Mateus 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Afta Jesus kom down from di mountin, plenty pipol kon follow am.
1 E, descendo ele do monte, seguiu-o uma grande multidão.
2 One leper kon meet am, knee down for en front, kon sey, “Oga God, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my body go well.”
2 E eis que veio um leproso e o adorou, dizendo: Senhor, se quiseres, podes tornar-me limpo.
3 Jesus tosh di man kon sey, “Yes, I wont make yu well!” At wons, di sickness komot from di man body.
3 E Jesus, estendendo a mão, tocou-o, dizendo: Quero; sê limpo. E logo ficou purificado da lepra.
4 Den, Jesus tell am, “Nor tell anybody, but go meet di priest, make e look yu. Afta, go give di ofrin wey Moses kommand to show sey yu don well.”
4 Disse-lhe, então, Jesus: Olha, não o digas a alguém, mas vai, mostra-te ao sacerdote e apresenta a oferta que Moisés determinou, para lhes servir de testemunho.
5 Wen Jesus enter Kapanaum, one Roman offisa kon meet am dey beg make e help am.
5 E, entrando Jesus em Cafarnaum, chegou junto dele um centurião, rogando-lhe
6 Di offisa sey, “Oga God, my savant nor well for house, e nor fit get up and body dey pain am well-well.”
6 e dizendo: Senhor, o meu criado jaz em casa paralítico e violentamente atormentado.
7 Jesus kon ansa, “I go kom heal am.”
7 E Jesus lhe disse: Eu irei e lhe darei saúde.
8 But di offisa sey, “Oga God, I nor big rish who yu go enter en house, instead just tok and my savant go well.
8 E o centurião, respondendo, disse: Senhor, não sou digno de que entres debaixo do meu telhado, mas dize somente uma palavra, e o meu criado sarará,
9 Misef, I bi man wey get oga and I still get sojas wey dey under mi. If I kommand one sey make e ‘Go’, e go-go, if I kommand anoda one sey make e ‘Kom’, e go kom and if I kommand my savant make e ‘Do dis tin’, e go do am.”
9 pois também eu sou homem sob autoridade e tenho soldados às minhas ordens; e digo a este: vai, e ele vai; e a outro: vem, e ele vem; e ao meu criado: faze isto, e ele o faz.
10 Wen Jesus hear wetin e tok, e sopraiz, den e tell di pipol wey dey follow am, “I tell una true word, I neva si anybody wey get dis kind faith for Israel!
10 E maravilhou-se Jesus, ouvindo isso, e disse aos que o seguiam: Em verdade vos digo que nem mesmo em Israel encontrei tanta fé.
11 Many pipol from east and west go kom follow Abraham, Isaak and Jakob chop inside God Kingdom.
11 Mas eu vos digo que muitos virão do Oriente e do Ocidente e assentar-se-ão à mesa com Abraão, e Isaque, e Jacó, no Reino dos céus;
12 But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”
12 E os filhos do Reino serão lançados nas trevas exteriores; ali, haverá pranto e ranger de dentes.
13 Den Jesus tell di offisa, “Go, since yu bilive, na so e go bi for yu.” Na dat same time di savant well.
13 Então, disse Jesus ao centurião: Vai, e como creste te seja feito. E, naquela mesma hora, o seu criado sarou.
14 Wen Jesus enter Pita house, e kon si sey Pita wife mama nor well.
14 E Jesus, entrando na casa de Pedro, viu a sogra deste jazendo com febre.
15 Den e tosh di woman and di fever komot from en body. So, di woman get up kon bigin serve dem.
15 E tocou-lhe na mão, e a febre a deixou; e levantou-se e serviu-os.
16 Wen evening rish, dem karry many pipol wey demon dey inside dem kom meet Jesus. E drive di wiked spirits komot kon heal all di pipol wey nor well.
16 E, chegada a tarde, trouxeram-lhe muitos endemoninhados, e ele, com a sua palavra, expulsou deles os espíritos e curou todos os que estavam enfermos,
17 Dis one make wetin Profet Isaya tok bi true,
17 para que se cumprisse o que fora dito pelo profeta Isaías, que diz: Ele tomou sobre si as nossas enfermidades e levou as nossas doenças.
18 Wen Jesus si plenty pipol gada am, e kon kommand en disciples make dem cross go di oda side for di river.
18 E Jesus, vendo em torno de si uma grande multidão, ordenou que passassem para a outra margem.
19 One law tish kon tell Jesus, “Tisha, I go follow yu go anywhere wey yu dey go.”
19 E, aproximando-se dele um escriba, disse: Mestre, aonde quer que fores, eu te seguirei.
20 Jesus ansa am, “Rabbit and bird get dia own house, but Man Pikin nor get where e go fit rest en head.”
20 E disse Jesus: As raposas têm covis, e as aves do céu
21 Anoda disciple kon sey, “Oga God, make I first go beri my papa.”
21 E outro de seus discípulos lhe disse: Senhor, permite-me que, primeiramente, vá sepultar meu pai.
22 Jesus ansa am, “Follow mi, make doz wey don die beri dia dead body.”
22 Jesus, porém, disse-lhe: Segue-me e deixa aos mortos sepultar os seus mortos.
23 As Jesus enter di boat, en disciples kon follow am.
23 E, entrando ele no barco, seus discípulos o seguiram.
24 At wons, strong breeze kon dey blow for di sea and wave won sink di boat. But Jesus Christ dey sleep.
24 E eis que, no mar, se levantou uma tempestade tão grande, que o barco era coberto pelas ondas; ele, porém, estava dormindo.
25 So en disciples wake am kon sey, “Oga God, save us! Na die wi dey so o-o!”
25 E os seus discípulos, aproximando-se, o despertaram, dizendo: Senhor, salva-nos, que perecemos.
26 Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.
26 E ele disse-lhes: Por que temeis, Então, levantando-se, repreendeu os ventos e o mar, e seguiu-se uma grande bonança.
27 Di men sopraiz well-well kon dey ask each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wave dey obey am!”
27 E aqueles homens se maravilharam, dizendo: Que homem é este, que até os ventos e o mar lhe obedecem?
28 Wen Jesus rish di oda side where Gadarenes pipol dey stay, two men wey get demon, run from di beri groun kom meet am. Nobody dey fit pass dat road, bikos di men wiked well-well.
28 E, tendo chegado à outra margem, à província dos gadarenos, saíram-lhe ao encontro dois endemoninhados, vindos dos sepulcros; tão ferozes eram, que ninguém podia passar por aquele caminho.
29 Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”
29 E eis que clamaram, dizendo: Que temos nós contigo, Jesus, Filho de Deus? Vieste aqui atormentar-nos antes do tempo?
30 For where dem dey, plenty pig dey chop near der.
30 E andava pastando distante deles uma manada de muitos porcos.
31 Den di demons beg Jesus, “If yu drive us komot, make yu send us go enter inside di pigs.”
31 E os demônios rogaram-lhe, dizendo: Se nos expulsas, permite-nos que entremos naquela manada de porcos.
32 So Jesus tell dem, “Make una go!” At wons, dem kon komot enter inside di pigs and all di pigs rush go enter di river kon die.
32 E ele lhes disse: Ide. E, saindo eles, se introduziram na manada dos porcos; e eis que toda aquela manada de porcos se precipitou no mar por um despenhadeiro, e morreram nas águas.
33 Di pipol wey dey look di pigs, run go di town kon tell pipol evritin wey happen to di men wey get demons.
33 Os porqueiros fugiram e, chegando à cidade, divulgaram tudo o que acontecera aos endemoninhados.
34 Den evribody for di town kon dey find Jesus. Wen dem si am, dem kon beg am make e komot from dia aria.
34 E eis que toda aquela cidade saiu ao encontro de Jesus, e, vendo-o, rogaram-lhe que se retirasse do seu território.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.