Mateus 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 “Make una nor dey do good bikos una wont make pipol si una; if una do so, God nor go pay una for di good wey una do.
1 — Evitem praticar as suas obras de justiça diante dos outros para serem vistos por eles; porque, sendo assim, vocês já não terão nenhuma recompensa junto do Pai de vocês, que está nos céus.
2 “Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
2 — Quando, pois, você der esmola, não fique tocando trombeta nas sinagogas e nas ruas, como fazem os hipócritas, para serem elogiados pelos outros. Em verdade lhes digo que eles já receberam a sua recompensa.
3 But wen una dey give, make una nor let una left hand know wetin una rite hand give.
3 Mas, ao dar esmola, que a sua mão esquerda ignore o que a mão direita está fazendo,
4 So dat una gift, go dey sekret and una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”
4 para que a sua esmola fique em secreto. E o seu Pai, que vê em secreto, lhe dará a recompensa.
5 “Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
5 — E, quando orarem, não sejam como os hipócritas, que gostam de orar em pé nas sinagogas e nos cantos das praças, para serem vistos pelos outros. Em verdade lhes digo que eles já receberam a sua recompensa.
6 But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present.
6 Mas, ao orar, entre no seu quarto e, fechada a porta, ore ao seu Pai, que está em secreto. E o seu Pai, que vê em secreto, lhe dará a recompensa.
7 Wen una dey pray, make una nor tok one word many times as pipol wey dey serve juju dey do, bikos dem tink sey dia juju go hear dem wen dia tok plenty.
7 E, orando, não usem vãs repetições, como os gentios; porque eles pensam que por muito falar serão ouvidos.
8 Make una nor bi like dem. Una Papa know wetin una nid before una bigin ask am.
8 Não sejam, portanto, como eles; porque o Pai de vocês sabe o que vocês precisam, antes mesmo de lhe pedirem.
9 “So make una pray like dis:
9 — Portanto, orem assim:
10 make yor Kingdom kom,
10 venha o teu Reino;
11 Give us di food wey wi go chop evriday,
11 o pão nosso de cada dia
12 forgive us all di bad-bad tins wey wi don do,
12 e perdoa-nos as nossas dívidas,
13 Nor allow us enter temptashon,
13 e não nos deixes
14 If una forgive oda pipol di bad tins wey dem do una, una Papa wey dey for heaven go forgive una too.
14 — Porque, se perdoarem aos outros as ofensas deles, também o Pai de vocês, que está no céu, perdoará vocês;
15 But if una nor forgive odas, una Papa sef nor go forgive una.”
15 se, porém, não perdoarem aos outros as ofensas deles, também o Pai de vocês não perdoará as ofensas de vocês.
16 “Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.
16 — Quando vocês jejuarem, não fiquem com uma aparência triste, como os hipócritas; porque desfiguram o rosto a fim de parecer aos outros que estão jejuando. Em verdade lhes digo que eles já receberam a sua recompensa.
17 But wen una dey fast, make una wosh and rub pomade for una face,
17 Mas você, quando jejuar, unja a cabeça e lave o rosto,
18 so dat odas nor go know sey una dey fast, but only una Papa wey dey for sekret go know. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”
18 a fim de não parecer aos outros que você está jejuando, e sim ao seu Pai, em secreto. E o seu Pai, que vê em secreto, lhe dará a recompensa.
19 “Make una nor just gada propaty for dis world, bikos siti-siti go chop dem or dem go rust or tif fit enter inside di house tif dem.
19 — Não acumulem tesouros sobre a terra, onde as traças e a ferrugem corroem e onde ladrões escavam e roubam;
20 But make una gada betta tins for unasef for heaven, where siti-siti nor go for fit chop dem and dem nor go rust and tif nor go fit enter tif dem,
20 mas ajuntem tesouros no céu, onde as traças e a ferrugem não corroem, e onde ladrões não escavam, nem roubam.
21 bikos, where una propaty dey, na der una heart go dey too.
21 Porque, onde estiver o seu tesouro, aí estará também o seu coração.
22 “Na eye bi di lite for pesin body. If pesin eye dey okay, lite go full en body.
22 — Os olhos são a lâmpada do corpo. Se os seus olhos forem bons, todo o seu corpo será cheio de luz;
23 But if pesin eye blind, den darkness go full en body. If di lite wey dey inside una na darkness, di darkness big well-well!
23 se, porém, os seus olhos forem maus, todo o seu corpo estará em trevas. Portanto, se a luz que existe em você são trevas, que grandes trevas serão!
24 “Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
24 — Ninguém pode servir a dois senhores; porque ou irá odiar um e amar o outro, ou irá se dedicar a um e desprezar o outro. Vocês não podem servir a Deus e às riquezas.
25 “So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot?
25 — Por isso, digo a vocês: não se preocupem com a sua vida, quanto ao que irão comer ou beber; nem com o corpo, quanto ao que irão vestir. Não é a vida mais do que o alimento, e não é o corpo mais do que as roupas?
26 Make una look di birds wey dey fly for sky, dem nor dey plant or put anytin wey dem gada inside store, but una Papa for heaven dey feed dem. Una nor betta pass dem?
26 Observem as aves do céu, que não semeiam, não colhem, nem ajuntam em celeiros. No entanto, o Pai de vocês, que está no céu, as sustenta. Será que vocês não valem muito mais do que as aves?
27 Who among una wey dey worry go fit add one hour join en life?
27 Quem de vocês, por mais que se preocupe, pode acrescentar um côvado ao curso da sua vida?
28 “Why una dey worry about klot wey una go wear? Make una tink how flower dey grow for field; dem nor dey work or make klot wey dem dey wear.
28 — E por que se preocupam com o que vão vestir? Observem como crescem os lírios do campo: eles não trabalham, nem fiam.
29 I tell una true word, even Solomon, upon all di money wey e get, e nor wear klot wey fine rish di ones wey dis flower dem dey wear!
29 Eu, porém, afirmo a vocês que nem Salomão, em toda a sua glória, se vestiu como qualquer deles.
30 If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o.
30 Ora, se Deus veste assim a erva do campo, que hoje existe e amanhã é lançada no forno, não fará muito mais por vocês, homens de pequena fé?
31 So make una nor worry kon dey sey, ‘Wetin wi go chop, drink or wear?’
31 Portanto, não se preocupem, dizendo: “Que comeremos?”, “Que beberemos?” ou “Com que nos vestiremos?”
32 Na dis kind tins pipol wey nor know God dey porshu and una Papa for heaven know sey una nid dem.
32 Porque os gentios é que procuram todas estas coisas. O Pai de vocês, que está no céu, sabe que vocês precisam de todas elas.
33 But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own.
33 Mas busquem em primeiro lugar o Reino de Deus e a sua justiça, e todas estas coisas lhes serão acrescentadas.
34 So make una nor worry about tumoro, bikos tumoro get en own wahala. Today trobol don do.”
34 — Portanto, não se preocupem com o dia de amanhã, pois o amanhã trará os seus cuidados; basta ao dia o seu próprio mal.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.