Mateus 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 “Make una nor dey judge pipol anyhow, so dat God nor go judge una.
1 “Não julguem para não serem julgados,
2 Bikos as una dey judge, na so God go take judge una. And as una dey do to oda pipol, na so dem go do una too.
2 pois vocês serão julgados pelo modo como julgam os outros. O padrão de medida que adotarem será usado para medi-los.
3 “Why yu dey si di small dirty wey dey yor broda eye, but yu nor dey si di big wood wey dey for yor own?
3 “Por que você se preocupa com o cisco no olho de seu amigo enquanto há um tronco em seu próprio olho?
4 How yu won take tell yor broda sey, ‘Make I remove di dirty wey dey yor eye, wen big wood dey yor own?’
4 Como pode dizer a seu amigo: ‘Deixe-me ajudá-lo a tirar o cisco de seu olho’, se não consegue ver o tronco em seu próprio olho?
5 Yu wey dey pritend, first remove di big wood wey dey yor eye, den yu go fit si di small dirty for yor broda own.
5 Hipócrita! Primeiro, livre-se do tronco em seu olho; então você verá o suficiente para tirar o cisco do olho de seu amigo.
6 “Make una nor give dog tins wey dey holy or trow yor gold give pig, bikos dem go mash am with dia leg, turn face yu, den kon tear yu to pieces.
6 “Não deem o que é santo aos cães, nem joguem pérolas aos porcos; pois os porcos pisotearão as pérolas, e os cães se voltarão contra vocês e os atacarão.”
7 “Wen yu ask for sometin, God go gi-am to yu; wen yu look for sometin, yu go si am and wen yu nok, di door go open for yu.
7 “Peçam, e receberão. Procurem, e encontrarão. Batam, e a porta lhes será aberta.
8 Anybody wey ask for sometin, go get am; anybody wey dey find sometin, go si wetin e dey find and pesin wey nok door, dem go open for am.
8 Pois todos que pedem, recebem. Todos que procuram, encontram. E, para todos que batem, a porta é aberta.
9 “E get any of una wey en pikin ask am for bread and e gi-am stone?
9 “Respondam: Se seu filho lhe pedir pão, você lhe dará uma pedra?
10 Or if di pikin ask for fish, yu go gi-am snake?
10 Ou, se pedir um peixe, você lhe dará uma cobra?
11 If yu wey bad fit give yor pikin good tin, yu tink sey God wey dey heaven nor go give betta tin to pipol wey ask am?
11 Portanto, se vocês, que são maus, sabem dar bons presentes a seus filhos, quanto mais seu Pai, que está no céu, dará bons presentes aos que lhe pedirem!”
12 Bikos of dis, make yu trit pipol as yu wont make dem trit yu, bikos na so dem rite am for di Profets and Moses Law.
12 “Em todas as coisas façam aos outros o que vocês desejam que eles lhes façam. Essa é a essência de tudo que ensinam a lei e os profetas.”
13 “Make yu pass di small gate enter, bikos di gate wey pipol go pass go sofa, wide well-well and many pipol dey waka enter.
13 “Entrem pela porta estreita. A estrada que conduz à destruição é ampla, e larga é sua porta, e muitos escolhem esse caminho.
14 But di gate wey pipol dey pass enter life, small well-well and e hard to enter and na only few pipol go fit si am.”
14 Mas a porta para a vida é estreita, e o caminho é difícil, e são poucos os que o encontram.”
15 “Make yu shine yor eye, bikos lie-lie profets go kom like sheep, but for inside dia heart, dem bi wiked animal wey dey kill.
15 “Tomem cuidado com falsos profetas que vêm disfarçados de ovelhas, mas que, na verdade, são lobos esfomeados.
16 Yu go know dem with wetin dem dey do. Pipol nor dey gada grape or fig from shuku-shuku.
16 Vocês os identificarão por seus frutos. É possível colher uvas de espinheiros ou figos de ervas daninhas?
17 So too, evry good tree go bear good fruit, but bad tree, go bear bad fruit.
17 Da mesma forma, a árvore boa produz frutos bons, e a árvore ruim produz frutos ruins.
18 Good tree nor go fit bear bad fruit and bad tree nor go fit bear good fruit.
18 A árvore boa não pode produzir frutos ruins, e a árvore ruim não pode produzir frutos bons.
19 Any tree wey nor bear good fruit, dem go kut am down kon trow am inside fire.
19 Toda árvore que não produz bons frutos é cortada e lançada ao fogo.
20 So, yu go know di lie-lie profets with wetin dem dey do.”
20 Portanto, é possível identificar a pessoa por seus frutos.”
21 “Nor bi evribody wey dey koll God, ‘Oga God, Oga God’, go enter God Kingdom, but na only di pipol wey dey do wetin my Papa for heaven wont.
21 “Nem todos que me chamam: ‘Senhor! Senhor!’ entrarão no reino dos céus, mas apenas aqueles que, de fato, fazem a vontade de meu Pai, que está no céu.
22 For dat day wey God go judge evribody, many pipol go sey, ‘Oga God, wi use yor name prish God message, drive many demon komot from pipol body and do many mirakle.’
22 No dia do juízo, muitos me dirão: ‘Senhor! Senhor! Não profetizamos em teu nome, não expulsamos demônios em teu nome e não realizamos muitos milagres em teu nome?’.
23 Dat time, I go sey, ‘I nor know yu. Make yu komot from where I dey, yu wey wiked well-well.’ ”
23 Eu, porém, responderei: ‘Nunca os conheci. Afastem-se de mim, vocês que desobedecem à lei!’.”
24 “Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.
24 “Quem ouve minhas palavras e as pratica é tão sábio como a pessoa que constrói sua casa sobre uma rocha firme.
25 Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, e nor go fall, bikos dem build am on-top rock.
25 Quando vierem as chuvas e as inundações, e os ventos castigarem a casa, ela não cairá, pois foi construída sobre rocha firme.
26 But pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like foolish man wey build en house on-top san.
26 Mas quem ouve meu ensino e não o pratica é tão tolo como a pessoa que constrói sua casa sobre a areia.
27 Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, na wons e go fall skata for groun.”
27 Quando vierem as chuvas e as inundações e os ventos castigarem a casa, ela cairá com grande estrondo.”
28 Afta Jesus don tok all dis tins, di pipol sopraiz for di wey e dey tish,
28 Quando Jesus acabou de dizer essas coisas, a multidão ficou maravilhada com seu ensino,
29 bikos e tish dem like pesin wey get authority and nor bi as dia law tishas dey do.
29 pois ele ensinava com verdadeira autoridade, diferentemente dos mestres da lei.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.