 So Jesus and en disciples kon follow am.
19 Então Jesus foi com ele, e os seus discípulos também foram.
20 One woman wey blood dey rush komot for en body for twelf years kon kom Jesus back, den e tosh en klot korna.
20 Certa mulher, que fazia doze anos que estava com uma hemorragia, veio por trás de Jesus e tocou na barra da capa dele.
21 Bikos di woman don tink am for en mind sey, “If I go fit tosh en klot korna, I go well.”
21 Pois ela pensava assim: “Se eu apenas tocar na capa dele, ficarei curada.”
22 Wen Jesus turn round si di woman, e kon tell am, “My pikin, make yu nor worry! Yor faith don make yu well.” From dat time, di woman kon well.
22 Jesus virou, viu a mulher e disse: E naquele momento a mulher ficou curada.
23 Wen Jesus enter di oga house, e si pipol dey play music and plenty pipol dey make nois for der too.
23 Depois Jesus foi para a casa do chefe religioso. Quando viu os que tocavam música fúnebre e viu a multidão numa confusão geral,
24 E kon tell dem, “Make evribody komot, di girl neva die, e just dey sleep.” Den, dem kon bigin laf am.
24 disse: Então começaram a caçoar dele.
25 Afta di pipol don go outside, Jesus go whole di girl for hand and di girl kon stand up!
25 Logo que a multidão saiu, Jesus entrou no quarto em que a menina estava, pegou-a pela mão, e ela se levantou.
26 Pipol kon bigin tok about wetin happen for evriwhere.
26 E a notícia a respeito disso se espalhou por toda aquela região.
27 As Jesus komot for der, two blind men kon follow am dey shaut, “David pikin, make yu sorry for us!”
27 Jesus saiu daquele lugar, e no caminho dois cegos começaram a segui-lo, gritando: —
28 Wen Jesus don enter di house, di two blind men kom meet am. Den e ask dem, “Una bilive sey I fit make una si?”
28 Assim que Jesus entrou em casa, os cegos chegaram perto dele. Então ele perguntou: — Sim, senhor! Nós cremos! — responderam eles.
29 Den Jesus tosh dia eyes kon sey, “Make e happen to una as una faith strong rish.”
29 Jesus tocou nos olhos deles e disse:
30 At wons, dia eyes kon open and dem kon bigin si. Jesus kon warn dem sey, “Make una nor tell anybody wetin happen so.”
30 E os olhos deles ficaram curados. Aí Jesus ordenou com severidade:
31 But dem kon go evriwhere, bigin tok about di tin wey Jesus do for dem.
31 Porém eles foram embora e espalharam as notícias a respeito de Jesus por toda aquela região.
32 As dem komot, some pipol bring one man wey get demon and e nor fit tok, kom meet Jesus.
32 Quando eles foram embora, algumas pessoas levaram a Jesus um homem que não podia falar porque estava dominado por um demônio.
33 Wen Jesus don drive di demon komot, di man kon bigin tok. Di pipol wey gada for di place sopraiz well-well and dem kon sey, “Nobody don si dis kind tin for Israel before.”
33 Logo que o demônio foi expulso, o homem começou a falar. Todos ficaram admirados e afirmavam: — Nunca vimos em Israel uma coisa assim!
34 But di Farisee pipol sey, “Na devil pawa Jesus dey use take drive demon komot from pipol body.”
34 Mas os fariseus diziam: — O chefe dos demônios é quem dá a esse homem poder para expulsar demônios.
35 Jesus waka go all di town and village, dey prish di Good News about God Kingdom for dia sinagog and dey heal difren diziz and pipol wey nor well.
35 Jesus andava visitando todas as cidades e povoados. Ele ensinava nas sinagogas , anunciava a boa notícia sobre o Reino e curava todo tipo de enfermidades e doenças graves das pessoas.
36 Wen e si how pipol plenty rish, e kon sorry for dem, bikos nobody dey to help dem and dem kon dey waka anyhow like sheep wey nor get who dey look dem.
36 Quando Jesus viu a multidão, ficou com muita pena daquela gente porque eles estavam aflitos e abandonados, como ovelhas sem pastor.
37 Den e tell en disciples, “Wetin pipol go harvest plenty well-well, but di pipol wey go do di work nor plenty rish.”
37 Então disse aos discípulos:
38 So, make una pray make di Oga God wey get di farm, send pipol wey go work for en farm, kom.
38 Peçam ao dono da plantação que mande mais trabalhadores para fazerem a colheita.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.