Mateus 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 For dat time, John di Baptist dey prish inside wildaness for Judea sey,
1 E, naqueles dias, apareceu João o Batista pregando no deserto da Judéia,
2 “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don near.”
2 E dizendo: Arrependei-vos, porque é chegado o reino dos céus.
3 Na dis John Profet Isaya tok about sey,
3 Porque este é o anunciado pelo profeta Isaías, que disse:Voz do que clama no deserto:Preparai o caminho do Senhor,Endireitai as suas veredas.
4 John wear klot wey dem use kamel hair make, e use leda belt tie waist and na lokust and honey for bush, e dey chop.
4 E este João tinha as suas vestes de pelos de camelo, e um cinto de couro em torno de seus lombos; e alimentava-se de gafanhotos e de mel silvestre.
5 Pipol from Jerusalem, Judea and all di town wey dey near Jordan River dey run go meet am
5 Então ia ter com ele Jerusalém, e toda a Judéia, e toda a província adjacente ao Jordão;
6 and e kon baptize dem inside Jordan River, afta dem konfess dia sins.
6 E eram por ele batizados no rio Jordão, confessando os seus pecados.
7 But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?
7 E, vendo ele muitos dos fariseus e dos saduceus, que vinham ao seu batismo, dizia-lhes: Raça de víboras, quem vos ensinou a fugir da ira futura?
8 Naw, make una do wetin go show sey una don turn from sin kom meet God,
8 Produzi, pois, frutos dignos de arrependimento;
9 make una nor tink sey una don free bikos una sey, ‘Abraham na awa papa.’ Make I tell una, God fit turn all dis stone to Abraham shidren!
9 E não presumais, de vós mesmos, dizendo: Temos por pai a Abraão; porque eu vos digo que, mesmo destas pedras, Deus pode suscitar filhos a Abraão.
10 Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire.
10 E também agora está posto o machado à raiz das árvores; toda a árvore, pois, que não produz bom fruto, é cortada e lançada no fogo.
11 “I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
11 E eu, em verdade, vos batizo com água, para o arrependimento; mas aquele que vem após mim é mais poderoso do que eu; cujas alparcas não sou digno de levar; ele vos batizará com o Espírito Santo, e com fogo.
12 Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”
12 Em sua mão tem a pá, e limpará a sua eira, e recolherá no celeiro o seu trigo, e queimará a palha com fogo que nunca se apagará.
13 Jesus kom from Galilee make John for baptize am for Jordan River.
13 Então veio Jesus da Galiléia ter com João, junto do Jordão, para ser batizado por ele.
14 But John won kon stop am sey, “Na yu suppose baptize mi, instead yu kom meet mi make I baptize yu?”
14 Mas João opunha-se-lhe, dizendo: Eu careço de ser batizado por ti, e vens tu a mim?
15 Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
15 Jesus, porém, respondendo, disse-lhe: Deixa por agora, porque assim nos convém cumprir toda a justiça. Então ele o permitiu.
16 As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head.
16 E, sendo Jesus batizado, saiu logo da água, e eis que se lhe abriram os céus, e viu o Espírito de Deus descendo como pomba e vindo sobre ele.
17 Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”
17 E eis que uma voz dos céus dizia: Este é o meu Filho amado, em quem me comprazo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.